English,Pidgin "Ah, we thank God.",Ah we thank God. Hope that they preach well?,Hope sey de dey preach well? "Yes, they preach well.",Ehn de dey preach well. Do you have any program?,Una get any programme? As in any upcoming program?,As in any upcoming programme? Uh... we have one on the third... the third uh... Friday of the month.,"Hm we get eh third, di third eh Friday, third Friday of di month." Eh.,Eh. We are having a night vigil.,We dey get night vigil. "Okay, a night vigil?",Okay night vigil? Uhuh!,Ehn! Hope the vigil is exciting.,"Hope sey di night vigil dey hot well, well." "Ah, my sister, it is no joke.","Ah my sister, no be small tin!" "If you come, you will see.","If you come, you come see." I'll try.,I go try hm. I will try to come.,I go try come. Come then!,Come now! "Me too, I'll invite you to mine.","Me too, I go invite you for my own o!" No problem!,No problem! We have a women's program.,We get women programme. "If you come, you'll enjoy it a lot.","If you come, you go enjoy am well, well." No problem!,No problem! Definitely!,Confirm! I'll come.,I go come. "They'll teach you lots of things. How to take care of your home. How to cook for your family. In fact, how to manage your home.","De will teach you many tins, how to take care of your home, how to cook for your family, in fact, how to manage your home." Eyah!,Eyah! "And they will still teach you some things like, how to prepare some things in your house.","In fact, and de will still teach you some kind tins like how to prepare some kind tins for your house." Okay!,Eyah! I'll come!,I go come o! You'll enjoy it a lot.,"You go enjoy am well, well." Okay!,Eyah! I do like that type of program.,I dey like dat kind programme. "Ah, you'll enjoy it.",Ah you go enjoy am. I will come.,I go come. I will come.,I go come. Let's pray for God to keep us until that day.,"Moh we, meh we pray meh God keep us till dat day." "Amen, my sister.",Amen o my sister! That's it.,Na so o! Thank you!,Thank you! God will help us.,God go help us. "Well, brother, as a Warri boy, the thing is that this country (the way I see it), this country does not hav-... it doesn't have a good future just, just because of the way things are, anyways.","Well, bros, as a Warri boy now, di ting be sey di country (di way I dey see am), di country no ge-... e no get any better future for front because di way ting just dey, ting just dey anyhow." "Because normally, they do... they do promise us this will happen, that it will happen, but all of us have been waiting, nothing is happening.","Because normally, de dey, de dey promise us sey dis one go happen, dis one go happen, but all of us don dey wait, noting dey happen." Take my family for example: I remember last time when they said that they wanted to pay uh... old pensioners something.,I fit use my own family as example be sey I remember last time wey de bin call sey de want pay ehn old pensioner someting. Almost...,Almost... This was almost four or five years ago.,"Dis one na almost four, to five years now." We've been waiting.,We don dey wait. Nothing is happening.,Noting dey happen. "And most of the things about the coun-... the economy, they say things will get better, things will get better, but the thing is... everything is just going from bad to worse, like a grease fire.","And most of di ting wey di coun-... di economy dey talk sef, de say tings go better, tings go better, but di ting, everyting just dey go from bad to worst, from fry pan to fire." "But anyhow, any which way we... all of us... the thing is, Nigerians, we are hardworkers.","But any which way sha, we, all of us, di ting be sey Nigerians, na hard workers we be." "For instance, recently, in my area, they just did some demolition, and some people were impacted.","Like recently now, for my area, de just do demolition, and some people just suffer." "They didn't even warn anybody saying ""we are coming, move your things.""","De no even warn anybody sey we dey come, moh una pack una tings." "They just came and pulled everything down, different houses, including people's shops, their cars.","De just con carry everyting down, different houses, even people shop, deir motor." The man who was driving the bulldozer just buried everything.,Di man wey dey drive di demolition motor just carry everyting put underground. Some people even died just yesterday.,Some people sef even die yesterday sef. "So the thing is, we Nigerians who own this country, they are treating us like we're foreigners in our own land where my mother gave birth to me, and my... my... it's here that my father comes from.","So di ting be sey we, Nigerians wey get dis country, de dey treat us like sey we be foreigner for our own country where my mama born me, and my, my, na here my papa comot from." It's like I'm a foreigner.,E go be like sey na foreigner I be. "It's like I... I smuggled myself into the country, but actually, it's my country, it's me, it's my...","E be like sey na, I, I smuggle mysef enter di country, but meanwhile, na me get country, na me be my..." I'm a citizen.,I be citizen. "The government should seriously stop all these promises of theirs, they should try to work out something for us uh... the origi-... or, or, uh... ordinary Nigerians so that we can get our hands on basic things.","So serious one be sey make government stop all dese deir promises, meh dem try work out someting for us, di origi-... or, or, ehn ordinary Nigerians so dat make small tings tay dey reach our hands." "Because if a guy does a bad thing, they will say he's a thief, but if a guy hustles, they will bring us back to square one.","Because if person do bad ting now, de go say person don thief, but if person hustle, de go dey bring us go back to square one." "So, at least, the government should try to do something somehow.","So at least, make government try do someting any which way." "But for me anyway, what I... I would not like the government to do... the government should try a little... they should create a few opportunities for people.","Ehn for me sha, wetin me, I go not like government make do sey make government try small, make dem create small, small opportunities for people." "At least, even if it is...","At least, even if na..." Because the time when...,Because di time wey... "I heard the time Buhari said he wanted to get into government, he said he will be giving every graduate five... five thousand, or some amount of money that they would use to start a business.","I hear sey di time wey Buhari say e wan enter government, im talk sey im go dey give every graduate five, five k, or some amount of money wey go take start business." "So, that kind of thing would make sense to help the country move forward a little.",So dat kind ting go make sense so dat di country go move forward small. "Because as they say, an idle man is the devil's workshop.",Because everybody dey say idle man is a devil's workshop. "A person who stays in one place, he will be thinking of how to steal, or how to kidnap a person, and that's what we don't want.","Person wey sit down one place now, e go dey tink of how to take thief, or how to take kidnap person, and na wetin wesef no want." "So the government should try to take, put some money into the economy so people can put food on the table.","So make government try take, put some revenue inside make person take see food chop." "Because sometimes, even some families, die of hunger.","Because sometime, some family sef, na hungry dey kill dem." "And they say they want the country to be fine, to be better, but the government is not doing anything.","And de say de wan make di country fine meh better, but, di government no dey do anyting." "Instead, all you hear is this one stole this, that one...","Instead, you go dey hear sey dis one thief, dis one..." "This one says he wants to return this one, that one did that.","Dis one say e wan return dis one, dis one do dis one." "But we are the ones who... we are the ones who suffer more, the ones at the bottom.","But na we wey dey, na we dey suffer am pass, we wey dey underground." So the government should make an effort.,So make government try. That's why we voted them in.,Dat'S why we vote dem in. They are supposed to protect us.,De suppose dey protect us. They should try to cover us.,Make dem try cover us up. They should arrange little... some little things for us.,"Make dem put small, some small tings for us." "Even if it's just giving us a little money, to start a business, or do something.","Even if na to give us small money, moh take start business, or do someting." It will make more sense than having people do things by themselves.,E for make sense dan dis one wey people go dey do tings by demsef. "In the end, they will still come and take it from the ground.","At di end, de go still con come comot am from ground." "Well, the problem I faced when I was little was when uh... my mother was fired the time I was in school.",Ehn di incident wey I be face when I small na when ehn de bin sack my mama from work di time wey I dey school. "Because my mother worked hard, made a little money, sent me abroad to go learn a little something.",Because my mama bin hustle small money send me abroad now go learn small ting. "So, that was how...",So naim dey con... My mother then told me that they had dropped them from the worklist.,My moder con call me sey de don drop dem from work o. "That they were looking for younger people, they were in need of new people.","Sey de dey find fresh blood, de dey wan new people." "So, then they sacked the old ones without giving them anything.",So de con sack di old one witout giving dem anyting. They just dropped them like that.,De just drop dem like dat. That there was no more money in it.,Sey money never come dis one. That was even before Goodluck got into power.,Dat was even before Goodluck enter power o. "Right up to now, we are still waiting.","Even till now sef, we still dey wait." They are saying they will be calling.,De dey say de go dey call. "Every, every time they call, they say they want to collect names.","Every, everytime de call, de talk sey de wan collect names." "So-, even some of her colleagues, some have even died.","So-... sotay some of her colleagues sef, some don even die." Others don't even know...,Some no even know... We don't even know where some of the others are.,We no even know where some dey. "So, the thing is, many of us Nigerians have suffered to bring this country to where it is.","So di ting be sey many of us, Nigerians don suffer to make dis country go where e go." "The thing is that none of us is, is, is ev..., none of us is...","Wetin be sey none of us dey, dey, dey ev-... none of us dey..." The government is just looking.,Government dey look. "Uh... now in some countries like London for instance, they pay senior citizens.","Ah for some countries now (like London now), de dey pay old citizens." "People who have been in the country a long time, they give them a small allowance because they know they can't work like before.","People wey don stay di country well, well, de dey give dem small allowances because de know sey de no fit too hustle like dat." "So if the government can, even if it is not an allowance, they should pay people what they owe them.","So if government go fit, even if no be allowances, make dem pay people wetin de owe dem." "Like their fees, and money they are supposed to give them.","Like deir fees, and money wey de suppose to give dem." "Pensions, that will do.","Pension money, dat ting go do." "It will go a long way because most people, that is what they depend on.","E go go long way because most people, na wetin de dey depend on." "So, that's what I'm just begging the government to try to do.",So na just wetin I just dey beg government meh dem try do be dat. "The government should try to come up with a little something because we, we are suffering a lot.","Make government try hustle out small ting because we sef, we dey suffer well, well." We are the ones who suffer more.,Na we dey face am pass. "If anything gets more expensive (fuel, or whatever else), it's the poor who suffer, because the rich have more money.","If anyting increase (di fuel increase, or oders increase), na di poor man dey suffer am because rich man get money pass us." "Because in Nigeria, it's like the poor are becoming poorer, and the rich, they are getting richer.","Because for Nigeria, e be like sey na di poor ones dey get poor pass, and di rich ones, na im e con get money pass." Because it's like everything is getting worse.,Because e be like sey everyting just dey go from bad to worst. "So, the government should make an effort.",So make government don try. "Because I am not the only one, many of my mates too.","Because no be only me, many of my mate too sef." "Yesterday, for instance, one of my friends who stays in the same area as me, a bulldozer came to get rid of the shop where his mother sells food.","Like yesterday, one of my friend wey we dey stay for di same area, bulldozer come con scatter di shop wey im mama take dey sell food." And that's how they get by.,And na from dere de dey chop. "It just scattered the food, including the cooler and the fridge too.","Just scatter di food, even scatter plus cooler, and di fridge join." "And after, they will say ""we are one Nigeria.""","And after, de go say we are one Nigeria." "So, that kind of thing makes no sense anymore.",So dat kind ting no make sense now. "Even if they want to move a person from where he is, they will first warn him to leave.","Even if de wan comot person from where e dey, de go first warn am first meh e comot." Not that they will just come and do anything because they have power.,No be sey de will just come con dey do anyhow because de get power. "Because now in Nigeria, it's like the poor don't have any rights.","Because now for Nigeria, e be like sey poor people no get right." And it doesn't make sense because all of us are one Nigeria.,And e no make sense because all of us na one Nigeria. "So, they should have made a little effort just to settle people.",So de for don try small ting just tay arrange person. "But don't make... don't make poor people... don't make people turn to crime now, and start to do what makes no sense.","But meh, meh poor people, meh people no con turn to di side of crime now, con dey do wetin e no make sense now." "So, that is just what I am begging of the government: let them be useful.",So na wetin I just dey beg di government meh dem don dey useful. They should not just sit there talking about the twenty thirteen budget when it's twenty seventeen.,Make dem not just sit down dere dey talk about twenty thirteen budget when we dey twenty seventeen. They should move forward little by little.,"Make de dey take di future small, small." They should not take it too far.,Make dem no dey take am too far. "Please, because we are the ones who suffer the most.",Because na we dey suffer am pass abeg. "Alright, I got the New Telegraph this morning, and I'll read out some of the stories uh... which are different.","Alright I carry di New Telegraph dis morning, and some of di stories wey dey dere, ehn wey dey different, I go read am out." "Ah, did you hear that TELCOS is losing a lot of money?",Ah you dey hear sey TELCOS dey lose big money. They said they are...,De said de dey... "The loss or the, the, the loss they have suffered has hit one hundred, and fifty six point six bilion naira.","Di lose, abi di, di, di loss wey de don suffer, e don hit one hundred, and fifty six point six billion naira." "You know you have to stumble on some of the money (be-... be-... be-... billion...), because we don’t know if it's a gazillion.",You know you have to stumble on some of di money (be-... be-... be-... billion) because we no know wheder na gazillion. "In our lifetime, we'll talk about gazillions.","In our lifetime, we go talk about gazillion." Hehe.,Hehe. "Alright, you'll see this ex-soldier.",Alright o you go see dis ex-soldier. What's he saying?,Wetin e dey say? "He is a confirmed kidnapper, he said, ""I only kidnap valuable ladies"", says the ex-soldier.","He is a confirmed kidnapper, he say I kidnap only valuable ladies says ex-soldier." This is one of those times you won't want anyone to describe you as valuable.,Dis one na one of di days wey you no go wan mey de describe you as valuable. "Beacause if it's about your value, they should take away Luchin this morning.","Because if na your value na im de dey take kidnap you, de should take away Luchi dis morning." "Luchi is looking valuable, hehe.",Luchi is looking valuable hehe. "Alright, that one is in uh... page thirty four of the New Telegraph this morning.",Alright o dat one dey inside eh page thirty four of di New Telegraph dis morning. "Wike has sued the IGP, the EFCC, and the DSS over the way they are... they're planning his residence invasion.","Wike don sue IGP, EFCC, DSS on top di way de dey, de dey plan im residence invasion." "That means that the, the way they entered, you know, Ho-... Hollywood style.",Dat be sey di way dey take enter you know Ho-... Hollywood style. It'll be like... it's like spies coming into your house when you don’t know what's going on.,"E go be like dey, e, e be like sey na spies enter your house when e no know how far." They said the guy will sue them for that operation.,De said di guy go sue dem for dat waka wey dem waka. It's in page six of the New Telegram.,E dey inside page six of di New Telegraph. The Court stops the House of Representatives from prosecuting Anyim.,Court stops rep from prosecuting Anyim. Why do they want to prosecute him?,Why do de want to prosecute him? The man has taken the case to the High Court.,Di man don run to di Moder Court. What has the the High Court done?,Moder Court don do wetin? Protected him and said no!,Use im wrapper cover im head say no! I'm warning you... don't try it... don’t try it.,"Ehe eh don't try it, don't try it!" That's it.,Na im be di tin wey dey dere. "Alright, that story is on page thirty five, because Luchi is about to advocate for the people.",Alright dat one dey inside page thirty five ehn because Luchi is about to advocate for di people. "Hehe, yes, we've all heard.",Hehe ehn we all don already hear. "They asked, ""how long will our President stay away?""",De talk sey how long our Presido go stay? All those things are there in the paper.,All dose tins dey dere. Tears of joy as eighty two Chibok girls return.,Tears of Joy as eighty two Chibok girls return. "Oh, great!",Oh very lovely! Government to parents: keep hope alive!,Government to parents keep hope alive! "Yes, it was said that one hundred and thirteen others... they said they will be released.","Ehn de say one hundred and thirteen odas, sey de go return." That means that only one hundred and thirteen girls are still in their custody.,Dat means only one hundred and thirteen remain for deir hand. "Yes, that one, we, we, we, we...","Ehn dat one, we, we, we, we..." They are... they are... they are very...,"De are, de are, de are very, very..." I'm very happy.,I'm very happy. "The Red Cross says, ""we are a neutral intermediary.""",Red Cross dey talk sey we are neutral intermediary. That means that they themselves were involved in the negotiations.,"Dat mean sey demsef, de follow do di negotiation." "On a neutral level, according to them.",De say on a neutral level. All of that's in uh... the New Telegraph.,"All dat one, e dey inside ehm di New Telegraph." "Well, anyway, they said Adeyinka Adebayo will be buried on May twentieth.","Ehn anyway, de say Adeyinka Adebayo for burial May twenty." That was announced by his family.,Ehn na im family na im talk dat one. "Stop the Police from searching my house, Wike has told the court.",Stop police from searching my house Wike don tell court! "Maybe... what are you hiding, sir, that you don't want them to see?","Maybe, what are you hiding Sir dat you don't want dem to see?" Ehen!,Ehen! Falomo School.,Falomo School. Lagos may charge pupils with attempted rape.,Lagos may charge pupils with attempted rape. "I really, really, really want to commend the woman who did d-... this.","I really, really, really want to commend big time dis woman wey do d-... dis." "Did you know that when you see secondary school students when they are done writing their last paper, they will start acting like hooligans, tearing each other's clothes.","Do you know dat now, when you see secondary school children, when de finish deir last paper, de will now become like hooligans tearing deir cloth." "They said they were almost... they were almost raping girls, cutting their skirts with scissors.","De said de were almost, de were almost raping girls using scissors to tear deir skirt." "Then they'll hold them down, outside, in broad daylight.",De would now hold dem down in broad daylight in outside opendential. "This woman had to come out of her car, with her, her escorts.","Dis woman had to come out of her car with her, her escort." "That was how they were able to save more than a hundred girls, all of them from different pockets of...","Dat was how de were able to save more dan a hundred girls all of dem, different, different pockets of..." "You know they would've vowed to deal with them, saying, ""I'll show you, I'll show you.""","You know dem go don mean, dem say I go show you, I go show you." Today we... it might look like fun and games but it's not.,"Today we might be play, but dis is not play." "When their clothes were being torn, they were mounting on them, trying to rape them.","When deir clothing are being torn, de were climbing on dem, attempting to rape dem." I'm telling you!,I dey tell you! "Pi-... kids who had finished taking the... the WAEC exams, or finished their school term!","Pi-... children wey don comot for, for WAEC, or de don finish deir school term!" "It was such a di-... a disheartening story to read, if you're a mother.",It was such a di-... a disheartening ehn story to read if you be mama of pikin. I'm so happy that the Lagos State Government has taken this thing up.,I'm so happy dat Lagos State government don take dis tin up. Because we shouldn't let things like this slide.,Because we shouldn't let all dese tins slide. "At least, all other secondary schools, they have been used as scapegoats.","At least, all oda secondary school, de use dem as scapegoat." They won't try it.,De no go try am. "As I went there last year, la-, last year, as I came back, everybody was just...","As I go dere last year, la-... last year as I come back, everybody just dey..." "I mean, they were just listening to what, what you wanted...","As in de just dey listen wetin, wetin you wan..." "As they were just listening, they were just looking at my mouth to know what I would say, whether I... my boss and I have had problems.","As de just dey listen, de just dey look my mouth to know wetin I go talk wheder I, me, and my oga don get problem." "God, I beg you, just try and help me.","God, a beg, just try help me." I'm tired of this life.,Dis life don tire me. "I, I'm, I'm the first born, uhuh.","Na, na me, na me be first born ehen." "God, please!",God abeg. I'm begging you!,A beg! "God, I'm begging you, do something!","God, a beg, try!" I'm begging you!,A beg! "God, I'm begging you!","God, a beg!" I'm begging you!,A beg! It's what... it's what I need.,"Na wetin, na wetin I need." Just do something!,Just try! Oh!,Oh! "At the moment, even this uh...","For now, even dis eh..." And my brother said I should pray in Port Harcourt.,And my broder say make I do prayer for Port Harcourt. "In Port Harcourt, I didn't... I didn't have the money for the fare; I didn't have the money for the fare.","Inside Port Harcourt, I no, I no get transport money, I no get transport money." The fare was...,Transport money na... "That... the first day that, that I went, it was... I paid... I paid how much from Onitsha?","Dat di first day wey, wey I go na, I pay, I pay how much from Onitsha?" One thousand five.,One five. He said he would collect two thousand five.,E fit say im go collect two five. I didn't have the money.,I no get money now. Money... he would say I should go to OPM.,Money e go say make I go OPM. And that the church is trying their best too.,And dat church dey try too. "So, the church is helping too, is helping very many people.","So church dey help too, dey help many, many people o." The church is helping very many people.,"Church dey help many, many, many people." "God, please!","God, a beg!" "This life, oh!",Dis life oh! "And at the moment uh... I mean mstchew it's all these things, making me learn this work.",And now ah as in mtschew na all dis ting make me I con dey learn dis work. What will I do?,Wetin I go do? "Even if it's, even if it's food, I should just be eating from this side.","Even if na, even if na food, make I just dey eat from dis side." "As I came back, how many months is it now?","As I come back, na how many months now?" "Nine months, I'm in the house, there is nothing.","Nine months, I dey house, noting dey." Huh?,Ehn? "God, please just do something for me now.","God, abeg just try for me now." "Now, I mean I need... I need your help.","Now as in I need, I need your help." "Even if it's because of my forefathers, oh God, forgive us.","Even if na because of my forefaders, oh God forgive us." "Just forgive us, please, I beg you.",Just forgive us abeg abeg. "It's not, not, not, n-... not, my family is not that sinful.","No be, no, no, n-... no, no be my family sin pass." I know a lot of people who did rituals a long time ago.,I know many people wey do ritual since. "Our own, not so much.","Our own, no plenty." "Or is it just because... that maybe, I don’t know if our fore-... it's our forefathers, who sold people, or are selling, or are burying people alive.","Or na just because sey maybe, I no know wheder our fore-... na our forefader sell people, or dey sell, or de bury people alive." That's what's tormenting us.,Na im dey torment us. "We don’t know if anyb-, any, any person who did...","We no know if anyb-... any, any person wey do..." "If you did something wrong, have it follow you.","If you do wrong, meh di wrong follow you." Don't have it follow your children.,Meh e no follow your children. "God please, the, the thing has, has made me tired.","God abeg di, di ting don, don tire me." "All these ones, I mean all the... all, all the young people, no one is progressing.","All di ones as in all di, all, all di youth, no one dey progress." All of the greedy ones are progressing,All di greedy one dey progress. Moinmoin wants these.,Moinmoin wan dese. "All, all X.","All, all X." God will deliver me.,God go deliver me. Nobody is making progress.,No one dey progress. Everybody is just... is looking to their brother.,Everybody just dey dey look im broda. Who will speak up?,Na who go talk? Who will help?,Who go help? God it's our... we put our trust in you.,"God na our, na our trust dey, dey in you." "But really, wow, my mother is a good woman.",But sha kai my moder na good woman. "That woman, I will never forget her in my life, even if she dies today, or tomorrow.","Dat woman, I no go ever forget her in my life even if she die today, or tomorrow." "But I am praying to God, ""God, give her a long life.""",But I dey pray to God God give her long life! That woman's the one who made me what I am today.,Na dat woman make me what I am today. "The woman really tried her best, she spent a lot.","Woman try, try, spend." It was just last week that we went for a family prayer.,Na just last week wey we go family prayer. And I was thanking God for...,And I dey tank God make... "I was praying to God to help out on that side of things, to do something for us.","I dey pray to God make God just ease dat side, do someting follow us." "Please, let God go... let God just try and do something for us there, please.","Abeg make God go, make God just try do someting for us dat side a beg." Mstchew but no.,Mtschew but no. "He's the one who knows as this, this, this, this life... this life...","Na e get as dis, dis, dis, dis life, dis life." I wonder... I wonder why... I wonder as mgbe a gasi na uwa ne eme ntughari na eziokwu true.,"I wonder, I wonder why, I wonder as mgbe a gasi na uwa ne eme ntughari na eziokwu true." O ne eme ntughari.,O ne eme ntughari. But look how I was when I was with my boss!,Ah see as I dey di time wey I dey for my oga hand. "Everyday, I, I, I...","Everyday, I, I, I..." "Everyday, we were just eating anyhow.","Everyday, we just dey chop anyhow we like." We didn't know that this life has two sides to it.,We no know sey dis life dey two. "Now, we have been seeing it now.",Now we don dey see am now. Ehn!,Ehn! Look at how skinny I've become.,See as I dry finish. "At the time, I'd... I'd go and eat suya worth five thousand, and be drinking like I wanted.","Dat time, I go, I go go chop suya five thousand dey drink anyhow I like." Ehn!,Ehn! We were just... we were just eating shawarma.,"We just dey, we just dey chop sharwama." "We were just smoking, going to club houses.","We just dey smoke, go club." "But now, even eating now is...","But now, even to eat now na..." "It's like, uh, a mountain on fire.",E dey like eh mountain on fire. "Before you would climb that mountain, uhuh, it would be very hard.","Before you climb dat mountain, ehen e go hear ween." Ehn!,Ehn! It would be hard.,E go hear ween! That's why...,Na im wey... That's why we go begging God.,Na im wey we go God abeg! One!,One! Two!,Two! "God, please, you should just try and help us.","God, abeg make you just try help us." That's the reason why we... why I am begging you.,"Na ting wey we, why I dey beg." Ehn?,Ehn? "God, please, I beg you.","God, please a beg." We are just begging you.,We just dey beg. I'm begging you.,A beg. "God, we are just, we are just begging you.","God, we just, we just dey beg." "God, we are just begging you.","God, we just dey beg." Just help me!,Just help me! Huh?,Ehn? "Look at my brother, that guy, ah!","See my bro, dat guy ah!" "My friend... ah my friend, Maxwell.","Omo ah my friend, Maxwell." "I spoke about Max-, Ma-, Maxwell.",I talk about Max-... Ma-... Maxwell. "That uh... that time, mstchew uh... but I...","Sey ah dat time, mtschew eh but I..." "That guy, I really helped that guy.","Dat guy, I really help dat guy." I really helped the guy.,I really help di guy. "When he said that, that time, the guy would...","When e say da, dat time, di guy go..." But the guy had known... sent money to our boss.,But di guy don know waya our oga. "The guy had sent money to that man, he bought cattle.","Di guy don waya dat man, di guy buy cow." How many cows?,How many cows? "He bought land, he bought a forest.","Im buy land, im buy forest." "There's nothing the guy didn't buy, nothing the guy didn't buy.","Noting wey di guy no buy, noting wey di guy no buy." "Even at that time, even as we went... even as we went... even as we went, uh... to my master's village, I was the one who went to find out where the prostitutes were working.","Even dat time, even as you go, even as we go, even as we go ah my oga village, na me go locate where asewo dey take gi-... give di guy." Mstchew I...,Mtschew I... "Uh, that guy, I miss the guy.","Eh dat guy, I really dey miss di guy." "Uh, that guy, I really miss the guy a lot.","Eh me, I dey miss dat guy well, well." I miss the guy a lot.,"I dey miss di guy well, well." "But I pray to God that one day, we will just go there.","But I pray to God one day, meh we just go dere." "Yesterday, this girl even called me, asking me, ""how far now?""","Dis yesterday, dis girl even call me dey ask me how far now?" Ahi!,Ahi! "Mstchew guy, this life... this, this, this, this life has two sides.","Mtschew guy, dis life, dis, dis, dis, dis life dey two o." "This life, that's how it is.","Dis life, e get as dis life be." "Where I am in this life, that's how life is.","Where I be dis life, e get as dis life be." That's how this life is.,Dis life get as e be o. Most people talk about why men watch football.,Most people dey talk about why men dey watch football. "In the first place, if you see a man watching football, most of the time...","In di first place, if you see man dey watch football, most times..." "Typically, anyway, some women watch football.","Typically, anyway some women dey watch ball." But you will see... maybe it's one in ten or two in ten.,"But you go see maybe na one out of ten, or two out of ten." Football fans are mostly men.,"Mostly, football fans na men." I sat down to think about it one day.,I sidown tink am one day. "In any house you go to, if you see the men in the house, if it's about time to broadcast a football match, they will say, ""ah, there's a football match.""","Any house wey you go, if you see di men wey dey di house, if de wan show ball, de go say ah ball dey." "They want to watch a match, they want to watch a match.","De wan watch match, de wan watch match." "The women will say no, no, they want... it's Zee World they want to watch, or they want to watch Big Brother, or something.","Di women go say no no de wan, na Zee World de wan watch, or de wan watch Big Broder, or someting." Then they will start fighting over who holds the remote.,De go come begin drag remote. "You know, or someone will say, ""ah, no, we have to watch the game.""","You know or you go see one person go say ah no, na ball we must watch." "The others will go and sit down on one side, complaining.",Di oder ones go go sit down one side dey complain. "Saying, ""what do these people even like about watching football matches?""","Sey dis people, wetin de dey even see for dis ball?" """Are they paying you?""",De dey pay una? """Do you know the players?""",You sabi di people wey dey play? "Uh... a match that's got nothing to do with you, you'll sit down and want to kill yourself.","Ehn ball wey no concern you, you go sit down, you wan kill yoursef." I sat down to think about it.,I sidown tink am. What makes men enjoy watching football matches?,Wetin make men like to dey watch ball? "So I sat down and found three things I noticed about what makes men enjoy watching football matches, which is different from women.","So I sit down, come bring out three tings wey I see wey make men like to dey watch ball wey dey different from women." I'm not saying anyone is right or wrong.,"No be sey I say anybody dey right, or e dey wrong o." "But there are differences between men and women, which make men like football while the women don't really care for it.","But e get differences wey dey between men, and women, wey make men like ball, wey women no too send am." "And the first thing is that every man, right from when a male child is born (which means he's a small child), they're more competitive than women.","And number one ting be sey every man right from when you born male pikin (wey be sey im na small pikin), de get dat hunger for competition pass women." It's in their nature.,Na deir nature be dat. "Once you have a male child, that yearning for competition is in his mind.","Once you born male pikin, dat desire for competition dey inside im mind." "He wants to test himself against his friends, and see that he is the best.",E wan test imsef against im mate make im see sey na im comot as di best. That desire for competition is in us.,Dat desire for competition dey inside us. And we grow up with it.,And we dey carry am grow. "Once, you notice that a man has grown to maturity, even if he himself cannot take part in competitions, he will want to watch the matches so he can say, ""okay, these are the people I support"".","Once you see man don grow up, even if e imsef no fit take part for competition, e go wan watch make e say okay na dis people I dey support." "And on the days they win, it will look like he's the who played and won.","And di day wey de win, e go be like sey na im play ball win." That's why you see us.,Dat'S why you dey see us. We discuss football.,We dey talk ball. "We will say, ""ah, we beat these people, we beat those people.""","We go say ah we win dis people, we win dose people." "You are a Chelsea fan; you are not a Chelsea fan, you weren't involved.","You be Chelsea, you no be Chelsea, you no dey dere." "You've never been near to their stadiums but you will say we are the ones, we are the ones.","You never near deir stadium before, but you go say na we, na we." It's because we have identified with them.,Na because we don identify wit dem. Why?,Why? Because of the competitive nature which is in men.,Because of dat nature of competition wey dey inside men. "Secondly, every male child has that desire to see someone as his hero.","Secondly, every male child get dat desire make e see somebody wey be im hero." Men want to have heroes.,Men get desire for hero. "They have that need to... for someone to look up to, who they want to be like, right from childhood.","De get dat need to, for somebody wey de dey look up to, wey de wan be like right from small." "That's why men, if you see them watching (even when they are younger), they like watching cartoons like Ben Ten, they like things like Superman, they like Batman, they like Spiderman.","Dat is why men, if you see dem dey watch (even when de dey small), de like cartoon like Ben Ten, de like tings like Superman, de like Batman, de like Spiderman." Why?,Why? "Because these are people who do things against all odds, and they will come out as champions.","Because dis na people wey dey do tings against all odd, and de go comot as Champion." "This does something in a man's soul, and that's what makes us like watching football.","Di ting get wetin e dey pull for inside man soul, and na wetin make us like to dey watch ball be dat." Because football gives us the heroes we look up to everyday.,Because football dey give us hero wey we dey look everyday. People like Cristiano.,People like Cristiano. "We'll see people like Messi, you will see people like Neymar, we see boys like uh... either Juan Mata, or Lukaku.","We go see people like Messi, you go see people like Neymar, we dey see boys like eh wheder na Juan Mata, or Lukaku." We see them.,We dey see dem. "And they are people who, even if we don't know anything about playing football, they represent us.","And na people wey be sey even if we no sabi ball, de dey represent for us." "Then, we will make them our heroes.",We go come make dem our hero. "And the third reason, every man wants to be a champion in something.","And di third reason, every man wan be champion for someting." "Even if you're not the one to take a ball with you to a field in order to play, you want to have that mentality that we got something done.","Even if no be you carry ball enter field go play, you wan carry dat mentality sey we do someting." "And we won, we achieved something, no matter the circumstances in which we found ourselves.","And we win, we achieve no matter di circumstance wey we see oursef." We have conquered all the odds which came up against us.,"All di odds wey come against us, we don conquer dem." We have emerged as the champions.,We don emerge as Champion. And that's what every man likes.,And na wetin every man like be dat. So that's what makes men like to watch football more than women.,So na wetin make men like to dey watch ball pass women. Because women... it's not that they don't like these things,Because women no be sey de no like dis tings. But mstchew they don't really care about it.,But mtschew de no too send am. Those kinds of things are not in a woman's psychology like they are in a man's.,Dose kind tings no dey for woman psychology di way e dey for man own. "So that's why women prefer to watch things which are calm, which have mild uh... stories.","So dat's why women prefer to watch tings wey dey calm, wey get mild eh story." You wanna know something?,You know someting wey be sey na gist? "That's why they watch Zee World, because it's a story,","Dat'S why de go watch Zee World because na story," That's why they watch Telemundo.,Dat'S why de dey watch Telemundo. Why?,Why? Because it's a story.,Because na story. Not something where everythi-...,No be tings wey be sey everyti-... "In fact, if you look at most women... not all women like action movies.","Infact, if you see most women, no be all women like action movie." They like calm things where they tell stories which have sweet endings... happy endings.,"De like someting wey dey calm wey be sey na story wey de dey tell, wey get sweet ending, happy ending." That's what women like to watch.,Na wetin women like dey watch be dat. But men are different.,But men mind dey different. "So if we have this understanding between us, maybe women will stop harrassing men, saying, ""why do men watch football matches?""","So if we fit get dis understanding between oursef, maybe women go stop to dey harass say why men dey watch football?" How is it that they can sit down and waste ninety minutes because you want to watch twenty-two boys kicking a ball around.,"Why be sey de go sit down burn ninety minutes talk sey you wan watch twenty two boys just dey dey kick ball up, and down?" They don't understand.,De no understand. "If you sit down and think about it, you will be able to understand men.","If you sit down tink am, you go fit get dat level of where man mind dey." "Then you will let things be, saying ""okay, I know how you feel, I know how you think.""","You go come leave am say okay I know wetin you dey feel, I know how you dey tink." """Sit down and watch your game.""","Sit down, watch your ball." """We don't mind.""",We no send you. """Go and enjoy yourself.""",Go do your own. """We'll do ours later.""","Later, we go do our own." Thank you very much!,Tank you very much! "Okay my people, good afternoon.","Okay my people, una good afternoon now." I believe you're good and you're body is in top shape.,"I believe sey una dey well, and una body dey kakaraka." "Okay, right now, at this very hour, we want to do some kinds of, you know, some quick eating and full belly issues, and uh... I will tell you some things you need to know about food.","Okay right now, right now on top of dis very time wey we dey now so, we want to do some kind of you know sharp, sharp chopping, and bellefulling matter, and eh I go just tell you some tins you need to know about food." Uh?,Hm? You know that you should not put every piece of food you see around you into your mouth.,You know sey no be every food wey you just see dey pass you go just carry put for inside your mouth dey chop. Uh?,Hm? "So sometimes, when you take a look at some food, uh... ask yourself if this food I wanna eat... if the food is good for your body or not.","So sometimes when you see food like dis eh, ask yoursef wheder dis food wey I want to eat, wheder di food, e good for my body, or e no good for my body." "Now let me ask you, ""when was the last time you got yourself checked?""",Now make I ask you when be di last time wey be sey you check yoursef? "I mean before you put the food into your mouth, you will first of all read about that, that food, get to know the health benefits of the food, know if the food is any good or not.","Like before you carry dat food now put for your mouth, you go first of all read about dat, dat food, come know di health benefit of di food, know wheder di food good for your kind of body, or e not good for your kind of body." "Because sometimes, you can put some food in your mouth.","Because sometimes, you fit carry some kind of food now put inside dat your mouth." "And when you are done eating, you will get an upset stomach, and that's not too good for you.","When you chop am finish, you go start to dey run bele, and e no too dey good for you." "So today on the program, right here and right now, I will tell you three things you need to know about food.","So today, on top of di programme now, now, now, now, I go tell you three tins wey you need to know about food." "Number one, you know that the way you present your food... the way you serve the food to someone can determine if the food will be eaten or not.","Number one, you know sey di way you present your food, di way you carry di food take give person fit make di person chop di food, or e fit make di person not chop dat food." Uh?,Uhm? "So when you are presenting food to someone, at least, do it with a smile.","So when you dey give person food like dis, at least, make you laugh small for your face." "Garnish the food with, you know, with all sorts of protein and the like, so that the food will be inviting and others will love to join you in eating it.","Put some kind of, you know some kind of passengers inside dat food wey go make oder people sef wan join you to share for di passengers eh food." "Because if you put inyorominyo in your food, someone may come, look at it, and won't be able to eat it.","Because when you put eh iyorominyo inside food, anoder person sef come see am, e no go fit eat am again now." Uhum!,Uhum! That is number...,Dat one na number... That is number one.,Dat one na number one. "Okay, number two.",Okay number two. Did you know that the carrots you normally chop come in different colors?,"You know sey your carrot wey you dey chop so, na different, different colour na im dey for inside carrot." "They come in white, purple and even red.","You get white, you get purple, you even get red." "In fact, sometimes, you will wonder if the one you have is a carrot or not.","Sometime sef, you go dey imagine wheder dis one wey be sey you see, wheder na carrot." It's a carrot!,Na carrot! It's because it's not available in Nigeria.,Na because of sey e no dey for inside Naija. We only know that carrots are orange in color.,We only know sey carrot na only orange colour. But they come in other colors besides orange.,But no be only orange colour. "So when you go overseas and are given a white carrot, don’t be afraid because it's a carrot too.","So, when you go obodo Oyinbo now, you see dem, see dem, sey de give you carrot, and di colour na white, make you no fear because na carrot be dat." "And you know that no matter how many carrots you eat, even if you eat them all day, from... uh... the first uh... week to the last week of the three hundred and sixty five days in a year, you cannot gain more weight.","And you know sey no matter how you wack carrot from morning till night for eh first eh week o go reach di last week for even three hundred, and sixty five days wey we get for dis year, you know sey you no go fat at all, at all." Why?,Because why? Carrots contain no fat.,"Carrot, e no get anytin like fat inside." They contain zero percent fat.,"Zero percent of fat, na im dey inside." Number three.,Number three. Uhum!,Uhum! This third thing I want to tell you is really very important.,"Dis number three wen I wan tell you so, e dey very, very important kwa." When I say very important kwa... I spoke a bit of Igbo there.,"When I say very important kwa, I don speak small Igbo inside dat place." I'm not supposed to interject in Igbo.,I no suppose to put Igbo. "But it is very, very important.","But e dey very, very important." "Now, you don’t ask yourself, this okra you want to cook with, what is its other name?","Now, you don ask yoursef sey dis okra wey I dey use take dey cook my food, wetin be di oda name of okra?" You don’t ask yourself that.,You don ask yoursef. "This okra, apart from the fact that I grate the okra and I cook with it, what can I use this okra for again?","Dis okra, apart from sey I carry okra take chop, take am take cook food, wetin again I fit use my okra for?" "If you have never asked yourself that question, I will tell you now before I go.","If you never ask yoursef, I go tell you now before I comot." "In fact, what you call okra is not really called okra.","Your okra sef, de no dey call am okra o." "It is called lady fingers, yes.",Na finger ladies yes. You might be wondering if these are the same fingers from a woman's hand.,You fit come wonder sey na di kind hand wey woman dey carry? Leave it that way!,Leave am like dat! But it's lady fingers.,But na finger ladies. "So if you go abroad and you hear okra being called lady fingers, eat it because it's okra!","So if you go obodo Oyibo, you hear what de call okra, finger lady, chop am because na okra!" "Then, number two.",Den number two. "With okra, instead of you cooking the okra, cooking it... cooking it... cooking it... cooking it... cooking it, I'll tell you really fast how you will process your okra, so that you can eat it without cooking it.","Inside dat your okra, instead of you to dey cook di okra, cook am, cook am, cook am, cook am, cook am, I go just tell you sharp, sharp way wey you go need to arrange your okra, wey you go fit eat your okra witout you no cook am." See how you will process it!,See as you go do am! You have some stew already prepared in the house.,You get your stew wey you don keep for house before now. "Okay, do you have some stew which you have already prepared?",Okay you get your stew wey you don cook for house before now? Aha!,Aha! "If you have lady fingers, which is also called okra, in the house, instead of throwing that prepared stew away, just put it on the flame, leave it to boil a little,","Dat your stew wey you don cook for house before, instead of you to carry di stew troway, and you get dis your fingerlady for house wey dey call okra so, just carry dat your stew, put am for fire, allow am make e boil small." "You know, let it simmer.","You know make e get some poto, poto, poto, poto." "When it has boiled for some time, cut your okra into small pieces.","When e boil small, carry dat your fresh okra, cut am mpempe, mpempe, small, small o." "When you've finished cutting it, take your stew... take the fresh okra and put it in a corner of the pot of stew.","When you cut am finish like dat, carry dat your soup, take dat your fresh okra, put am for corner of di soup." "Then, what will you do?","Den, wetin you go do?" "If you have powdered fufu or if it is gari or semovita/semolina, just eat the fufu with the okra.","If na loi, loi you get, if na gari you get, if na semo, just use di okra, and di loi, loi lem dem togeder." "Then, your body will be very strong.","Den, your body go dey very, very kampe." Good afternoon!,Good afternoon! My name is Joy Ossai.,My name na Joy Ossai. Thank you!,Thank you! "Alright, if you're listening to me, this is my own little story of how my first day of... at uh... school, Kaduna State University basically went.","Alright if you listening to me, dis one na my own little parsee of how my first day of, at ehn school, Kaduna State University basically was." "So a long time ago, I was hearing that the university is a big place where you come to, you know, and meet people, as in...","So before, before I bin dey hear sey university na one kind big place wey be sey you just come you know meet people as in." My mindset towards these things is that you...,My own mindset towards dis tings be sey you... "When you get into the university, you get to meet the big shots, different kinds of people, but guys, the kind of picture I saw over there, guys... I got tired of the part time program, I swear to God.","When you enter university, you get to meet di big shots, different kind of guys like dat, but mehn di kind picture wey I con see for dere mehn, di part time tire me walahi." "So when I came in as a freshman, the usual practice is that in college, students don't gather together on the assembly ground.","So when I enter now, as per jambitos now, di usual parade be sey university de no get assembly." "So I met a guy, by chance.",I con jam one guy now. I started enjoying hanging out with the guy.,I con dey like reason wit di guy. "Man, what's up?","Guy, what's up now?" Where's the assembly ground?,Where be di assembly ground? This guy really laughed at me.,Dis guys laugh me ehn. Mstchew.,Mtschew. "Man, it was not easy that day.",Kai e no easy dat day. I started thinking that I should just like... call it quits.,I bin reason like sey make I just like call am quit. I should just go back to my dad's.,Make I just dey go back to my papa house. "But if the worst happens, I have to move on.","But worst get to worst, I gats move on." That's life.,Na life be dat. "So on that note, I pushed on, asking one or two questions, and I met some kinds of people.","So onto di level now, I push forward, dey ask one or two questions like dat, con meet some kind people." "In fact, the way they looked at me, you know the way I dress, thinking that becoming a big boy... a new student, coming in as a freshman (you know), wanting to get uh... a hold on the university life.","Di way de look me sef, you know di way I dress as per tinking sey onto a big boy level, a jambito coming as a fresher (you know) want to get eh di university life into my head like dat." So we came to a point where we finished registrations.,So we con get to a level wey be sey we finished registration. "After a few weeks, we were asked to start classes.","After some weeks like dat, de con tell us sey make we start lecture." "I was thinking that it's that kind of secondary school thing where we will be... we'll be talking, you know.","I bin tink sey na dat kind secondary school something wey be sey we go con, we talking you know." Aha!,Aha! I was fed up.,Di ting tire me. Then I was complaining to one of my friends.,I con dey like spark for one of my guy. "I said, ""guys, is this how things work in the university?""","I say bros, na so di university dey?" """What kind of uniforms do we wear?""",Which kind uniform we wear now? """Is it shorts or pants; long sleeve shirts or what?""","Na short knicker, abi na long trouser, abi na long sleeve, abi which one?" "You know, based on my secondary school experience.",You know base on my secondary school experience. But the whole college thing was like a totally different experience.,But di whole university ting was like a different gig for my liking. "So when lectures started, as usual, there were lots of girls and guys.","So when di lecture start now, as per di usual parade, con see chicks, see guys." "Everyone was giggling, moving around, you know.","Everybody dey bubble, dey shuffle you know." So had the very first lecture.,So first lecture come. I won't forget it.,I no go forget am. Math 101.,Maths 101. "Guys, it was not easy to solve some kinds of math after several years, but usually as a Kaduna guy there's no messing around.",Mehn e no easy after some years like dat for just some kind maths though usually no dulling as per kd guy now. "It's a win-win situation, at most.","Patapata na one, one o." No loss.,No dey lose. We got a draw.,We gader draw. "When the lecture was over, we got going.","After di lecture now, we comot." That was when I got to know what they call the school market.,Na den I know wetin de call school market. "Man, you don't need to try the kind of things there!",Kai you no need to try di kind jamz wey dey dere! "Check out the restaurants, check out the fries!","See restaurant, see fries!" "There are different kinds of things there, you know.",Different kind of tings like dat dey you know. Which will drain your pocket.,Wey be sey e go like shorten somebody pocket. But those side attractions didn't really grab me.,But dat side attraction no too capture me o. "But guys, when I saw the kind of ladies that were there, guys, I was overwhelmed.","But mehn when I get to see di kind babes wey dey dere, mehn my eye shun." Mstchew!,Mtschew! Then I started thinking.,I con dey reason. Is it for school I came here or is it for the birds?,"Na school carry me come, abi na chicks carry me come?" "But when you get to a level like that, a guy's gotta... you know, a guy's gotta show off.","But onto some kind level like dat, man must, you know man must flex like dat now." "So as things unfold, I came in contact with a lady.","So as go con dey go now, I con jam one chick like dat." Her name is Deborah.,Her name na Deborah like dat. We got to the point where we were enjoying being together.,So we con get to dey flenjo now. So this lady and I started a one on one relationship.,So me and dis chick con dey relate onto one on one level. "And luckily enough, the babe is a freshman like myself.","And lucky enough for me sef, di babe na jambito like me." She also lacks experience.,She too no get experience. She and I are the same blind horses that like to run in the same dark uh... this thing.,"Me, and her are di same blind horses dey like run for di same dark eh dis ting." So we went into a restaurant.,So we con enter restaurant now. "As a sharp guy, it occurred to me that I'll be the one to pay for her meal.","As per a sharp guy, dis ting con dey reason sey na me go pay for her own food matter." "In other words, it means man, I'm stuck!",As in kai agbada don hook wire today be dat! I sized up the situation at hand.,"I reason my body up, and down." "Guys, they call it silva in Hausa.","Mehn for Hausa, dey call am silva." That calls for fifty naira!,Na some kind fifty bucks be dat! That means you're able to afford it!,You go fit get be dat! So this babe started ordering some things which are beyond my means.,So dis babe con dey order for some kind tings wey be sey de dey beyond my understanding. "But as a normal guy, if the worst happens, when you wake up in the morning, in this kind of uh... northern setting, you can't go without getting into small problems, and small problems like fifty bucks.","But as per a normal guy, patapata in di morning, you wake up for dis kind ehn northern setting like dat, you no pass meh just go jam small cocoa, and small cosy like dat fifty box." "At worst, it means you are done showing off that morning.",Patapata you don finish your morning parade. "At least, you get organised so that you feel OK for the whole day until maybe later something will come up like that.",At least you will organise feel bam like dat for di whole day till maybe later racket go come up like dat. So this babe just started placing her orders.,So na so dis babe just begin order o. "I saw fried rice and pshew, the thing came out.","I see fried rice, pshew di ting jump come." "She called for chicken, the thing came out.","She call for chicken, di ting jump come." "She called for soft drinks, the thing came out.","She call for soft drink, di ting jump come." A'Ah!,A'Ah! So she got tired,Di ting con tire her now. "Myself, I'm not placing orders for anything.","Sey me, I no dey order for anyting." She didn't know that I don't like...,She no know sey I don't like... "Instantly, she worked out that all these things will be on me.","Shapadly, don code sey all dis ting go dey on me." "So I was trying to blend in, blend in, blend in, blend in.","So I con dey like blend, blend, blend, blend." "Luckily enough, when I was ready to leave in a hurry, I saw one of my boys, because that... the guy is...","Lucky enough now, when I wan dash now, I see one of my guy like dat cos dat, di guy is..." "During registration, that's where we got to know each other.","During di registration, na dere we get to meet ourselves." "So in the restaurant, the other guy was bringing the bill for me at last.","So for di restaurant, di oder guy was like bringing di bill for me at last." "When the bill was placed on my table, my eyes... my eyes lit up just like someone who just saw a ghost or something like that.","When di bill just land my table, na so my eyes, my eyes just shine like sey na person wey see angel, or someting like dat." "I said, ""what is this?""",I say which kind dis ting be? "I was pissed off, eh.",I just rake eh. "I just calmed down, relaxed... I just handed the bill to the girl and told her I would be back.","I just calm down relax, I just forward di bill to di girl, I just tell her sey I dey come." "Those guys, they need my attention.","Dose guy, de need my attention." So little did I know that the babe herself was street wise.,So unknown to me sey di babe ma na one kind coded babe. "She wanted for me to like drop my phone or something like that so if I go, I won't get out of the... I won't get out of paying, something like that.","She gats wan like make I drop my phone so dat dat kind ting, if I dey go, make I no really escape di, make I no escape di billing, someting like dat." "So there and then, I finally came back.","So dere, and den, patapata, I just come back." "Mtschew, since I felt like maybe this thing... she also, as she was placing orders for those big, big things, she was hoping that based on the way I dressed... you know the way I like to combine things and put everything on the right way...","Mtschew since I feel like maybe dis ting, she too, as she dey order for dose big, big tings, she dey hope on sey, base on di way wey I kack mysef (you know), di way wey I like couple, and like arrange mysef." He's a big boy and all that.,Na dat kind big boy stuff like dat. Little did she know I had no money on me.,Unknown to her sey noting dey me. I only had fifty naira on me.,Na fifty bucks dey my body. So that's where this babe and I talked.,"So na so dere, me, and dis babe yarn o." So that's how we washed plates for the entire day.,"Patapata di whole of dat day, na so we wash plate." "Uh... man, college life isn't easy, man.","Ehn guy, university system life mehn, e no just gel." "So from then on, I started picking up experience that taught me that in this life, even if the worst thing happens, just be yourself.","So from den on, I get to dey pick up experience sey for dis life, worst get to worst, just be yoursef." "At all... come out straight and tell them, ""look what the matter is at hand!""","At all, comot, tell dem, see di matter wey dey on ground!" "It's either you're lucky or not; whatever the outcome, it will be clear to you.","If you hold ground, you hold ground, if you no hold ground, you no hold ground patapata you know." That's how it is.,So na so di ting just be o. Classes went on.,"Lectures just dey go on, dey go on." "That's how we've been learning day by day... day by day... day by day, up until now.","Na so we just dey learn day by day, day by day, day by day till we con get to where we dey today." "Good morning, guys.",Good morning my people. How are you?,How una dey? How was your night?,How your night? Hope you slept well.,Hope sey you sleep well. How...,How? "My name is Charity, anyway.",My name na Charity sha. I'm from Delta State.,I from Delta State. "I'm from Delta State, but this is where my mom and dad had me.","I come from Delta State, but na here my mama, and my papa born me." So it's here that I... I grew up in Abuja.,"So na here I, I grow up for Abuja." "And my parents, they always brought people back home.","And my parents, de bin carry people home." They didn't take me with them when they went back home.,De no dey carry me travel go home. I always...,I dey always... This is where I stayed.,Na here I dey. This is where I grew up.,Na here I grow up. So this is where I even went to school.,So na here I even go my school. "I didn't finish, by the way, because of some kind of... I had no money.","But I never finish sha, cause of some kind, no money." "So, I am just at home.",So I just dey house. Then I learned hairdressing.,I con learn hairdressing. "So now, I plait hair for my neighbours, and that's how I get by, how I get myself f-... get myself certain things because I don't like to disturb my mother since she doesn't have any money either.","So now, I dey plait hair for my neighbours, and na dat one I take dey help mysef, take dey f-... fe-... get mysef some kind tings because I no dey like to disturb my moder because she too, she no get money." Everyone's working hard to get by.,Everybody dey hustle. "My dad, my father isn't here.","My dad, my fader no dey here." "He's in Benin right now, anyway.",Im dey for Benin now sha. He works there.,Na dere im dey work. "So again, mtschew, this our, mtschew, Abuja life, it's not so easy.","So and again mtschew ehn dis our mtschew Abuja life, kai e no too easy o." Things are difficult here now.,Tings hard for here now. Things are difficult in Nigeria.,Tings hard for Naija. There is no money.,No money. People are suffering.,People dey suffer. "In fact, things are really expensive in the market.","In fact, tings cost for market die." "If you go to the market, the things you see that you would have bought last year for let's say uh... two hundred naira, now cost six hundred, seven hundred naira.","If you go market, tings wey you go fit see, wey you go take, wey you go buy last year of (mah say) eh two hundred, now e don be six hundred, seven hundred." "In fact, just to eat now, if you don't have a job, you are on your own.","In fact, to even eat now, if you no dey work, you are on your own." You will suffer.,You go suffer. People are hungry.,Hunger dey. Even me I'm saying that God has helped me.,"Even me sef, wey I con even say God con even help me sef." "As I was working in my salon, God helped me out.","As I dey do my salon, God con help me." Then I was admitted.,I con get admission. "In fact, I was even crying to God, why did you get me accepted when I have no money?","In fact, I con dey even cry for God sey God, why you con even give me dis admission dis time wey be sey no money?" Uh... there is no money.,Ehn no money. "For my registration, there is no money.","To do my registration, no money." "My dad, for almost three months, almost four months now, has not been paid.","My dad, for almost three month, to four month now, de never pay am." We're just barely getting by at home.,We just dey hustle for house. "In fact, just feeding yourself isn't easy.","In fact, before we eat, e no easy." "And now, I'm about to start university too.",And now wan even resume sef. I don't know how my university even works.,I no even know how we take even do my school. I was just praying for God to open some doors for me.,I just dey pray meh God open door for me. God should help me.,Meh God help me. And I'm just praying for this country.,And I just dey pray for dis country. God should just make a way for this country.,Meh God just open way for dis country. This country should go back to the way it was before.,Meh dis country go back to di way e dey before. Because we are tired.,Because we don even tire. How could we be in... what we say norm-... there is no money.,How we go dey for wey dey say norm-... no money. Nothing at all.,"Nothing, nothing." "Mtschew, in fact, I'm tired of this country.","Mtschew in fact, dis country ma don even tire person." "Okay, you even opened a salon to work.",Okay you even open salon sey make you dey work. People...,People... No money!,No money. People... customers will come and ask for low prices.,"People, customers will come, de go dey price low." When things in the market are expensive.,And tings for market cost. They will ask for low prices.,De go dey price low. "Some, even if you treat them well, won't pay you.","Some, if you even do dem well, de no go pay." What?,Ehn? Why... why...,"Why, why..." What... what are we...,"Wetin, wetin we dey..." Where... where are we going in this country?,"Where, where dis Naija dey go for dis country?" Where are we going?,Where we dey go? "Anyway, we just need the hand of God.",We just need di hand of God sha. "We just need God to help us, because, in fact, without God's help, we don't know where we're going.","We just need meh God help us, because, in fact, if God no help us, we wonder where we dey go." "Brothers and sisters, as you hear my voice, wherever you are, whatever you're doing, you should put God first.","My broders, and my sisters wey dey hear my voice, anywhere wey una dey, anyting wey una dey do, meh una put God." God should come first.,Meh God dey first o. "Because God, He comes first.","Because God, na im dey first." "Without God, you're on your own, because if not, if you don't have God, you'll suffer.","Without God, you are on your own because if not, if you don't have God, you go suffer." You'll suffer.,You go suffer. "Also, whatever you do, make sure you work hard.","And anyting you dey do again, make sure you dey hardworking." "If you work hard, you will not go hungry, you won't know hunger.","If you dey hardworking, hunger no go meet you, hunger no go near you, hunger no go come where you dey." "Well, what happened to me before, what happened to me before which I remember and can't forget, and which in fact was God... it's God, He is the one who did it, it is my school stuff... it's my school.","Ehn wetin dey happen for me before, wetin don happen to me before wey I know sey kai, I no fit forget am, and in fact, na God, na God na im even do dat one be sey na my school stuff, na my school." "Because as I was doing my hairdressing and taking the JAMB, I wasn't failing but I wasn't going to get in either.","Because as I dey do dis hairdressing, and I dey write JAMB, no be sey I no dey pass am, but I no dey get admission." I prayed.,I don pray. "Mtschew, but in fact, it got to a time when... I just took my mind away from it saying maybe God doesn't want me to go to school again, or I'm not meant to go to school.","Mtschew but in fact, e con even get time wey be sey I come, I just comot my mind, be sey maybe God no wan mah go school again, or be sey I no dey favour to go school." "So, then the last time I sat for JAMB... the last time I wrote JAMB, I didn't get in.","So now, di last time wey I write JAMB, di last time wey I write JAMB, I no get admission." I waited and waited.,"I wait, wait, wait, wait, wait." All the schools had started classes.,"For all di whole schools, de don start lectures." I was at home.,"And me, I dey house." "Everyday, I was thinking.","Everyday, I go dey tink." Why didn't I get in?,"Why me, I no get admission now?" What is all this?,Wetin be all dese tings? "Mtschew, that was when I said well, let me just forget about it.",Mtschew naim I say toh mah just kuma forget about am now. I even went to look for a job.,Now I even go look for work. "As I looked for a job, I was working then, the day I had worked for exactly two weeks, because everybody I had... who... everybody who promised me they would help me for my admission, they told me not to worry, not to worry","As I look for work, I con dey work di day wey I complete two weeks because everybody wey I don, wey, everybody wey promise me sey de go help me for my admission, de tell me sey mah no worry, mah no worry." They would...,De would... "By any means, they would definitely help me.","Any means, de go help me, de go help me." "School started, lectures started, no news, nothing at all.","School start, lecture start, no news, noting, noting." "I said, well, maybe I won't get in...",I say toh maybe I no go get admission dis... "In fact, I'll forget about school.","In fact, I go forget about dis school." I won't take the JAMB again.,I no go write JAMB again. Let me just do my work.,"Mah just face work, my work." Let me just keep doing my work at home.,Mah dey do my work for house. "For God who loves me, I didn't know if God still liked me.","For God wey like me, I no know sey God still like me." "The day I finished two weeks at the shop I was working at, I got a call, an unexpected call from an unexpected person.","Di day wey I complete two weeks for my shop where I dey do my work, na so I just receive call, unexpected call from unexpected person." "They said ""hello, is this Charity, is this Charity I am speaking to?""","De say hello, na Charity dey, na Charity I dey speak to?" I said yes.,I say yes. "They said, ""please, come to the school right now, come and get your admission letter, you've been accepted.""","E say abeg come school now, now, now, now, now, now, come collect your admission letter, you don get admission." "Ha, I said ""me, how come?""","Aha I say me, how comes?" "They said ""hurry up and come, you could even start classes today, really.""","De say do fast, and come, you go fit even start lecture today, today sef." That was how I just...,Na so I just... "My boss wo..., my boss I was working with, he was just happy for me that... wow!","My oga wo-... my oga wey me, and him, we dey work togeder, e just dey happy for me sey aha." He even gave me the transport fare saying I should go to school right away.,"E even give me transport, say oya go school, go school." "When I got to school, you can't imagine the line to get the admission letter.","When I go school, di place sey de dey even dey collect di admission letter sef, see queue!" "I was there wondering ""How will I even get this admission letter?""",I con dey eh how I go take even collect dis admission letter? "Even if I wanted to get the admission letter, I wouldn't be able to today!","If I wan even collect dis admission letter, I no fit collect am today o!" Mtschew!,Mtschew! "But I said well, first let me go see the person who asked me to come.","But I say toh mah go first, mah go di person wey call me sey mah come." So I went to her office.,I con go her office. "Then she said ""Oh, Charity, I have been looking for your number!","She con say see o Charity, I don dey look for your number since!" Thank God you came today!,Tank God sey you don come today! "In fact, you have have been admitted.","In fact, you don get admission." "Okay, sit down in my office, sit down in this chair.","Okay sit down for my office, sit down for dis chair." Make yourself comfortable.,Make yoursef comfortable o. I will give you whatever you need.,"Anyting you want, I go give you." "Let me go and get your admission letter for you.""",Mah go hustle for your admission letter for you. This woman just went... went to the place where they were getting the admission letters.,"Dis woman just go, go di place sey de dey collect admission letter." She did everything for me.,She do everyting for me. Got my admission letter and brought it to me.,"Collect my admission letter, con give me for where I dey." She even got the receipt for my school fees which would have been a pain to get.,"Even collect receipt for my school fees wey even before even collect di receipt for dat school, you go suffer." You could wait in line for a week and still not get your receipt.,"You fit even dey for queue for one week, you no go collect receipt." "But this woman went and got my admissions letter for me, got my receipt for me and brought them back to me like I was the president's kid.","But dis woman collect my admission letter for me, collect my receipt for me, con give me for hand like sey me, I be president pikin." "She brought them over and said ""take your admission letter, take your receipt, you can go pay your school fees, you can even got to class today. Go and check your timetable, maybe you have a lecture now you can attend"".","She con give me sey take your admission letter, take your receipt, you fit go pay your school fees, you fit even receive lecture today, go check your timetable, maybe you fit get lecture now meh receive." "I just said ""oh, God, this God is too wonderful ah.""","I just say oh God, dis God is too wonderful ah." I don't even know how I can thank God.,I no even know how I want take even tank God. "In fact, this thing God did for me, I am not sure I could ever in my life be able to forget it.","In fact, dis ting wey God do for me, I no sure sey I go fit ever for my life forget am again." "Ah, babe, how are you?","Ah babe, how far?" "Um, fine.",Hm fine o. How are you?,How you dey? Eh!,Eh! "Ahah, what you're doing like this, you're just locking up as if nothing is happening.","Aha dis one wey you dey do like dis, wey you just dey lock up like sey nothing dey happen!" Aren't you in Nigeria?,You no dey Naija so? "I'm fine, I'm fine.","I dey o, I dey o!" "I'm just coming from the road where I saw like small small, small, small children who, as in who are in secondary school, who were like eight years old, they'll be in JSS3.","Na road I just dey come from o wey I just see as in small, small, small children wey, as in wey dey for secondary school, wey be like as in eight years go dey JSS three." Ahah!,Aha! Uhuh!,Ehn! Aha!,Aha! I just don't know what's happening to this country or if it's all over the world this thing happened.,"I no just know wetin dey happen to dis country, weda na di whole world di thing happen." I just don't know what's happening to this country.,I no just know wetin dey happen to dis country. "Ah, man, but what you're saying is like...",Ah omo but dis one wey you dey yarn like sey... I don't know.,I no know. I'm telling you.,I dey tell you. Aren't you Nigerian?,Eh no be Naija person? "Before that, at the time when we were uh... uh... when we were with our parents, our mother and father, a'ah then, it was old mo-... mo-... mo-... mo-... mothers that were, that were even in primary school.","Before dat, di time wey we dey, eh eh wey we, our parents, our mama, and papa, a'ah den, na old ma, ma, ma, ma, mama na dem, na dem even dey primary school." Well!,Toh! Uhuh.,Ehn. "You mean mom and dad, our mothers, our mothers!","You mean pupsy dem, and maale dem, maale dem!" Not even secondary school.,No be even secondary school. Haha.,Haha. "I remember when I was little, when I was little.","I remember di time wey I dey small, di time wey I dey small." What happened?,Wetin happen? Because I was good at school!,"Ehe because I know book well, well o." "From primary four (I was still seven at the time), one day, then my father just... my father just came to the school.","From primary four (dat time, I even still dey seven years), one day, naim my papa just, my papa just come school." Hm.,Hm. "My uh... teacher met him, told him that... uh... that I, I... I'm good at school, I'm very good, that he should buy the uh... uh... uh... (what's it called again?) Common Entrance Examination, that I will pass.","My ehn teacher come meet am, come tell am sey, eh sey I, I, I know book, I know book well, well, sey make e buy eh eh eh (wetin dem dey call am again) Common Entrance Examination, sey I go pass am." Aha!,Aha! "Since I was good at school, he went to buy it.","With, because I know book, e come go buy am." "I passed the exam, I went to school, oh boy!","I pass di exam, I enter shool, o boy!" Ah!,Ah! If you see suffering...,If you see suffering... You have a high level.,Your own level high o. My own father doesn't behave like that.,My own pupsy no dey do like dat. Hm!,Hm! "Oh boy, forget it!",Oh boy forget! That's what I'm saying.,Na wetin I dey tell you. You're not supposed to be too young when you go into Secondary School now.,You no suppose small when you go dey enter secondary school now. O-...,O-... Ah!,Ah! I said I... I didn't even know how to take care of myself.,"I say I, I no even know how to take care of myself." Ha!,Ha! "Anytime we had visiting day, my mama would cry because at the time, I didn't know how to take care of myself.","Anytime wey we dey get visiting day, my mama go come dey cry because dat time, I no know how to take care of mysef." Eh!,Eh! Hm!,Hm. "Those people they call uh... mtchew, uh... school mothers... school mothers, yes that's what they call them.","Dose people wey de dey call er mstchew er school mothers, school mothers, yeah na wetin de dey call dem." "Uh, ma... mom... mom... school moms.","Eh ma, mile, mile for school now." "Eh, okay.",Eh okay. Yes now.,Ehen now. "The lady, she ate all my provisions.","Di lady, she chop all my provision." It was no small thing!,No be small thing o. "My milk, everything.","My milk, everything." Shoot!,Shoo! I wasn't even staying in the hostel.,I no come dey even dey stay for hostel. Eh!,Eh! "After we read at night for homework, I slept in class.","After we read in di night for prep, na class I go sleep." Aha!,Aha! Haha.,Haha. I would carry my uniform like that to class.,I go carry my uniform like dat dey go class. I wasn't able to take a shower.,I no go fit bath. Uhuh!,Ehn! So you stayed in a boarding house.,So you bin stay for boarders sef. I stayed in a boarding house.,I stay for boarding house. That's what I'm saying.,Na where I dey talk. Eh!,Eh! "All these children shouldn't, as in, think that they want to go fast.","All dis children, meh dem no dey as in think sey dem wan go fast, fast." "At least, everything should be gradual.","At least, make everything dey step by step." How to manage?,How manage? But it is not people's fault like that now.,But no be people fault like dat now. It's because of...,Na because of... Isn't it... aren't they... isn't it... isn't it our fault? Isn't it our fault?,"No be, no be dem, no be, no be our fault, no be our fault?" "Let me tell you something, for you to know a thing or two.",Make I tell you something make you sabi small. "They are spoiling Nigeria, they are spoiling this country.","De dey spoil Nigeria, de dey spoil dis country." I'm telling you!,I dey tell you! "Everybody, everything has to go step by step.","Everybody, everything has to go step by step." See...,See... It's not all about being hasty.,No be sey you go dey do gragra. "Look at money! They want to be hasty about it, you want to be impatient about it.","See money, dem wan do am gragra, you wan do impatience." "If it's on the road, everybody wants to go fast; if it's e-... e-... exa-... e-... examination, everybody wants to get something quick.","If na road, everybody wan go fast, fast, if na e-... e-... exa-... e-... examination, everybody wan do gragra get something." If it's uh...,If na eh... Everything is...,Everything na... What is life?,Wetin dey life? "Nigerians, we just don't have patience at all.","Nigerians, we no just get patience at all." I am telling you!,I dey tell you! But what do you think about it?,Or how you think am? "So, babe, I will tell you the truth.","So babe, I go tell you true." Leave the matter for Mathias.,Make you leave matter for Mathias. "Eh, it's not what you're saying.",Ehn no be dat one wey you dey yarn. It's not that...,No be sey... "You see, let... let me tell you in case you don't know.","You see, mah, make I tell you wetin dey in case you no know." "The thing is spoiling us, it's spoiling us, I'm telling you.","Di thing dey spoil us, e dey spoil us, I dey tell you." "See, Nigeria's challenge, it is...","See, Naija challenge, e dey..." That one is too much.,Dat one dey too much. Ha!,Ha! "Eh, it is too much.",Ehn e dey too much. But the thing is that Nigeria makes people smart.,But di thing be sey Naija dey make person get brain. "If you're not smart, you'll get smart quick.","If you no get brain, you go begin get am shaperly." That's how Nigeria is for us.,Na so Naija be for you o. Let me tell you!,Mah I tell you! "What makes people act like that is that they need to just try to, for them to try to meet up to certain things.","Wetin dey make people dey do like dat be sey de need to just try to, meh, meh de don try to you know fit meet up for certain things." "If you don't run it, if you don't run the package like that uh... you will just... you will crash there.","If you no run am, if you don't run di package like dat eh, you go just, you go crash for dere." You'll even see a ki-... kid who doesn't even know how to speak will be in the nursery... in the nursery class.,"You go even see pi-... pikin wey no even know how to speak go dey nursery, nursery class." What now?,For wetin now? Come on!,Haba! That's how it is now.,Na so now. For what?,For wetin? "That is how it is, but... be... but... but let me tell you.","Na, na so di thing be, but be-... but before, make I tell you." We're always rushing things in Nigeria.,We too dey rush something for Nigeria. I'm telling you.,I dey tell you. We are rushing too much.,We too dey rush something. "It's not good, it's not good.","E no good, e no good." "Ah, but we will... we need to rush it now.","Ah but we go, we need to rush am now." Aha!,Aha! We are not supposed to be rushing things.,We no suppose rush things. That's why the white people themselves are lying... are afraid of us.,"Na im make di Oyinbo demsef dey lie, de dey fear us." Aha!,Aha! That's why they are afraid of us.,Na im make dem dey fear us. "Even if we stay on the road, you will see traffic lights.","Ah even if we stay for road, you go see traffic light." Where are you r-...?,Where you dey r-... ? It's not like you're rushing anywhere.,No be sey you dey rush go anywhere. You'll just want to speed away.,You go just wan rush go. "If the police come to handle you now, they'll be saying ""please, I don't have any money, what...""","If police con come now, con handle you now, de go dey say abeg I no get money, wetin... ?" "I don't have any, I don't have any, I don't have any, but you're the one who doesn't, who doesn't have any patience in this country.","I no get, I no get, I no get, but na you be person wey no just, no, no just get patience for dis countrty." I am telling you!,I dey tell you! "Which, which police?","Which, which police?" "It's no good, it's no good.","E no good, e no good." Which of the police are you talking about?,Which of di police you dey yarn sef? Is it this kind of police that we have here that you're talking about?,Na dis kind police wey we get for here na im you dey yarn? Which police?,Which police? "But now, you know that sometimes, some... most of these police, they are doing all these, uh... uh... uh... road uh... transport work, all of them.","But now you know sey sometimes, some, most of dis police, de don dey do all dis eh eh eh eh road, eh transport work ehn all of dem." They are doing something.,De dey do something. They have...,De don dey... "Some... some... some of them are good of course, some of them are good.","Some, some, some of dem good sha, some of dem good!" Do you want to say they are already adjusting?,You wan tell me sey de don dey adjust? Please don't let me spoil my country.,Abeg make I no just spoil my country. "Some of them are good, some of them are good, some of them are good.","Some of dem good, some of dem good, some of dem good." "But just the ones I met now, they are fucked up.","But just di ones wey me I don meet now, na fuck up o." I'm telling the truth.,I dey tell di truth. That one does not...,Dat one no... "In Nigeria here, everything uh... even those Adigo police that you are talking about, they are the ones that hurt you the most.","If for Naija here, everything ehn, even dat Adigo police wey you dey talk about, na dem dey do you pass sef." "Sometimes, you wonder.","Sometimes, you go dey wonder." They say the police are your friend.,"De say police be your friend, be your friend." What kind of friend?,Which kind friend? "You know that there is uh... there is a... a saying which goes ""a hungry man is an angry man.""","You know sey e dey, eh e get one, one eh talk wey dem talk sey eh a hungry man is an angry man." Okay!,Okay! Maybe Buhari doesn't want to pay their salaries now.,"Maybe Buhari no wan pay deir, deir salary now." "If they stand in the road, their eyes are red and you just provoke them, they will take what they want to, slap you, break your car.","If dem stand for road, deir eyes red, and you just provoke dem, dem go carry wetin de wan to, slap you, break your motor." "Aha, that's it.",Aha na im. People won't just stand on the road and be doing all those things without anything to feed on and everything now!,"Person no go just stand for road dey do all dose things, and dem no go get wetin to dey chop, and everything now!" It's no good now!,E no good now! Okay it's... it's... it's... it's now you are beginning to... to improve and say what I want to hear.,"Okay now na, na, na, na now you tanda dey talk, to talk better wey I wan hear." Aha!,Aha! "No, no, no!","No, no, no!" Even...,Even... It's not what you were saying before.,No be di one wey you dey talk since o. "What you're saying now, that's better.","Di one wey you don dey talk now, na im be di better." It's going... it's... it's going in the direction of what I'm saying.,"E don dey flow, e don dey, e don dey flow for di place wey I dey yarn." "Even uh... uh... uh... uh... uh... teachers, they won't pay them.","Even for eh eh eh eh eh teachers, dem no go wan pay." "If anybody wants to respect any profession anywhere at all, it's teachers they are supposed to... as in just give, as in uh... Gbosa, as in more than a hundred Gbosa.","If anybody, dem wan respect, any profession for any, anywhere, na teachers de suppose to as in just give as in hm gbosa, as in more than hundred gbosa." Hm.,Hm. They're the ones they're supposed to rate more.,Na dem be suppose dey rate pass. Okay.,Okay. They're supposed to respect them more now.,De suppose to respect dem pass now. "Okay, me I become a doctor, you, you become a lawyer, this person becomes an engineer, who is the person who trained us?","Okay me, I become doctor, you, you become lawyer, dis person become engineer, who be di person wey train us?" Okay!,Okay! Hm!,Hm! Is it not a teacher?,No be teacher? "They're the ones they're supposed to pay more now, but you'll go to schools, teachers will be earning uh... even less than the money they give uh... youth corpers.","Na dem de suppose to pay pass now, but you go go schools, teachers go dey get eh even less dan di money wey de even dey give eh youth corpers." Why now?,For why now? Come on!,Haba! "It's no good, it's no good.","E no good, e no good." "Eh, babe!",Eh babe! They are supposed to res-... respect these teachers.,Dem suppose to res-... respect dis teachers. "Babe, let me...","Babe, make I..." "If they can't respect teachers, you should give them a better salary, give them a better house.","If dem no fit respect teachers, you give dem a better salary, you give dem better house." Will they give it to police or any other workers?,"Na police, or any oda workers de go dey give?" Hm!,Hm! I don't know why Nigerians don't just want to change!,I no know why Nigerians no wan just change o! You know that Nigeria...,You know sey Naija... "And they'll be saying ""change begins with you and me.""","And dem go dey talk sey change begins wit, begins with you, and me." Where?,For where? They say charity begins at home.,Dem say charity begins for house. What kind of charity?,Which kind charity? X forget all those things!,X forget all dose things o! "Me, I've started my charity!","Me, I don start my charity o!" My charity has begun at home since I was born.,My charity don begin for house since wey dem born me. "I'm doing my charity work, I'm doing it.","I dey do my charity work, I dey do am." "If it means giving peo-... people uh... this thing... if it means respecting people, I'm doing my charity work.","If na to give pe-... people eh dis thing, if na to respect people, I dey do my charity work." "But, let Buhari do his own charity and he'll change for us.","But make Buhari do im charity, and im change for our own body!" "Let the Governor and all of them do our charity work in our life now, please!","Make di governor, and all of dem do our charity work for our life now abeg!" Leave that thing!,Leave dat thing! That... that... that... that change that they are talking about is not for everybody.,"Dat, dat, dat, dat change wey dem dey talk, no be for everybody o!" The change they're talking about now is that everything is increasing.,Di change wey de dey talk now be sey everything don dey increase. That change...,Dat change... Hm.,Hm. The thing is that salaries are going down and what we're buying is increasing.,"Di thing be sey salary don dey decrease, and di thing wey we come dey buy con dey increase." Okay.,Okay. Increasing!,Increase! Nothing is difficult for her.,Nothing wey dey hard for her. I dunno.,I no know. Haha!,Haha! I'm just tired.,I just tire o. "You know that I've been laughing when people talk about this change, change, change in things.","You know sey I be dey laugh when people dey talk about di change, change, change of a thing." I was telling my mom that...,I be dey tell my mile sey... "My father kept saying ""ah! This change is for real, Jonathan...""","My pupsy den con dey dey yarn sey, ah sey ah dis change na for real o, sey Jonathan..." That was one of the first changes that happened.,Dat one na di first change wey happen. "They want Jonathan to step down, they are tired of Jonathan, Jonathan is a corrupt man.","Dem wan make Jonathan comot, sey de don tire for Jonathan, sey Jonathan na corruption man." I told them no!,I tell dem sey no! They did not ask.,De no come ask. "When they were talking about the change, they did not ask ""what kind of change?""","When de dey talk about di change, de no ask sey which kind of change?" "You know, change has a positive side.","You know, change get positive one." "There is good change, and there is useless change.","E get better change, e get yeye change." Not all change is good.,No be every change be better change o! That was how they said they wanted change.,Naim de con dey say de wan change. I said okay!,I say ah! I was just looking at them.,I just dey look dem. "I said, you should all go.",I say oya moh una go now! "Today, here they are!",Na today de dey. They're the ones complaining.,Na dem dey follow dey complain. "My old... my old... my mom, she just cries everyday.","My, my old, my mile eh, e just dey cry everyday." I laughed at her.,I dey laugh am. "My brother, please let us just relax!","My brother, abeg make we just relax!" I said they should go and sit down!,I say make dem go sit down! "That is a Nigerian issue, please!",Na Naija matter be dat abeg. It's God... it's God... it's God... it's God who will take control.,"Na God, na God, na God, na God go take control." "Uh, Nigerian matters.",Eh Naija matters. That's... that's what we've been talking about.,"Na wetin, na wetin we don dey talk since." God will take control.,God go take control. "It won't get finished, will it?",E no go finish ehn? "My name is Dondeli Obi, and uh... I am from Onitsha Ukwuani in Ndokwa West Local Government Area of Delta State, here in Nigeria.","My name na Dondeli Obi, and eh I come from Onitsha Ukwuani for Ndokwa West Local Government Area of Delta State here for Nigeria." "I had my primary education in Aido Primary School, Onitsha Ukwuani, before I moved on to have my secondary school education in Mixed Secondary School, Onitsha Ukwuani.","I bin go primary school for Aido Primary School, Onitsha Ukwuani before I con go secondary school for Mixed Secondary School, Onitsha Ukwuani." "When I finished with secondary school, I moved on to the Federal Polytechnic Auchi to study Electrical Electronics Engineering.","When I finish from secondary school, I con go Federal Polytechnic Auchi, go study electrical, electronics engineering." "But now, I'm working with uh... Wazobia FM in Abuja.","But now, I dey work wit ehm Wazobia FM for Abuja." We speak uh... Pidgin on our radio programmes in the station.,We dey use ehm Pidgin dey do radio work for di station. "And uh... though I chose to study Engineering in school, people will be asking, ""ah, why are you in a radio house, or in broadcasting?""","And ehm even dough sey na engineering me I choose to do for school, people go dey ask sey ah wetin you dey find for radio house, or broadcasting?" "But uh... it's a question of talent, and your abilities are different from your training.","But ehm di tin be sey na talent, and wetin you sabi, no be wetin you learn." So I love to do uh... broadcasting.,So I love to do eh broadcasting. "It has nothing to do with what I studied in school or what I'm studying at the moment, but it's what I like to do; what I'm talented in.","No be because sey na wetin I study for school, or wetin I dey study, but na because na wetin I like to do, na wetin I get talent for to do." That’s what makes me do it.,Na im make me dey do am. And I love the job with all my heart.,And I love di job as in wit all my heart. I love the job.,I love di job. I'm happy that I'm doing this job.,I dey dey happy sey I dey do di work. "In fact, when I'm going to work, I don’t prepare as if I'm going to work.","In fact, if I dey go work, I no dey prepare from house comot say I dey go work." I prepare as if I want to go and enjoy myself.,I dey prepare comot say I wan go enjoy mysef. "Like I want to go and play because I see the job as a part of me, it flows from inside me.","I wan go play because I see di work as na part of me, na sometin wey dey inside me." "I don’t struggle to do it, it's really very easy for me to do.","I no dey struggle to do am, dey very easy for me to do." "So... but I still hope to further my education because uh... I feel that you have so many things to do in life, and uh... I still believe that education will help me a lot.","So but I still dey aspire sey I go continue again wit my education because ehm I feel sey so many tins dey to do wit life, and eh I still believe sey education go help me well." "But anyways, I didn't learn the Pidgin English I speak from anywhere in particular.","But anyway di Pidgin wey I dey speak, I no go learn am for anywhere." I don't... I didn’t go to any particular place for the purpose of being taught Pidgin English.,"I no, e no get any particular place wey I go say okay make dem teach me Pidgin." "I learned Pidgin English from people around me, from my day to day activities... the things I do everyday, I picked it from the way people I mix with speak it.","I learn Pidgin from people wey dey around me, from my day to day activities, tins wey I dey do everyday, people wey I dey mix up with, di way dem dey talk." I don't have any choice but to go along with them so I can also communicate with them.,I no get any choice dan to flow join dem so dat me sef go fit dey communicate with dem. "So I learned Pidgin English and found out that naturally, in Delta State, the South-South area of Nigeria, Pidgin English is one of the languages everybody speaks.","So I learn di Pidgin, and I find out sey naturally, for Delta State, di South, South area of Nigeria, Pidgin na one of di languages wey everybody dey take talk." "If you want to know the general language which everybody understands in the whole South-South area, it is Pidgin English.","If you wan know general language wey everybody sabi for di whole South South, na Pidgin English language so." It was easy for me to learn it when I was there because that’s the language everybody speaks.,E dey easy for me to learn am when I dey dere because na di language wey everybody dey speak. It's generally accepted.,Dey generally accepted. So I didn’t go to any Pidgin school.,So I no go any school of Pidgin. "Nobody called or sat me down saying uh... ""this is the classroom.""",Nobody call me sit down sey eh dis na classroom. """Now sit down, let me teach you how to speak Pidgin!""","Oya sidown, make I teach you how de dey speak Pidgin!" "But today, I speak Pidgin more than any other language, even my own language.","But today, I dey speak Pidgin pass any other language, even my own language." "I speak Pidgin more, more than I speak that language.",I speak Pidgin more pass di language. "So Pidgin is not something you will to learn in schools, or something like that.","So Pidgin, no be sometin wey you go go school go learn, or sometin." It's ingrained.,Na inbuilt. "As soon as you were born and you are growing up, mixing with people, it comes to you naturally.","As dem born you, you dey grow up dey mix up with people, e dey natural wit you." "And uh... as a yound man, I s-... I know that I have so many opportunities waiting for me and I have uh... many ambitions for my career, and also for my country.","And ehm as a young man, I s-... I know sey I get plenty opportunities wey dey wait for me for front, and I get eh plenty ambitions for my career, and also for my country." "You know, working as a broadcast journalist, which I do now, I have seen sa-... I've... it's exposed me to so many things.","You know walking as a broadcast journalist wey I dey do now, I don see sa-... I don, e don expose me to see so many tins." And I see things from different angles now.,And I dey see tins from different angle now. "Both the way things happen in our society, or politics, and every other part of life in our country.","Both di way tins dey happen for our society, or politics, and every oder part of life for our country." "And myself, I know that I can also do my part to make society and our country a better place.","And me I get dat mind say I fit also contribute my own to make di society, and our country make e for better." I'm planning to go into politics as well.,I get mind say I go join politics. "I'll go into politics soon because I found out that if I have the plans, the ambitions, and uh... the opportunity doesn’t come, I won't be able to play my part.","I go do politics soon because I find out sey if I get di plans, di ambitions, and eh di opportunity no come, I no go fit contribute my own quota." "So I feel that if I go into politics, by God's grace, I will be able to play my part to bring development to our country, Nigeria, because the way things are in Nigeria, truth be told... let's be honest, things are not working.","So I feel sey if I join politics, by God's grace, I go fit contribute my own to bring development for our country, Nigeria because di way tins dey for Nigeria now, (truth be told, make we talk di truth) tins no dey work." And why things are not working is what we're trying to find out so we can figure out the best solution to solve everything that’s not working in Nigeria.,"And di reason why tins no dey work, na im we dey try to find out so dat we go fit know di best solution to everytin wey no dey work for Nigeria." "So for me, as a young man who's just coming up, I'm watching things play out, how things are happening in our country, how our current leaders are getting things done.","So for me, as young man wey dey come up, I dey watch event of tins, how tins dey happen for our country, how our leaders wey dey now dey do tins." "I'm making efforts to find out, to know how they're getting things done, noting their mistakes, what they... the things they're supposed to do which they're not doing, the things they're not supposed to do which they are doing.","I dey find out, dey know how dem take dey do deir tins, dey know deir mistakes, what dem, di tins wey de suppose do, wey de no dey do, di tins wey de no suppose do wey dem dey do." "I'm watching everything going on, and I'm also following up with the things which they are planning to do.","I dey watch everytin wey dey go on, and I also dey follow up wit di tins wey dem dey plan to do." "So for me, I'll have an advantage over the current leaders because I don’t believe that the current leaders got into politics early enough.","So for me, I go get more advantage dan di leaders wey dey now because I no believe sey di leaders wey dey now, dem start dis politics tin early." "This leadership uh... thing, then at... I'm not sure they started early.","Dis leadership eh tin den, at, I no sure sey dem start am early." "If they had started earlier, they would have sat down to study what past leaders did.","If to say dem start am early, de for don sidown, look wetin before leaders do." They would have avoided their mistakes.,"Di mistakes wey dem do as dem come, dem go fit avoid am." But what we have in Nigeria today is that this leadership will come and they will lead Nigeria.,"But wetin we get for Nigeria today, na sey dis leadership go come, de go lead Nigeria." "When their time is up, they will leave.",When deir time finish dem go comot. "The next one will come, they will carry on from where the last one stopped.","Di next one go come, de go carry Nigeria from where di oder person stop." They will carry on from there.,De go carry am from dere. "But the same mistakes that the b-... b-... other leaders made while in power, is what the new ones will also make when they come in.","But di same mistake wey di b-... b-... oder leaders dem do when dem dey, di new ones go come in, dem go still dey make di same mistake." "So that means that when the other leaders were... when they were not yet in power, they were not watching how the leaders of the day were running their own government.","So, dat means when di oder leaders dey, when de never dey power, de no dey watch how di oder leaders take dey do deir own leadership." They don’t take note of all the mistakes they were making.,De no dey take note of all di mistake wey dem dey make. "And they don’t even have plans, no agenda stating that when I come into office, here are the things I will do.","And de no dey even get plan, no agenda sey if I come office, na wetin I go do be dis." "Now when they have finally come into power, that’s when they will sit down to think about what they will do.","Now, when de don finally enter power, na dat time de go come sidown begin dey tink wetin dem go do." "And if you walk a-... take a look at it closely, it will look like mtschew, they are... they're confused.","And if you walk a-... look am, e go be like sey mtschew dem be, dem dey confuse." They don’t know what to do.,De no know wetin to do. Why?,Why? "Because before they got into power, they did not have plans.","Because before de enter power, dem be no get plan." They got into power and then start looking for plans.,"De enter power, come dey find plan." "So they will be there, looking for plans.",So dem go dey dere dey find plan. "By the time they've found a plan, their time is up.","By di time dem go find plan finish, deir time don finish." Another person will come in.,Anoder person go enter again. "The person coming in will also start looking for plans, he will begin working on the mistakes the other person had made, he will continue making the same mistakes.","Di person wey go enter again go begin find plan, e go begin dey work on di mistakes wey di oder people don make, e go continue to make di same mistakes." Then uh... their term will come to an end and another person will come in.,"Den eh dat one go finish, anoder person go come." So now we need people who are knowledgeable; people who are exposed; people who know history.,"So wetin we need now na people wey sabi, people wey dey exposed, people wey know about tins wey don happen before." "Both the things which have happened and the solution they have prepared, telling Nigerians that, ""this is our problem"".","Both tins wey dey happen now, and den, dem go get solution, tell Nigerians sey na dis tin be our problem." """This particular thing is our problem.""",Na dis tin be our problem. "This is what we'll do to solve this problem in our country, Nigeria, so that Nigeria will move forward, beyond where it is right now.",Na dis tin we go do make dis problem stop for our Nigeria so dat Nigeria go move forward pass as e dey now. "So for me, right, that ambition is alive and uh... with God, I believe that it will come true.","So for me, eh dat ambition, e dey alive, and eh wit God I believe sey e go come true." My name is Jacob from Kaduna.,My name na Jacob from Kaduna. "When I grew up with my grandfather, he was the one taking care of me.","When I grow up wit my grandfader, na im dey take care of me." My parents are in Lagos.,My parents dey for Lagos. That's where I stayed.,Na dere I dey stay. They brought me to Kagoro.,De carry me come Kagoro. And I grew up there.,"And I was dere, grow up." He enrolled me in a secondary school... he enrolled me in a primary school.,"Im put me for secondary school, im put me for primary school." All the schools.,All di schools. And I was very happy with him.,And I was very happy with im. So much that he supports me in everything I do.,"Wey, everyting wey I dey do na im dey do am for me." "And when he... when I grew up, when I was about to get married, he was... he announced the name of a woman I don't know as my wife to be.","And when e, when I grow up, when I about to marry, e was, e pronounce a wife for me, which I don't know." "And at the time put forth by God, the wife came, as foretold by my grandfather.",And di time reach wey be sey (God don say dis di time wey my grandfader talk am) di wife came. And the way I got married at that time is not the... same as they do nowadays.,"And di way I marry dat time, no be di so de, de dey do nowadays." "Now, they give so much money.","Now, na plenty, plenty money de dey give." "At that time, myself, I gave a bride price of two thousand naira.","Dat time, me, na two thousand naira I give as bride price." "In fact, they collected it saying they will... were very happy.","Even de collect am say de go, were very happy." "But nowadays, if you don't bring a goat, twenty bags of uh... cement, uh... twenty bags of uh... salt, rice, everything!","But now, if you no bring goat, twenty bags of eh cement, eh twenty bags of eh salt, rice, everyting!" "Even with a donkey, they'll say to bring one.",Wit donkey sef de say de may bring! With a duck!,Wit duck! Look how the world is!,See how di world be! Is that how things will go on?,Na so we go carry everyting go? How will the next gene... generation be?,How di gene-... generation go be? Maybe they will be asked to build houses for their parents.,Maybe de go say meh de build house for dem parents. "We pray for God to help us in this generation, for things to get better.","We pray dat God will help us in dis generation, dat tings will come better." "And nowadays, even the women, maybe the men are not the ones looking for them.","And nowadays, even women now, maybe no be men dey go look for dem." "Women are the ones looking for wom-... mow-... men, nowadays.",Na women de go look for wom-... mow-... man now. They want to get married by force.,De wan marry by force. "I pray that God will help us look within ourselves so we'll see better things in life; for God to continue to be with us, and guide us.","I pray dat God will help us, for us to search oursef to see better ting in life, for God to continue to be wit us, and guide us." And another thing is women don't compose themselves... they don't compose themselves.,"And anoder ting again, women don't compose deirsef, de didn't compose deirsef." They don't compose themselves at all.,De don't compose deirsef at all. "If they compose themselves, dress well, look very beautiful, from there, men...","If de compose deirsef, dress fine, look very fine, na dere men..." "When we come back and see them, and say we want to marry them.","When we go come back, and see dem, and say de wan marry dem." But we have different traditions.,But we have different tradition. "The Southerners have their traditions, as do the Northerners and the Middle Belters.","Di South have deir own tradition, di North have deir own tradition, di Middle Belt has deir own tradition." "Some are, are, are conservative about it.","Some, dey, dey, dey do am small, small." Some spend a lot of money on it.,Some dey do am wit plenty money. So we don't know how we will bring things together.,So we don't know how we go bring tings togeder. "Maybe God will help us reverse all these things, so we will come together as a family, as Nigerians, to help one another do things as God will help us, that we will be uh... very happy with it.","Maybe sey God go help us to reverse all dese tings dat we will come togeder as one family, as Nigerians, to help one anoder to do tings di way God will help us dat we will be eh very happy wit it." That's the way it is.,Na so we see am o. "But uh... the question I want to ask is, ""how will Nigerians come together?""",But ah di question wey I wan ask be sey how will Nigeria come togeder? "Such that we'll have a common bride price, that we (will) become one, that we...","Wey be sey we go do, put dis bride price togeder dat we become one, dat we..." "In some places, parents won't be burdened while in some other places, they will be burdened.","Anoder place, parent will not suffer am, anoder place, go suffer am." "In a lot of places, if you don't bring a lot of things, they won't give her to you.","Some many places, if you no carry plenty tings come, de no go give you." They will say you should build a house for them.,De go say make you build house for dem. "In some, some pla-... places again, they will say, ""just take her!""","Some, some pla-... place again, de go say just carry go!" They give her to you.,De don give you. "So how can we bring this thing together, and help ourselves?","So, how can we bring dis ting togeder, and help oursef in life?" Oh!,Oh! We thank God that in His infinite mercy He will help us... will really help us.,"We tank God dat God in infinite mercy go help us, go help us well, well." "He knows that these things will get better, and change us in Nigeria.","E see sey dese tings go become better ting in life, and change us in Nigeria." And we pray that God will hel-... give us good people who will listen to us.,And we pray dat God will hel-... give us better people wey go hear us. "And they will hear about all these things, so that they will come together and make sure we have good things in Nigeria.","And all dese tings, de will hear dem for dem to come togeder, and see sey we do better ting for Nigeria." Thanks be to God!,Tank God! "And in many of the places we see now, in our hospitals, a lot of people are sick.","And many places wey we dey see now, our hospital, many people are sick." "Sometimes, there are no drugs.","Sometimes, no medicine." They will still be there.,De go dey dere o. Problems.,Wahala. Problems.,Wahala. No one will be able to go to the hospitals again because there's no money.,"Nobody go, fit go hospital again because no money." "By money, I mean that some can afford food, some cannot.","Money be sey some fit eat, some no fit eat." Some can afford to pay hospital bills while some cannot pay hospital bills.,"Some fit pay hospital bill, some no fit pay hospital bill." How can we resolve these things in this country?,How can we resolve dis in dis country? We pray our God will help us... pray that God will help us.,"We pray our God will help us, pray dat God will help us." "And our leaders, they should make sure that they help the poor ones do things that will help us in life.","And our leaders, meh de kuku see sey de help di poor one to do tings dat will help us in life." Our doctors are going on strike again.,"Our doctors again, de dey go strike." People are dying.,People dey die. So where are we heading?,So where are we heading oursef to? Where are we heading?,How are we heading oursef to? "Doctors as well, have mercy on us.",Doctors too have mercy upon us. "And also the government, they should make sure that the doctors are paid.","And di government too, de should see sey de pay di doctors." "They should come... they should help the poor, they should reduce the high cost of drugs for our sake.","Meh de come, make de help di poor, make de reduce medicine money for us." "For those of us who can't pay so much money, they should please help us... they should please help us... they should please help us.","We dat can not pay plenty money, abeg meh de help us, meh de help us o, meh de help us." And we will move on to schools as well.,And we will go to school again. "With schools, if you are not rich, you will not have access to quality education.","School, if you no get money, you no go get better school." "The primary level, if you are not rich, some people cannot even even afford pay five hundred naira.","Primary, if you no get better money, even five hundred naira, some people no fit pay." "Some parents can't afford to pay five hundred naira, not to mention two hundred naira.",Some parent no fit pay five hundred naira talk less of two hundred naira! We pray that God will help us because we are looking to God to provide everything we say... we are praying for.,"We pray God will help us because everything wey we say, we dey pray for, na God we dey look for." "And when God touches their, their hearts, they will look to the poor.","And when God touch deir, deir heart, de go look unto di poor." We pray for God to help us.,We pray God will help us. "Even the way we eat, money for food, money, money, you can't even afford to buy a bit of rice.","Even di way we eat, food money money, money, you can not even buy a mudu of rice." They will tell you that a measure of rice costs six hundred naira.,De go tell you sey mudu of rice na six hundred naira. What work will a guy do to make six hundred naira for a measure of rice?,Which work man go go do get six hundred naira go buy mudu of rice? Not to mention the other stuff you put in.,You no talk of di ting wey you go put inside. "You will buy Maggi seasoning, pepper, and tomatoes.","You go buy maggi o, buy tattasai o, buy tomato o." "Onions, how much will you pay?","Onion, how much you go pay?" How much will you make?,How much you go get? "You have many children, twelve children, six children, seven children, on your small measure of rice, one measure will not be enough for them.","You get plenty children, twelve children, six children, seven children, your mudu of rice, one no go fit do dem." "And even if you worked, payments won't be made.","And if you work sef, no payment." So many of the people who have quit work are dying.,"Plenty, plenty people wey don resign, de die." No payments.,No payment. Salaries are not being paid.,"Salary, de no pay." "Everywhere, etin-... everything is hard.","Everywhere, etin-... everyting hook." "So, what do they want us to do?","So, what do de want us to do?" And many of the things which have been happening is because ritual activities have taken over the country.,And many tings wen de bin come be sey rituals don enter country. Cases of kidnapping are everywhere for the purpose of making money.,Kidnapping everywhere because of money. "A government is paying all these things X for, for the staff, giving them everything.","It is a government dey pay all dese tings X, for, for di staff, give dem everyting." "At least, everything for the better.","At least, everyting for better." "They caught someone there, caught someone there, shot everybody, killed everybody.","De catch person dere, catch persons dere, shoot everybody, kill everybody." "So, where are we going... where are we going... where are we going?","Toh, where are we going, where are we going, where are we going?" "The military men who says they are... they are the ones guiding us, they are killing them.","Soldier man wey de say de dey, na dem dey guide us, de dey kill dem." "So, we don't love one another.","Toh, we no love one anoder." "There are problems, problems, problems everytime.","Everytime wahala, wahala, wahala!" Where do you want us to run to?,Where una wan us run to? Should we leave Nigeria for you?,Make una leave Nigeria for una? Or should we leave Nigeria for the people doing these things?,"Abi dose wey dey carry dis ting do, make we leave Nigeria for una?" "If we leave Nigeria for you, how many people will stay behind?","If we leave Nigeria for una, how many people will stay?" "Eyinaya Family, will you be able to stay in Nigeria?","Eyinaya Family, will you be able to stay in Nigeria?" Just you?,You alone? It can't be possible.,E can not be possible. "God, help us so that our soldiers will also help us.","God, help us dat even our soldiers will help us." Take a look at the rains!,See rain! Drain everywhere!,Drain everywhere! "Floods wash away people's belongings, floods are taking people's lives.","Water dey carry people load, water dey kill people." "No good roads, no standard drainages.","No better road, no better drainage." "Everything, problems.","Everyting, wahala." "God, help us... God, help us!","God, help us, God, help us!" Let our X leaders listen to us!,"Let our X, leaders hear us o!" Let them hear God's voice and do the... what they were assigned to do.,"Make de hear God voice o, and do di, dat ting wey dey carry dem dere." They warned them to be good.,De warn dem make de do better ting. "Not, not that they should, should take care of themselves alone and leave the poor to die.","No be, no be sey make, make de chop alone, leave di poor, and make de die." "If the poor die, who will they govern?","If di poor die, who de go govern?" No one!,Nobody! "We pray that God will help them to see these things, and also help us.","We pray dat God will help dem to see dis tings, and help us." "As funny as it may sound and as much as I might be joking, this is a serious issue.","As funny as it may sound and as joking as I might be, na so serious di matter dey o." I know that I'm coming from a very humble background.,I know sey I dey come from very humble background. "My daddy is a reverend, my mommy is a pastor.","Daddy na reverend, mumsie na pastor." "Then, at the same time, the man was a medical psychologist, and then my mom was a linguist.","Den, at di same time, di man na medical psychologist, den mumsy na linguist." "Mstchew... when poverty started affecting with us in the house, I told them, ""see, this can't work!""","Mtschew when poverty start to dance reggae for inside our house, I tell dem sey see dis thing no go work o!" "See, I will go in the opposite direction.",See I go go di oda way round. I made up my mind.,I make up my mind. I told them that I wouldn't go for any engineering course in any school.,I tell dem sey I no dey go do any engineering for any school. "They said, ""why?""",De say why? I said I wanted to be a pilot.,I say I wan be pilot. "They said, ""why?""",De say why? "I said apart from the fact that any career at all is a career, career... the essence of a career is to make money.","I say outside di fact sey career na career, career, number one thing for career na to make money." Calling... that is what we are doing.,"Calling, na dat one wey we dey do." "That this one, this what God gave us.","Sey dis one, na im God give us." "My career is being a pilot, my calling is to help people succeed in what I'm into.","My career, na piloting, my calling, na to help people succeed dis one wey I dey do." Whether the calling gives me money or not doesn't concern me.,Weda di calling give me money or not e no dey pain me. "But you see, that career, piloting, you wouldn't ask me to fly a plane free of charge.","But you see dat career piloting, you no go tell me make I come fly plane for you for free now." Do you know how much I paid to study in school?,You know how much I pay go di school? "Even now, while I'm still schooling, if you happen to be aboard a plane I fly, it'll end in disaster just like the Sosoliso airplane.","While I still dey di school now self, if I fly you now self, sosoliso go be testimony." You know!,You know! "But so what I now do is, we have set up a standard organization we call the Billionaire's Code.","But so wetin I dey do now be sey, we don set up one better organisation, we dey call am di billionaire's code." "On the Billionaire's Code, we bring a lot of opportunities which can help you make at least five percent interest on your investment every Friday for the next fifty two weeks.","For di billionaire's code now, we bring a lot of opportunities wey be sey e fit help you dey make at least five percent on your investment every Friday for di next fifty two weeks." Meaning that on anything which you invest...,Meaning sey anyting wey you invest... "Okay, let me talk money.",Okay meh I call money name. Let's say you invest one hundred and thirty seven thousand naira... I won't tell you the name of the company.,"Let us say you invest one hundred and thirty seven thousand naira, I no go tell you di name of di company." "That's why I want you to come to the seminar because Nigerians, you are too smart.","Na im make I wan make you come di seminar because Nigerian, una too dey smart." "As soon as I tell you the name, you would go and Google it, you won't get any information.","As I tell you di name, you go run go google am, you no go see any information." "I have seen it, I have seen it.","I have seen it, I have seen it." Stop that!,Stop dat ting! Learn to go to the school of money.,Learn to go to di school of money. Stop surfing the internet.,Stop surfing di Internet! What they upload on the internet is the review.,Wetin de put for Internet na review. They don’t upload the complete version.,De no dey put di original ting dere. "Go, and find out what it's all about.","Go, and know what is all about." So that's why you need to attend a seminar.,So dat's why you must come to a seminar. Don’t invest in something you don’t understand.,No invest inside someting wey you no understand. It gives you five percent.,E dey pay you five percent. So if... if you invest one hundred and thirty seven thousand.,"So sey, sey you invest one hundred and thirty seven thousand." Take away five percent of one hundred and thirty seven thousand.,Chop five percent of one hundred and thirty seven thousand. "That way, you can be making around seven thousand to eight thousand naira every Friday.",Like dat one fit dey run around seven thousand to eight thousand naira every Friday. And they pay you in Euros.,And de dey pay you in euros. "You can withdraw it through uh... cryptocurrency, you can withdraw through OK Pay... you can withdraw it through uh... your direct domiciliary account.","You fit withdraw am through ehm cryptocurrency, you fit withdraw through OK Pay, you fit withdraw am through eh your direct domiciliary account." "If you check the five percent of one thirty seven thousand naira for fifty two weeks, that’s like tripling your money.","If you check five percent on one thirty seven thousand for fifty two weeks, dat na like doubling your money by three times." You understand?,You understand? And what does this company deal in?,And wetin dis company dey deal on? "They deal in real estate, bank liabilities, debentures, IPOs.","De dey deal on real estate, bank liabilities, debentures, IPOs." Do you understand?,You understand? "So, the reason why we brought in this opportunity is that we want to discourage Nigerians from Ponzi Schemes.","So, why we bring dis opportunity be sey we wan carry Nigeria comot from Ponzi Scheme." What is a Ponzi Scheme?,Wetin be Ponzi Scheme? "A Ponzi Scheme is when you invest one naira and by next week, you get paid twenty naira.","Ponzi Scheme na you put one naira, by next week, you dey collect twenty naira." Who did you work for?,Who you work for? How did the money multiply?,How di money take grow? "Then, you don’t know that that system relies on people in order to grow.","Den, you no know sey dat system dey rely on people for am to grow." They didn’t create the money from nowhere.,De no create di money anywhere. "If they get money, it would crash.","If de get money, e go crash." Some of them don’t even last for two weeks now.,Some of dem no dey even last two weeks now. "Now, why do you need those kinds of opportunities so that if you invest something, you would say okay?","Now, why you need dose kind of opportunity so dat if you invest something, you go say okay?" "Uhuh, this particular money which I invested now, is for my family's upkeep.","Ehen dis particular money wey I invest now, na for my family feeding." I don’t get to run around.,I no get to dey run around. This one brings in five percent every Friday.,Sey okay dis one dey bring five percent every Friday. "Every Monday, they can withdraw it... they can...","Every Monday, dey fit withdraw am dey fit." "Then, you will know that the next batch of money which is on the way, there is another investment but I will not mention its name on air.","Den you go know sey di next money wey e dey come, e got anoda investment now wey I no go call di name for radio." But this investment is a huge one which can pay you up to twenty thousand dollars on an investment as low as one thousand dollars in the next seven to eight months when it will be fully launched all over the whole world.,But dis investment na huge investment wey be sey e fit pay you up to twenty thousand dollars with di little investment as low as one thousand dollars in di next seven months to eight months wen de go launch fully for di whole world. Another one... you will learn more about it.,"Anoder one, you go find out about am." The third most important thing (outside all these investments I'm talking about)... I am into what they call financial and business mentorship.,"Di number three most important thing (outside all dese investment wey I dey talk about), I dey run wetin de dey call financial, and business mentorship." I will teach you how to run a business.,I go teach una how to position business. You don’t need to open a shop to start a business.,You no need to open shop to open business o. You can work from your living room or your bedroom.,"You just need to dey inside your parlour, inside your bedroom open business." Let me give you an example.,Mah I give una instance. "When we were growing up, we knew all those kinds of people which they call uh... ma-firewood (meaning that they sell firewood), uh... ma-akara (meaning that they fry akara), uh... mama tailor (meaning that the woman is a tailor).","When we dey grow up, we know of all dose kind wey de dey call ehn ma-firewood (mean sey de dey sell firewood), ehn ma-akara (mean sey de dey fry akara), ehn mama tailor (mean sey di woman na tailor)." "As soon as Shell and NNPC started opening up in Nigeria, all those people dumped their machines in a room, packed their firewood to the side, and they went in search of white collar jobs.","As soon as all dose Shell and NNPC start to enter Nigeria, all dose people carry deir machine put inside packing room, carry deir firewood put di oda side, go find white collar job." "So they’ve gone back to basics, brought it out, cleaned it.","Oya now, now de don go middle of ocean, go bring am out, clean am." Let's start from where we left off.,Mey we start from where we stop. Do you understand?,You understand? "When you go to some countries like... (I don’t want to mention names so you don’t think I'm comparing Nigeria to other countries), you would discover that...","When you go some countries like (I no wan call names meh you no come tink sey I dey compare Nigeria to oda countries), you go discover sey..." "In fact, let me mention one, China.","Infact, mah I call one name, China." You go to China.,You enter China. How did China work out their own revolution?,How China take cause deir own revolution? "They locked their borders for almost twelve, or ten years.","De lock deir borders for almost twelve, or ten years." No one travelled.,Nobody travel. "They picked people and said ""You, travel, go learn and come back.""",Na dem pick people say you travel go learn come back! There are things that you...,E get things wey you... "In fact, the Facebook we use here, you know that China doesn't use it.","Infact, Facebook wey we dey use, you know sey China no dey use am." China didn’t allow it.,China no gree. "They said they must use their own app, that the Westerners should develop apps for their own use, and Africans too.","De say de must use deir own app, sey make Oyinbo dem do deir own app for demself, and Africa." "You cannot be here and get across to someone in China, for instance on Facebook.",You no fit dey here and get person wey dey China say if you dey Facebook. It's not possible.,E no possible. That is how developed they are.,Na so de don develop reach. "Look at this guy now (uh... what is his name?), the one who owns Alibaba dot com, that guy is the one who made online marketing popular.","See dis guy now (eh wetin be im name) wey get Alibaba dot com, dat guy, na im make online market go popular." "Because these guys, they think outside the box.","Because dese guys, dem look widin." "If you go to China, on the whole street, what will every family be selling?","You go go China, one full street, every family wetin de sell?" "It's light, light, light, light, light, light, and it's consistency.","Na light, light, light, light, light, light, and na consistency." "You would go to another street, even these uh... crypto, crypto which they are talking about, China made it popular.","You go anoda street, even dese eh crypto, crypto wey de dey talk, na China make am popular." Hm... they are the ones who started doing it.,Hm na dem start to dey do am. Almost everything.,Almost everything. "Then, come to Nigeria.",Den you come Nigeria. Where is the China of Nigeria?,Where is di China of Nigeria? Haba!,Haba! "They even produce their own things, and tag it 'Made in Turkey'.","De go even produce deir own things, still put on top made in Turkey." What's your problem?,Wetin dey worry you? "Is it an inferiority complex, or what?","Na inferiority complex be dat, or wetin?" "So what I've been trying to say in essence is that this Sunday, eleventh of June, two thousand and seventeen, by two p.m., as soon as we finish church, don’t go for the second service!","So wetin I bin try talk in essence be sey, dis Sunday, eleventh of June, two thousand and seventeen, by two p.m. gbangain, as we dey close from church, no enter second service o!" "Take an excuse this Saturday, which is today, with your two legs, walk in through the Stadium Road.","Take excuse dis Saturday wey be today, carry your two leg waka Byfollow, enter Stadium Road." "As soon as you get to the Airforce Junction, stop at Aztech Event Hall.","As you stop for Airforce Junction, tell dem sey drop me for Aztech Event Hall!" "Beside Aztech, you will see a hotel which has a big name, Swiss and Spirit... Swiss Spirit Hotel.","By Aztech, you go see one hotel wey get big name, Swiss and Spirit, Swiss Spirit Hotel." "Just walk inside, into the hall.",Just enter inside come di hall. This seat is waiting for you there.,Dis seat dey wait for you dere. "Normally, you know that my seminar goes for twenty five or twenty thousand naira, but for Porico's sake, they have really criticized me, saying that I don’t want to help people with the returns I make; that's why I've made the seminar... the last four seminars of... this last one which I do, free.","Normally, you know sey my seminar na twenty five, twenty thousand naira, but because of Porico dey don too criticise me say I no dey wan help people with di ones wey I don make, na I come make di seminar free for di last four seminars of dis last one wey I don do." "Last week's was free, this one is free.","Last week own na free, dis one na free." "There are still... there are still two or three more, then we'll go back to charging fees.","Remain, remaining two three more, we go con go back to di money." "Now, don’t miss this opportunity!","Now, no miss dis opportunity!" "Even, someone paid for this airtime I'm talking with.",Even dis airtime wey I take dey talk somebody pay for am. Don’t think that opportunities are just flying around.,No think sey opportunity just dey fly for wind! "Some people make the senseless statement that ""opportunities will always come.""",E dey people wey dey make statement wey no make sense sey opportunity will always come. "Opportunities will always come, but maybe not for you.","Opportunity will always come, but may be not for you." "Now that the one meant for you has come, take the one meant for you!","Now wey di one wey dey for you don come, take dis one wey be for you!" Opportunities will always come!,Opportunity will always come! "You are twenty years old now, in that time, you will be forty.","You dey twenty years now, dat time you go dey forty." And you can't do what you would do when you were twenty.,And you can't do what you will do when you were twenty. Do you understand?,You understand? Some people are listening to me now.,Some people body dey listen to me now. """Hey, this boy has talent.""",Hey dis boy dey talented. """I want to be like him.""",I wan be like am. "My brother, there was a time you had the opportunity, you did not make use of it.","My broder, e get time wey you be get di opportunity, you no move o." "Laziness, that’s what destroyed you.","Laziness, na im scatter you." "So what I'm saying now is that you will pick up your phone, and you will send me a text message containing your name, and the word ""reserve.""","So wetin I dey talk now be sey you go pick your phone, and you go send me di text message containing your name, and di word reserve." "Let them reserve your seat, so that you can send me a text message that you've been admitted into the hall.",Make de for reserve your seat so dat you go send me text message say you don dey admitted to di hall. "But whether you got the message or not, based on MTN problems, you can still come to the venue.","But whether you get di message or not base on MTN palava, you fit just come di venue." "Right now, the number to send the message to is zero nine zero...","Oya, di number wey you go send di message to now na zero nine zero..." "Right now, pick up your phone!","Oya, pick your phone!" I am waiting!,I dey wait! Pick it up; pick it up!,"Pick am, pick am!" "Get your pen, and paper!","Get your pen, and paper!" I'm waiting!,I dey wait! Good!,Correct! "Someone would say, ""this guy can see me right in my house.""",E go say dis guy dey see me for my house. "Uhuh, I have seen you!",Ehen I don see you now! "Right now, once again!","Oya, move go again now!" Zero nine zero nine five nine six five three two nine.,Zero nine zero nine five nine six five three two nine. I'll call it out again slowly.,I go call am slowly again. Don’t just beep me.,No bother to flash! "I'm in the studio, and that phone is on.","I dey inside studio, and dat phone dey on." Don’t cause chaos.,No cause trouble. Don’t show me that your chances of being successful have been compromised.,No show me sey de don log into your password for your village make you no make am. Because lack of discipline means that you wouldn't even be able get from point A to B.,Because indiscipline mean sey you no go even fit go from point A to point B. Be very disciplined!,Dey very discipline! Do not joke with a very serious business opportunity!,No dey joke wit very serious business opportunity! "Right now, dial the number again, now!","Oya, dial di number again now!" Zero nine zero nine five nine six five three two nine.,Zero nine zero nine five nine six five three two nine. I will call it out again.,I go call am again. Zero nine zero nine five nine six five three two nine.,Zero nine zero nine five nine six five three two nine. Listen closely!,Listen attentively! "When come to my seminar on Sunday, don’t come to the seminar just to complain!","When you dey come my seminar on Sunday, no waka come di seminar to come dey give your complain!" "You see, this world we're in, uh... everyone has issues.","You see, dis life wey we dey so ehn, everybody get problem." "But somehow, everyone is just hiding theirs in order to find solutions to their problems.","But somehow, everybody just dey hide deir own to find solution to deir problem." "Even if you sit down today, if you stand before a governor, or a president, and you start telling your problems, when you finish, what he'd tell you is, ""I'll look into it.""","Even if you sit down from today, dem put governor for front of you, or president, you start to narrate your problem, when you narrate am finish, wetin e go tell you is dat I will look into it." "Then, his PA would say, ""you just be on the lookout.""",Den im PA go say you just be on di lookout. "My brother, you can be on the lookout till the guy leaves power, begins and ends his tenure as a senator, even begins and ends his tenure as an ambassador... he will not have looked into the problems because he has his own problems.","My broder, you fit dey look out till di guy finish power comot, become senator comot, even become ehn ambassador comot, e never still look into di problem because im get im own problem." "So now, personalize your problems!","And now so, personalise your problem!" "Then tell yourself that this problem you are dealing with now, you brought it upon yourself, and this problem you are dealing with now, you will still be the one to bring yourself out of it.","Den tell yourself sey dis problem wey you dey so, na you use your hand waka enter, and dis problem wey you dey so, na you go still use your hand waka comot." And how would you do it?,And how you go take do am? "When you are coming to the seminar, when you know that it's an investment seminar you are coming for, you will make up your mind that you will invest this particular amount; you will invest this particular amount.","When you dey come seminar wen you know sey na investment seminar, you go make up your mind sey I go invest dis so, so amount, I go invest dis so, so amount." Not that you will just listen to it all!,No be sey you go con listen finish! First take care of yourself!,First treat yoursef! Then they'll go back to their house and start feeling like you don’t exist.,"De go con go house, con dey feel like sey you no dey exist." Make sure a seat is reserved for you!,Secure your seat! "This Sunday, I'll be teaching you how to make a six figure income.","Dis Sunday, I go dey teach una how to make six figures income." I know that's a huge one.,I know sey dat one huge for ear. "Then, specifically, I will be teaching you how to make about twenty thousand dollars from a little investment, the smallest is one thousand dollars.","Den, specifically, I go dey teach you how to make about twenty thousand dollars from a little investment at least na one thousand dollars." "And, at the same time, I will teach you how to make five percent on your investment, every Friday, for the next fifty two weeks, which is double your money by about two or three.","And at di same time, I go teach you how to make five percent of your investment every Friday for di next fifty two weeks which is double your money by two to three thereabout." I wouldn’t say it’s exactly three times as much because some fractions do go missing.,I no go call am exactly three because e get some fractions wey dey miss. "Then, at the same time, I will be bringing you into what we call ""The Billionaire School"", where they bring like-minded people together, teaching you what to do with business ideas, and ge-... organize yourself and choose the right career.","Den, at di same time, I go dey bring you into wetin we dey call di billionaire school wey be sey de dey bring like minds together, teach you how to do business idea, and ge, organise yourself, choose di right career." "As far as you're listening to my voice now, if you end up being poor, it's your problem.","As far as if you dey listen to my voice now, if you poor, na your problem." It means that some things have gone wrong with you.,E mean sey tings bin dey do you. You don’t have any right to be poor.,You no get any right to dey poor. And it's not by how you dress.,And no be by how big you dress. Dress neatly; dress corporate; find your way to Swiss Spirit.,"Dress neatly, dress corporate, find yourself in Swiss spirit." The first small thing to do the reservation is contact zero nine zero nine five nine six five three two two nine.,Di number one small to do di reservation na zero nine zero nine five nine six five three two two nine. Zero nine zero nine five nine six five three two nine.,Zero nine zero nine five nine six five three two nine. "Send the word ""reserve"" and your name. They will reserve your seat.","Send di word reserve, and your name, de go reserve your seat," Start sending it now!,Dey send am now! Don’t bother calling me.,No dey bother dey call. "Even if you call for two million years, I will not answer your call because I said, ""send a text message.""","If you call for two million year sef, I no go pick your call because I say send text message." It's a common instruction for people who want to move forward.,Na common instruction for people wey wan go forward. "And this morning, if you are in the city of Port Harcourt, as soon as I leave this place, I'm heading straight to the Presidential... myself and the owner of Sahara Energy; myself and the uh... the owner of Kilimanjaro and uh... Market Square; myself and the owners of uh... O Wilson Tea Mate Bread; and also Hilda Dokubo, and lots of them, we are in the Presidential this morning and we are talking at the Niger Delta CEO Summit.","And dis morning, if you dey di city of Port Harcourt, as I dey comot here now dey head straight to Presidential, me, and di owner of Sahara Energy, me, and di, eh di owner of Kilimanjaro, and eh Market Square, me, and di owners of eh O Wilson Tea Mate Bread, and also Hilda Dokubo, and lot of dem now, we dey Presidential dis morning, and we dey talk on di Niger Delta CEO Summit." Admission if free of charge and it's for your sake that we're organizing that event.,"Admission na free of charge, and na because of una we go set up dat event." "Uh... if you can come to that venue, start coming right away.","Eh if you fit come dat venue, oya, dey come straight." "I am going there right away, I am going to take my own session.","I dey go dere now, I dey go take my own session." That's where you will hear the English version of my talk.,Na dere you go hear di English version of me. "From this place now, we are taking it straight to the roots, where we are coming from.","For dis place now, we dey do am straight to di square root where we dey come from." I was staying with my mother in the village.,"I dey stay with my moder, for village." So we always went to the farm.,So we dey go farm. So we...,So we dey... "As we went to the farm, we'd been staying on the farm for a long time.","As we dey go farm now, we don dey tay for farm." "So, there's one of our brothers... one of our...","So e get one of our broder, one of our..." "Because I never met my father, my father had died.","Because I no meet my fader, my fader don die." "Before I grew up, my father had died, I didn't meet him.","Before I grow up, my fader don die, I no meet am." So there are five of us in our family.,So we be five for family. "Before I grew up, my father had died.","Before I grow up, my fader don die." "So there, one of our paternal uncles, he was the one we were helping go, go to the farm.","So dere, one of our fader broder, na im we dey help dey, dey go farm." "When we helped him with the work, he would, would pay us.","If we dey help am dey work, e go dey, dey pay us money." So that was how we were working.,So na so we dey work o. I was working.,I con dey work. "I was gathering money, little by little.","I con dey gader small, small money." "As we were gathering money, little by little, then we said, ""well, okay, we've gathered enough money.""","As we dey gader small, small money now, naim we con say toh okay we don gader money reach." """Let's try to put...""",Moh we try put... """If it's our older brother, let's put him in school.""","If na our senior broder, moh we put am for school." """Let him go to school.""",Meh dat one dey go school. "So if we put him in school, he was not...","So if we put dat one for school, dat one no dey..." "He didn't agree to go to school, he would run away from school.","E no go gree go school, e go run comot for school." He would come back to stay home.,E go con stay house. "So, that was how my mother did, did it.","So na so my moder do, do o." "One of our maternal aunts who was in town, who was in Edo, she said we should come, we should pack our things and come meet her.","One of our moder sister wey dey town, meh dey for Edo, e con say moh we con, moh we pack our tings con meet am." Then all of us packed and went.,All of us con pack go. "So, that woman's place was where we were staying.",So na dat woman na im we con dey stay. So none of us were going to school.,"So all of us, no dey go school." "So, for me, it was second hand clothes I was selling.","So me for inside, na Okirika I dey sell for market." "We went to sell second hand clothes, we went to carry loads.","We dey go sell Okirika, we dey go pack load." We would pack uh... second hand clothes in the market.,We go pack eh okririka for market. "All those people who carry bags of rice, that was where we brought it in the market.","All dose people wey dey carry bag of rice, na dere na im we dey go pack for market." "So, I was saving money.",So I con dey gader money. "Then I said I should use it to go to Abuja, to start schooling.","Mah con say meh I take come Abuja, mah I take come start school." "So, as I was saving the money, my sis... our older brother, he didn't listen to anyone.","So now as I dey gader di money now, dat my sis, dat our senior broder, im no dey hear word." He was involved in a fight.,Na so fight im dey fight. "So as he was... he went to fight, his... (I don't know where he went to fight at a party), his hand was wounded.","So as e con dey, e con go dey fight, de con (I no know where e for go fight for party), de con cut im hand." One of his hands was wounded.,De con cut one of im hand. "So, there was only one hand he could use.",So na only dat one hand na im e con take dey use. "So, he wasn't... he wasn't able to do anything.","So im no, im no con fit dey do anyting." He just turned into a liability.,Im just con turn to liability. "So, he was just staying in the house.",So na house na im e dey stay. "Any money we made from work, any money anybody worked for, some would go to carrying second hand clothes.","Any money meh we work, any money meh anybody go work some go go carry okririka." We would go work and come give them there.,"Na dere we go work, con carry give am." That was how we were doing.,So na so we dey do o. We kept going.,We con dey do. "Then I said, ""well, let me get a little something together and come to Abuja, to start learning, whether a trade or in school.""","I con say toh make I gader small, make I come Abuja, make I con start to dey learn if na work I wan go, or na school." That was how we started schooling.,Na so we con dey do di school. "From there, I came here.","A-... as I dey dere, I con come here." One of my uh... my... our cousin's brother put me in JSS One.,"One of my eh, my, our cousin broder con put me for JSS One." So I continued on.,Ah na so I dey do o. "Mstchew, the school didn't... the school didn't go well with my...","Mtschew di school no, di school no enter my..." "As in, anything they taught me, I just didn't...","As in, as anyting wey dem dey teach me, I no just..." It's not school.,No be school. I didn't... I just didn't want to go to school.,"I no, I no wan just go school." So that was how we were.,So na so we dey o. "We were there, we were getting by.","We con dey, we con dey manage." "Like if he forced me to go to school, I wouldn't go.","Like if e pursue me go school, I no go go." "So, one day, one of my friends told me that this school that they kept forcing me to go to, if I didn't want to learn, if I didn't want to go to school, I didn't have to.","So one day, one of my friend con tell me sey toh dis school meh de dey pursue me dey go so, if I no learn am, if I no wan go school, no be by force." I should leave there and we should go work.,"Make I comot for dere, moh we go work." "Then I said, ""well, okay, let's go work.""",I con say toh okay moh we go work. Then we went to where they do aluminum.,We con go where de for dey do dis aluminium. It was a shop.,Na e shop. We went to that place.,Con go dat place. I went to that place.,I go go dat place. "The guy... the guy had lots... the guy had almo-... about sixteen boys, and the place was really big.","Di man, di man too get, di man get almo-... about sixteen boys, and di place na mighty." "I was older than all of them, but they would be sending me to go...","And I senior all of dem o, but as in de go dey send me go..." "Where they sent me to pack tools, the place was really far.","Na where de dey send me go go pack tools, di place too far." Then I said I wasn't going to keep going.,Naim I talk sey I no do again. So I left.,Naim I comot for dere. "So, then they took me to a tailor.",So de con carry me go tailor. "To a tailor's shop again, where I was... where I would learn tailoring.","Con go tailor shop again where I dey, where I for do tailor." "The man... it was men's clothes I wanted to learn, but he only sewed women's clothes.","Di man, na man cloth I wan learn, but na only woman cloth na im e dey sew." "So then I said, ""well, I can't be sewing women's clothes.""","So me, I con say toh me, I no fit dey do woman cloth." "Then I said, ""well, let me leave.""",Naim I con say toh mah go comot. "So, I wanted to go and learn carpentry.",So I wan go learn carpenter. "So, it was carpentry I was learning.",So na carpenter na im I con dey learn. "As I was learning carpentry, I was beginning to grasp... I was understanding little by little.","As I con dey learn carpenter, I don dey sabi, I don dey sabi small, small." "So, they called me from the village saying that my mother was sick.",So de con call me for village say my moder no well. They called us from the village saying that our mother was sick.,De con call us for village sey our moder no well. "Then we said ""well, since she's sick, what will we do?""","We con say toh okay as e no well now, wetin we go do?" "Then we said ""well, all the money we've saved, we should bring it to her.""","We con say toh all money meh we don save, meh we carry am con give am." So that was what we did.,So na so we dey do. "Then we hustled, got money and went to give it to her.","Con dey hustle, con hustle money go give am." "So then they, they operated on her.",So de con s-... de con do operation for am. It was fibroid she had.,Na fibroid na im de do am. So then they operated on her.,So de con do operation for am. "Then they... we were at home, then they...","De con, we con dey house, de con..." "On Easter Sunday, it was exactly on Easter Sunday, they called us saying we should come to the village.","Easter day, na on Easter day gangan na im de con call us sey moh we dey come village o." Our mother had died.,Sey our moder don die o. So all of us packed our things and went to the village.,Na so all of us pack oursef go village. Then we saw that our mother had indeed died.,We con meet am say our moder don die. So that was it.,So na so dey do. "Before we did, mo-... there wasn't even money for the burial.","Before we do, mo-... no money to even do burial sef." It was just...,Na just... It was because my mother's church...,Na because my moder church... "Since she was a women's leader in their church, they did everything.","As in na women leader for deir church, so na church na im even do everyting." "They were... they were the ones who bought the coffin, they did everything.","Na im, na im buy coffin, na dem do everyting." So that was how we left.,So na so we take comot. "As I got to town, I was working.","As I con reach town, na so I con dey work o." "The person I was working with, if I... if we went to work, I would be the one to do the work.","Person meh I follow dey work, if I, if we go do work, na me go go do di work o." He would...,Im go... "Before I went, he would go... he would go behind me to collect the money, he would spend everything, he would say they hadn't paid him.","Before I go, e go go, e go follow my back collect money, e go chop everyting, e go talk sey dem never pay am." "If I finished the work, I would go and ask the guy.","If I don finish di work, I go go ask di man." The guy would say he had taken the money.,Di man go say im don collect di money o. That the... my boss had taken it.,"Sey di, my oga don collect." My boss had spent it... spent all the money.,"My oga don chop am, chop all di money." I went to meet my boss.,I go meet my oga. My boss would... boss would say he hadn't taken the money.,"My oga go, oga go say im never collect di money." So then we'd start to argue.,So we go con dey drag. "Then I said (I haven't forgotten), ""let me leave this place.""",Naim con say (I no forget) make I comot for dat place. Then I went to another shop.,Naim I con come anoder shop. So that's where I was working.,So na dere I dey work. The guy and I were working.,"Me, and di man dey work." The guy pays me while I work.,"Di man dey pay me, me, I dey work." The guy... me and the guy would... the guy paid me for the work I did.,"Di man dey, me, and di man dey, di man dey pay me di work meh I dey do." Then my sister said our parents' last child...,So naim my sister con talk sey our last born... "As it is, I'm a twin, that's why they named me Odion.","Because I be twins, na im make I de call me Odion." I'm a twin.,I be twins. "My twin sister called to say well, as it was, right then, she wanted to start school.","My twin sister call us sey toh as im dey so, im wan start school o." Saying she can't...,Sey im no fit dey... She was...,Im na... "Because she was a woman, she wanted to go to school.","Because im na woman, sey im wan go school." "Then I said, ""well, we'll put some money together for you to put you in school.""",Naim I con say toh we go gader money for you moh we put you for school. So we got some money together.,So na so we con gader money o. We put some money together.,Con gader money. "All the work I did, if I did any job, I would save three thousand naira.","All di work meh I dey do, if I do work like dis, na three thousand naira I go save." That was how we went on.,"Na so we con do, do." Then we put my younger sister in school.,Con put my junior sister for school. She sat for the WAEC.,Dat one write WAEC. "As my younger sister took the WAEC, she took it, but she didn't have money to...","As my junior sister write WAEC now, she don write WAEC, but e no get money to..." "She took the JAMB too, but...",She take JAMB sef but... She passed her exams.,She pass her papers. She scored two hundred and ninety.,She get two ninety. "That was what she scored, but there was no money to, to proceed.","Na im she score, but no money to, to forward." That was why she...,Na so she... That is what made her stay at home since last year.,"Na, na im make am dey house now since last year." She sat for the WAEC.,Na im she write WAEC. She wrote the JAMB.,Na im make am she take her JAMB. That's why she's at home now.,Na im make am she dey house now. There's nothing to do.,Notin to do sef. So I'm working.,So I con dey work. "I then came to X, X, X, Agwan-... Agwandodo.","I con come X, X, X, Agwan-... Agwandodo." I was working with one guy.,I con dey follow one man dey work. The guy and I were working at that place.,"Na me, and di man dey work for dat place." "So anytime we worked, the guy would always give money; anytime we worked, the guy would give money.","So anytime we work, di man go give me money, anytime work, di man go give money." "So since I was at that place, my cousin's brother who I stayed with in Abuja behind Specialist, told me uh... as it was, he could no longer feed me.","So as I con dey dat place, my bro-... my cousin broder meh I dey stay wit for Abuja for back of specialist, e con tell me sey eh as e be so ba, im no fit feed me again o." I should please go... I should pack my things.,"Sey abeg make I go do, I go do pack my tings." I should go back.,Make I go back. "Then I said ""ah ah, why are you acting like that, you were the one who asked me to stay.""","Naim I con say aha why you go do like dat, na you de carry me come make I con stay." He said it didn't concern him.,Sey noting concern am o. "As it was, he could no longer feed me.","Sey im, as e dey so, im no fit feed me again." "Well, I said, ""well, okay, let me go back to the village.""","Toh naim I say toh okay, sey meh I go back to village." "Then I said, ""well, okay, as it is, I don't have anybody in the village, I don't have a father, I don't have a mother, I can't just go to the village.""","Naim I say toh okay, as e be sey I no get anybody for village, I no get fader, I no get moder, I no just fit carry myself go village." I then went to s-...,Naim I con go dey s-... "There was one, one of our guards who stayed in the shop.","E get one, one of our maigadi wey dey stay for shop." "Then I went and joined the, the guy to stay in the shop.","Naim I con go dey follow di, di man dey stay for shop o." "So as I joined and was staying with the guy, it was from there, I joined him to guard.","So as we dey follow di man dey stay, na dere I follow, follow di man dey guard." Then I saved up some money.,Naim I con gader small money. Then I went and rented a house.,I con go rent house. So that's where I'm staying now.,Na dere na im I dey stay now. "So, I'm even working.",So na work I even dey do sef. Work is what brought me to this place.,So na work na im carry me come dis place. I work for Fidelity Bank.,Na work I dey work for dis Fidelity Bank. So that's where we're working.,So na dere we for dey work. "Then they said well okay, that place, they want to sell the land.","Naim de con say toh okay dat place, de wan sell di land." They wanted to sell that land.,Sey de wan sell dat land. All of us should pack and leave that place.,Meh all of us pack comot for dat place. We should go find out where to stay.,Sey meh we go find where we go stay. That was how they did it.,Na so de do o. Then they had a dispute over the matter.,De con drag for di matter. They couldn't sell the land anymore.,De no con sell di land again. "So, that's how we were still at that place working until now.",So na so we take dey dat place dey work now. My boss had been planning to travel out.,"My oga now, im don dey plan to travel out." "I knew if he travelled out, I'd be the one he'd leave in that shop.","But I know sey if e travel out, na me e go leave for dat shop." His wife didn't agree.,But im wife no gree. Then the wife went to bring her younger brother.,Di wife con go bring im junior broder. The wife just brought her younger brother from the village.,"Di wife, e just bring her junior broder for village." He's the one who's staying in the shop now.,Na dat one con dey stay di shop now. "So, my boss has travelled out now.",So my oga don travel now. He travelled out last month.,E travel out last month. "So, that's it, we're engaged in a battle.",So na so we dey battle. "Any... anything you do, it's... it's the woman who will...","Any, anyting you do, na she, na di woman na im go dey..." She's the one who will collect all the money.,Na im go dey collect all di money. "So, then I told the woman, ""well, as it is, I...""","So I con tell di woman sey toh as e be so, me, I..." """Since I've finished learning the trade, let me graduate.""","As I don learn work finish, make I do freedom." """I want to leave.""",I wan comot. """I will...""","Me, I go..." The woman said I can't leave.,Di woman say I no fit comot o. I have to... I have to work there.,"Sey I must, I must dey under di place." "I then said, ""what?""",I con say aha. """What else will I be doing there?""",Wetin I wan do for here again? """The person who was teaching me has left, and I've finished learning the work.""","Person wey dey teach me work don comot, and I don sabi work." """What do you want me to be doing there?""",Wetin you want mah come here dey do? She said no.,E say no. "So me, I must stay.","Sey me, I must stay." "For seven years, I should...",Sey until di seven year make I co-... "Then I said, ""what am I...?""",Naim I say wetin I dey... ?.. """Seven years, who will be teaching me the trade?""","Seven year, who wan dey teach me work?" """I'll be here with nobody to teach me the trade.""","I go con dey here, nobody dey teach me work." """My boss has travelled out and you're a woman.""","My oga don travel out, and you na woman." """You can't be... you can't be where I am.""","You no fit dey, you no fit dey where I go con dey." """Who do I want...?""",Who I wan... ? """Wha-... who wants to teach me the work?""",Wet-... who wan teach me di work? She said no.,E say no. "That me, I had to stay.","Sey me, I must stay." "Then I said, ""well, ma'am, if that's so, I'm not staying anymore.""","Naim I say toh madam, if na so, I no stay again o." So I left and was doing jobs for people.,"Na so I take comot, con go dey do jobman for people." "When I work, they give me two thousand naira... when I work, they give me one thousand.","If I work, na two thousand de go give me, if I work, na one thousand." "So, I was using that to feed myself and clothe myself.","So I take dey feed myself, dey cloth myself." "So that's how I, for all my life, how I'm doing.","So na so me, I all waka, me take dey do." There's only one girl out of all of us who has gotten into school now.,Na only one of girl don enter school now. The rest are still in the village.,"Di rest, de still dey village." "So, for me, as we are, it's money I'm looking for so that I... (if I can save a little something), so that I can just help my sister so that... (if it's school that she wants to go to), so that she can go to school.","So me as we dey so, na money I dey find so dat I (if I fit gader small ting), so dat I go just help my sister make (if na school dat one wan enter), meh e enter school." So that's how it is.,So na so di matter be o. "Okay this place, uh... D-Morris, as we went to D-Morris, we said we would eat eba at D-Morris.","Okay dis place, ehn D-Morris, as we go D-Morris, naim we say we go chop eba for D-Morris." "Well, so it's uh... Fabian, uh... Paul, uh... and one... and Chima and I.","Ehe na haha me, Fabian, ehn Paul, ah and one, and Chima." One is...,One na... Okay it's not...,Okay no be... Chima didn't follow us.,Chima no follow. "If Chima had followed us, uh... he would... uh... he would have beaten my record.","If to say Chima follow, e, e for, e for win my record." "Because Chi-... Chima is someone who will cook five cups of rice and nearly finish it, all by himself.","Because Chi-... Chima na di person wey be sey we go cook five cups of rice, Chima nearly finish am, but all by himsef." Now we are at D-Morris eating eba.,Now we dey for haha D-Morris dey chop eba. Then...,Naim... "That time, food was really cheap.","Dat time, food dey cheap now." So that was how we ordered.,So naim we order o. Eba thirt-... eba...,Eba thirt-... eba... I think uh... the eba was one fifty or so.,"I tink eh di eba, eba, one fifty or so." I can't remember anymore.,I no remember again. But there was plenty.,But e better like sey di ting big. So we ate and ate!,"Na how we chop, chop!" Actually we finished it.,Actually see e finish. "Lilian, that was when Lilian arrived.","Lilian, naim Lilian come o." "Funny enough, this Lil-... silly Lilian girl, if she... a guy took her to D-Morris to eat, then she would be acting like a big babe, a big chick.","Funny enough, dis Lil-... foolish Lilian girl, if she, guy carry am come D-Morris con chop, naim she form big babe, big chick." She didn't talk to me that day.,She no follow me talk dat day. "She just looked at me, smiled, took her f-... as if she didn't notice how we were teasing each other.","She just look me, smile, comot abf, as if sey she no see as we dey yab oursef." Then Lilian saw me on the church ground.,Naim Lilian see me for church ground. She looked at me.,See me o. Lilian raised her hand.,X Lilian carry hand. Bi-... big girl who acts like uh... a sophisticated babe carrying an apple on her head.,Bi-... big girl wey dey do ehn tush babe carry apple for head. Hi eba eater!,Ehi eleba! That she didn't know I eat eba like that.,Sey e no know sey I dey chop eba like dat. I said what?,I say wetin? That’s how it is.,Na so. So she's the one who designed the first website for UI at that time.,So but na she design di first website wey UI get dat time. That time you...,Dat time you... "In fact, the website was like uh... magic.",In fact website be like eh magic. It was like white man's magic.,E be like Oyibo magic. And she's al-...,And she is al-... "Also she was studying computer science, and she was in her final year.","Also she do computer science, and she dey her final year." "So she was doing her final year project, and she designed a mini website for the University of Ibadan.","So she con dey in her final year project, and have designed a mini website for University of Ibadan." And the only place where she could do it was in the administrative office.,"So and di only place wey she fit do am, na for admin's office." And you know that...,And you know sey... "Because we, we, we now know a lot of people.","Because we, we, we know people well, well now." I don't know what took us there...,I no know wetin carry us go... "So it was there, I saw her there sitting down looking like...",So na here I see am dere wey she siddon look like... "In fact, she was looking... she looked... she looked so miserable like it was a punishment because she didn't have a choice.","In fact, she was looking, she dey look, she look so miserable like sey ehe dat wish na punishment, because she no get choice." "So as she saw us, then her face brightened with a smile.","So as she see us, naim her face brighten wit smile." She was happy we came.,She happy sey we come. She said we shouldn't go.,E say make we no go now. "I said ""what, we shouldn't go?""",I say ehn make we no go? "So, let them take my matriculation number and take it up to the senate chambers.","Meh de for take my matric number, climb for Senate chamber." "I said ""no, I am leaving you here.""","Sey no, I dey leave you here." """This is your problem, keep dealing with it!""","Na your cross, carry am go!" Hehehe!,Hehe! So the...,So de... That was how I cancelled the eleba story.,Na so I take cancel di eleba story. "So anytime she wanted to talk about the eleba, I just said ""am I the one who gave you an assignment?""","So anytime she wan talk eleba, I just tell am sey ehe na me send you message?" I went to the office to work on the website.,I go office go do website. "So, so if, if uh... any... if you, you, you took yourself to D-Morris, or go to NISER Park.","So so if, if eh any, if you, you, you carry yoursef now go D-Morris, or go NISER Park." "Okay, that's where you went.",Ehen na dere you go. That was why she...,Na im make e dey. "That was why she pinned everybody because all those places where guys are, ah there are so many!","Na im make am pin everybody because all dose places wey guys dey, ah e plenty now!" "Uh... NISER park, you know this swimming pool?","Ehn NISER Park, you know dis swimming pool?" "Opposite the swimming pool, that typing pool, you know there used to be a lot of eating joints?","Opposite swimming pool, dat typing pool, you know sey a lot of eating joints full dat place before ehn?" "In fact, there is one...","In fact, e get one..." Uh... what's that guy's name again?,Ah wetin be dat guy name again? "That guy does uh... he makes this uh... mstchew toasted bread, toasted chicken, and all the rest.","Dat guy dey do, ehm e dey do dis eh mtschew toasted bread, toasted chicken, and all di rest." "And at that time, the thing was not cheap at all!","And dat time, na di ting no cheap o!" "Chicken and chips they sold for two hundred and fifty naira at that time, the two hundred and fifty was really big money!","Chicken, and chips wey de dey sell two hundred and fifty naira dat time, na dat two and fifty na big money o!" Wow!,Kai! Serious money!,Heavy money! "So, there was one stupid thing I did one day, each time I remember, I just look at myself and I just laugh at myself.","So e get one foolish ting wey I do one day, each time I remember, I go just look mysef, I go just dey laugh mysef." "There was one, uh... one of my friends, this chick (in fact, I would say she was my first girlfriend), so she and I really connected well.","E get one, ehn ehn one of my friend, one chick o (in fact, like to say na my first girlfriend be dat one), so me, and she we dey flow very well." "So, as it was...","So as e dey you, e..." "When I went to her house, she introduced me to her younger brother.","As I come deir house now, de, she introduce me to her younger broder." Her younger brother really liked me and got along with me well.,"Her younger broder con like me now, dey follow me flow well, well." I don't know what we were discussing one day.,I no know wetin we dey talk one day o. Then we...,Na we... "Eveybody was acting up, we were boasting that ah!","Everybody dey form now, we dey boast sey a'ah!" "He said, ah!",E say ah! "I said chicken, and chips.","I say chicken, and chips." And they... I said chicken and chips.,"Sey de, I say chicken, and chips." It was then they si-... we should say have-... uh... cooled down.,Naim de si-... make me say hav-... eh cool down. "Chicken and chips, it was like it should be...","Chicken, and chips, na im make e dey be like sey..." "While I was making fun of him, he said he had never eaten it, really.","As I dey yab am, e say ah e never chop." "To tell you the truth, he had really never eaten it before, honestly, he was not lying, if I would... if, if I could buy it for him, he wouldn't mind.","Sey e go talk true o, sey e never chop am before o, sey e go talk true, sey e no go lie, sey if I for, if, if I go fit buy am for am now, e no go mind." "As I wanted to act like a big brother, I said no problem at all.","As I want do big bros now, I say no wahala, no wahala!" We'd see what we'd do about it.,We go see wetin we go do about am. Then I started to save.,"Now, I begin save." "Uh, this thing took me about three weeks, for only two hundred and fifty naira.",Ehe dis ting take me like three weeks as in only two hundred and fifty naira. "If I had money, at least, I would have saved up to five hundred naira.","If sey I get money, at least, I for save reach five hundred naira." "I would buy his own, buy mine, we would sit down and eat.","I buy im own, buy my own, we siddon dey chop." "But as the day we fixed for going to eat chi-... together was approaching, I couldn't disappoint him as I wanted to show I was a big boy.","But as di day wey we fix sey I go go chop togeder chi-... don dey reach now, I no fit mess up now a-... as per big boy." So that was how I shamefully...,So naim I take shame now... I shamefully went with him.,Take shame follow carry go. I bought chicken and chips for two hundred and fifty naira for the monkey boy.,"I buy chicken, and chips two hundred and fifty naira for di monkey boy." You wouldn't believe how this idiot turned his back to me and ate everything up.,"You know sey dis idiot back me, chop everyting finish." He didn't even offer me a single chip!,E no even talk sey make I take even one chips! Please!,Jor! Then the...,Naim e con di-... "You wouldn't guess what the moron asked me, ""won't you buy anything for yourself?""",You no know wetin di monkey ask me sey you no go buy your own? "I said no, no, no.","I say no, no, no, no." I said they... I didn't... I didn't really want to eat.,"I say dey, I no, I no wan chop, I no wan chop." I shamefully bought Krest.,I tought take shame buy Krest. "Krest, which they sell...","Krest, de dey sell..." It's like they sell Krest.,E be like sey de dey sell Krest. "Man, I can't remember no... but Krest was not too expensive.","Guy, I no con remember X X Omole, but Krest no too cost." I was sipping Krest and... because of my stomach.,"Dey sip Krest dey, cause of my belle." I was sipping Krest because of my stomach.,Dey sip Krest take cause of my belle. I was sipping Krest thinking of the idiot monkey!,Dey sip Krest sey idiot monkey! God will punish you there!,God don fire you dere hehe! "Yes, thunder will strike you!",Ehn thunder fire you! "That, that, that, that your...","Dat, dat, dat, dat your..." See mstchew!,See mtschew! I was just...,I just... The stupid boy didn't even mind me.,Di foolish boy no even send me. He just cleared the plate.,Just clear plate. Completely!,Clear. He cracked the bones!,Crack di bones eh. You know the bones are not very strong.,You know sey di bone no dey stronger. The guy ate the bones and everything.,"You guy chop di bone, everyting." Wow!,Kai! "That was when I got riled up and said come on, leave the bones, are you crazy?","So naim I con provoke mysef come on, leave bone, you be bingo?" Is he crazy?,Sey im be bingo? Hm... the gbu-... the boy has no shame.,Hm nn di gbu-... di boy no dey shame. He us crazy.,Sey im be bingo o. Is it because it's his first time he's had chicken and chips?,"Sey cause chicken, and chips dey for di first time wey im, im buy am." "He ate it, ate everything.","Sey im go chop am, chop everyting." Wow!,Kai! "I was just looking at the guy saying ""look at this idiot!""",I just dey look di guy say see dis idiot! He did not even say I should take some to eat.,E no even say make I take part chop. Both of us should...,Make both of us... So when he finished eating it...,So when e chop am finish... "After we finished eating that day, as I was cursing him on the way, he took...","Sey after we chop di fish go dat day, as I dey curse am dey go, ehe im carry..." "I didn't know the moron would go to tell his sister ""I bought chicken and chips.""","I no know sey di monkey guy go tell im sister sey me, I buy chicken, and chips." Then she started begging him for chicken and chips again.,"Con dey beg am for di chicken, and chips again." "Uh... you see as he was saying we, but he didn't give me any.",Eh you see as e talk am sey well sey im no give me o. He said he would finish everything.,Sey e go finish everyting. So I was just looking at him.,"So I dey look am, dey look am." I was hungry for it.,Di ting dey hungry me. Where would I buy another one for myself?,Sey where I go buy anoder one for mysef? "No, no.","Sey no, no." "I thought ""It's your last card.""",Sey na your last card. """Hehe, take my own!""",Hehe take my own. "Okay, you know it was my last card.",Sey okay you know sey na my last card. "So, so I said ""Okay, it serves you right.""","You con, con say okay o, e good for you now." It's good for you to do it like that.,E good make you do am like dat. My name is Bose Alade.,My name na Bose Alade. I stay in the barracks.,I dey stay inside barrack. I want to tell you my... how I spend my days.,"I wan tell una my, how I dey use my day." "In the barracks here, in the mornings, when I wake up, I give my kid a bath and put food on the stove.","For inside barrack here, in di morning, if I wake up, I go bath my pikin, I go put food for fire." "When she's eaten, when she's taken her bath, when she's gotten dressed for school, she goes to school.","If she don chop, wey she don bath, wey she don dress for school, she go go school." So then I do chores around the house.,So I go con dey do house work. "And again, I do tailoring.","And again, I dey do tailoring work." "Because I just moved into the barracks here, so I really don’t have many customers.","For I just newly come inside barrack here, so I never too get customer wey plenty." "So, in the...",So in di... "When she's left for school, I...","If she don go school finish, I go..." "If I've finished sweeping the house, done everything, all my house chores, if I've finished it all, the little... the little cloth that I have, I sew it.","If I don sweep house, do everytin, all my house work, I don do am finish, di little one, di little cloth wey I get, I go sew." Because it's every month that they... that they pay in the... that they pay the soldiers.,"Because na every month na im de dey, na im de dey pay for inside, na im dem dey pay for soldier." You know I'm a soldier's wife.,Una know sey na soldier wife I be. "So the little cloth I have, I sew it.","So di little cloth wen I get, I go sew am." "When the month ends, they come and pay me.","If month end, de go con give me money." The ones who can't pay it all pay half.,"Di ones wey no fit pay di full money, de go pay half." I take it.,I go collect am. "The kind of clothes that I sew, I sew iro and buba, I sew gowns, I sew skirts, and blouses.","Di kind cloth wey I dey sew, I dey sew iro, and buba, I dey sew gown, I dey sew skirt, and blouse." "It depends on the styles they say they, they want.","E depend on style wey de say dem, dem want." And it depends on how much money you say that... you will pay.,"And e depend on di money wey you talk sey you go, you go pay." "So, in the barracks here, life in the barracks here is, is not so easy, but we just thank God that things will get better one day, here in the barracks.","So, for inside barrack here, di life for inside barrack here too, no too dey easy, but we just tank God sey tins go better one day for inside barrack here." I have a lot of neighbors!,I get many neighbours o! Look at my... our house!,"See my, our house!" Our house is really long.,"Our house long well, well." I have lots of neighbors.,I get many neighbours. "One of them is called Piriye's Mum, another one is called Umi's Mum.","One name na Mama Piriye, one name na Mama Umi." She sells pepper.,She dey sell pepper. "The ones down here, they sell fish.","Dem, for down here, de dey sell fish." You don’t even need to climb because we live on the top floor.,"E no need make you even climb because na on top, up, up we dey live." You don’t even need to climb up... and go down.,"E no even need meh you climb up, en go down." "If you want to climb, you can use the bucket.","If you wan climb, you fit put doro." "If you want to buy fish, they'll sell it to you, they'll put it in a bucket and send it up.","If you wan buy fish, de go sell, de go put di tin inside doro for you, de go send am up." "Inside the barracks here, we don’t...","For inside barrack here, we no..." "We, the people, the wives who are in the houses here, we really don’t have jobs.","We, people, di wife wey dey house here, we no too get work." We're always in the house.,Na house we dey dey. "Until... when our husbands come back, that's when we get money.","Until, if our husband come back, now we dey get money." "After... and sometimes, when I go further inside the barracks, (they do hairdressing in the Mami Market), I go and have my hair done in the Mami Market... in the uh... Mami Market, a place where soldiers' wives sell things.","After, en sometimes, wey I dey go inside, (de dey do hair for mami) I go go do my hair for mami, for eh mami, place wey soldier wife dey sell sometin." I go and get my hair done in the Mami Market.,I go go do my hair for inside mami. "And when the month... uh... when the month ends, if we want to go... if we want to go and collect mo-... if we want to go and buy food for the house, we go to this place, we go to Bodija, a market over there.","And if month, ehn if month end, if we wan go, if we wan go collect mo-... if we wan go buy food for house, we go go dis thing, we go go Bodija, one market dere." "We go there, we go to buy things, for the house.","We go go dere, we go go buy something, for house." "We go to buy things, we go to buy food in... from the market.","We go go buy something, we go go buy foodstuff for, from market." We...,We dey... We go through the bush.,We dey even follow bush. There's a shortcut.,Shortcut dey. We cut through the bush.,We go follow bush. "If you don’t want to go through (because the transport fare to go out from... from here to Bodija, I spend seventy naira leave the barracks) you will spend another seventy naira, or fifty naira to get to Bodija.","If you no wan follow (because transport to go outside from, for here to go Bodija, I go use seventy naira con go outside barrack), you go use anoda seventy naira, abi fifty naira go Bodija." So it d-... it's easy for us.,So e d-... e dey easy for us. We just cut through the bush here.,We go just follow shortcut inside bush here. "We just cross the express way, we just spend thirty naira.","We just cross dis express, go just enter thirty naira." And we are in Bodija.,We don enter inside Bodija. So that's how we are.,So na so we dey. We're...,We are... We always have electricity too.,We dey always get light too. We always have electricity here in the barracks as well.,Light dey always dey inside barrack here. "If... except these last few days now when the rain... when the wind was very strong, so our electricity got messed up.","If, except dis few days now wey rain, wey breeze blow well, well, so our light spoil." We don’t have electricity at the moment.,We no get light. So we always have electricity.,So we dey always get light. And we don’t have any water in these barracks at all.,And water no dey dis barrack at all. The lack of water is a problem for us.,We dey suffer for water. The only time we have full water supply is in the rainy season.,"Di only time wey we dey get water well, well, if na rainy season." "When the rain falls, everyone puts their drums outside, but if it doesn't rain, we don’t... we always face water shortages.","If rain don fall, everybody go put im drum outside, but if rain no fall, we no dey, we dey always suffer for water." "Our tank, they made tanks for us here because it's g-... uh... group by group.","Our tank, dem do tank for us here because na g-... ehn group by group." "There's MP, there's Sergeant uh... S, and T, there's the Medical.","Mp dey, Sergeant ehn, S, and T dey, Medical dey." "They have their borehole, but here, ours, our new... our commandant, he refused to have it repaired for us.","Dem get deir bore, but our own here, our new, our commandant, e no gree repair am for us." He ruined it.,E spoil am. And we go fetch water from the other block.,And we go fetch water for di oder block. But they refuse.,Dem no gree. They say they don’t want us to fetch water from our... from their place.,"De say de no wan moh fetch water for our, for deir place." We should go to our place.,Sey moh dey go our place. "So since then, we've been suffering from, from a lack of water.","So since den, we suffer for, for water." "We look and look for water, but we don't find any.","We go find water, find water, no go see." We're always suffering water shortages.,We dey always suffer for water. "And again, their lifestyles in the barracks here, it, it's is just easy.","And again, deir life for inside barrack here, e, e just dey easy." Let's not talk.,Moh no talk. It's...,E dey... B-... but I prefer the time when I was still there in Ondo State.,B-... but I prefer di time wen I still dey Ondo State dere. "Over there, everything is okay.","Dat place, everything dey okay." "There's water, there's everything, there are marketplaces.","Water dey, everything dey, market dey." "But when they said that a person, by all means, will go to her husband's house, will go to her husband's house, that you need to stay with your husband because a soldier should not be left like that, the person comes here.","But when dem talk sey person now, by force by fire, you go go your husband house, go go husband house, you need to stay with your husband because dem no fit leave soldier man like dat, person come here." "But that place, I still prefer that place.","But dat place, I still prefer dat place." Let me stay in that place.,Make I stay for dat place. But as life is going on now...!,But as life dey goes on now! I'm going to a Redeem Church.,I dey go Redeem Church. "My church here is past this Ojurin side there, inside the barracks here.",My church here na after dis Ojurin side dere for inside barrack here. Redeem is where I'm going.,Na Redeem I dey go. I go there.,I dey go dere. We're...,We dey... "On Monday, I go to...","Monday, I go go..." "On Sunday, they start the programme at nine o'clock.","On Sunday, na nine clock de start programme." They finish at twelve.,De go finish twelve. "Because of uh... maybe all the people who are at work, so they can attend the programme, they start at nine o'clock.","Because of sey ehn maybe all di people wey dey go duty, meh dem fit meet programme, na nine o'clock de dey start." "And there's Bible Study, there's Digging Deep.","And Bible study dey, deep dey." We go to...,We go go... "Sometimes, once a month, they always have the night vigil sessions.","Sometimes, once in a month, de will always get night vigil." They attend night vigil programs because they don’t want too much noise in the barracks.,"De attend night vigil because of sey dem no wan too much noise for, inside barrack." So that's why their program is like that.,So dat is why de dey do deir programme like dat. "Having another child, that's the only challenge I have.","Born anoda one, na only dat one na im I still get for hand." "But all the children around me, they are still my children.","But all di children around me, na still my pikin na im de, dem be." "People of Plateau, they have one kind of... life-... lifestyle which shows in their dress, most especially their costumes.","People of Plateau, de get one kind of em lafs-... lifestyle wey dem dey carry dress most especially deir attire." "As I have said, you know that Plateau has different ethnic... uh... different ethnic groups.","As I don talk am, you know sey Plateau get different, different ethnic, eh different ethnic groups." "They have more than twenty three ethnic groups, on the Plateau.",De get more than twenty three ethnic groups on di Plateau. So just a local government alone has more than eight... more than ten.,"So just a local government alone dey get more dan eight, more dan ten." "So, as people are different with different ethnic groups like this, you know that their style of dress will differ.","So as people dey different wit different ethnic group like dis, you know sey deir type of dressing go differ." "In my local government particularly, our traditional uh... dressing, we are... we are... we are... our old women used to carry children in the back with... goat skin.","For my local government gangan, our traditional eh dressing self, we dey, we dey, we dey, our old women dey back pikin with eh goat skin." "You know that it's our traditional way of uh, uh... carrying a baby on our backs.","You know, that is our traditional way of eh eh backing a baby." "And you know people... some wear the agbada, some wear different costumes.","And you know people some dey wear agbada, some dey wear different attire." So we have that one here.,So we get dat one for here. "And then... uh... the delicacies, that means the food we eat in Plateau.","And den, em di delicacy, na im be sey di food wey we dey chop for Plateau." We have different varieties.,We get varieties. "Most especially, f-... like me, I like gote.","Most especially, f-... like me, I dey like gote." You know gote is a kind of delicacy which they prepare.,You know gote na kind of delicacy weh dem dey prepare. "At times, they use acha.","At times, dem dey use acha." What do we...?,Wetin we be... ? "What they call hungry rice, right?",Wetin de dey call hungry rice abi? "So, they use it to make that gote.",So dem dey use am make dat gote. "It's a light food, very soft food.","Na light food, very soft food." "When you have it, you enjoy it.","When you go take am, you go enjoy yourself." It makes you shine.,E dey make you dey shine. So they use um... spinach to do it with uh... uh... acha.,So dem dey carry em spinach dey do am wit eh eh acha. "They use uh... they use tomatoes, and some spices to, you know, garnish it.","Use some, em use tomatoes, and some spice to you know garnish am." "Uh... actually, we have uh... different types of dance, or dances (so to speak) on the Plateau.","Em, actually, we get em different types of dance, or dances so to say on di Plateau." And uh... there is...,And em e get... "Like in my place in Mangu Local Government, they use horns.","Like for my place for Mangu Local Government, dem dey use horn." "Some even use guinea corn, eh... um... the (what do they call it?), the stalks.","Some dey use even guinea corn, eh em di (wetin de dey call am), di stalk." "They blow it like uh... just like the horn too, animal horn.","Dem dey blow am like, eh just like di horn too, animal horn." "So, they call that one uh... Kwarak.",So dem dey call dat one em kwarak. Some call it uh... Nari.,Some dey call am em nari. "So we have different, different uh... types of dance.","So we get different, different eh type of dance." And uh... as the tradition is...,And em as di tradition be... "And then, about the festivals of Plateau State, we have all sorts of festivals also, uh... depending on uh... the zones.","And den, as relate to di festival for Plateau, we get different, different festival also eh depending on eh di zones." "Like the one in Pankshin, they have a festival they organize yearly.","Like di one wey dey Pankshin, de get festival wey dem dey em organize yearly." They call it uh... pus... mus... uh... pus... mus... something like that.,"Dem dey call am eh pus, mus, eh pus, mus sometin like dat." I can't...,I no fit... "Mtschew I've... I've forgotten, but I know there's a festival they organize like that.","Mtschew I don, I don forget, but I know sey e get festival wey de dey organize like dat." "In my place, we have it.","For my place, we get am." We call it Pus Cat.,We dey call am Pus Cat. "In Plateau here, the Berom organize it.","For Plateau here, Berom dey organize." They call it Zem Berom.,De dey call am Zem Berom. And so many others like that.,And so many oders like dat. Here in Plateau State.,E dey for Plateau. "So, uh... the languages, we have so many languages here on the Plateau.","So eh di languages, we get so many languages here on di Plateau." Uh... we have the br-... the major languages which uh... they speak in Plateau.,Eh we get di br-... di major languages wey eh dem dey speak for Plateau. "We have Berom, Tarok, Mwaghavul, Mopun, uh... Jarawa, the... you know, uh... Goemai, and so many of them.","We get di Berom, di Tarok, di Mwaghavul, di Mopun, di eh Jarawa, di you know ehn Goemai, and so many of dem." "So uh... actually, it's a place... it's a place...","So ehn, actually, is a place, na place..." Plateau is a place which uh... has different languages that people speak.,"Plateau na place wey ah different languages dey, people dey speak am." "My name is Joy, Joy Jatto.","My name na Joy, Joy Jatto." I work in this school where we are now.,I dey work for dis school wey we dey so. I live in Bukuru.,I dey live for Bukuru. I'm a native of Plateau State.,I be indigene of Plateau State. I live in Bukuru with my parents.,I dey live for Bukuru with my parents. "Uh... this Jos, as you see it, is a very beautiful state.","Uhn dis Jos, as you see am, na very beautiful state." "The weather, we don’t have any problem here.","Di weather, we no dey get any problem for here." We have good weather.,Better weather dey. The heat does not bother us at all.,Heat no dey worry us at all. "So, the people in Jos are very peaceful people, very friendly people.","So, people wey dey Jos na very peaceful people, very friendly people." They don’t look for trouble at all.,De no dey look for wahala lailai. "Uh... in my university, I studied French.","Ehn for university wey I go, na French I read." "So, I... then I got a job here.","So, I con dey, I con get job for here." I work here.,I dey work for here. Uh... we have plenty of the tourist sites in Jos.,"Ehn di tourist site wey we get for dis Jos plenty, many." "We have the zoo, the wildlife park, the museum.","We get di zoo, di wildlife park, museum." "All those places, they are very beautiful.",All dose places de are very beautiful. "We can go to the zoo, go and see animals.","We fit go di zoo, go see animal." Animals which have been there for a long time.,Animals wey don tay. "The elephant, it's even over a hundred years old.","Elephant, e don pass hundred years sef." It's still there.,E still dey dere. We have snakes.,We get snakes. "All those animals which you'd never expect, they are...","All dose animals wey you never even expect, dem dey." They are in the zoo.,Dem dey di zoo. "And then in the museum, you will see a lot of pieces of art that are very beautiful.","And den museum, you go see plenty, plenty artworks wey dey very beautiful." You will like them.,Una go like am. It's fine.,E fine. "You can go there, go and buy things, take them home.","Una fit go dere, go buy carry am go una place." "Because in Jos, we have a lot of things.","Because dis Jos too, we get plenty things." We also have uh... different cultures.,We also get ehn different culture. "For instance me, I am a Berom girl.","Like me, na Berom girl I be." We are...,We dey... Our cultural food is gote.,Our cultural food na gote. "This gote, they make it with acha.","Dis gote, dem dey make am with acha." Even people who have diabetes... gote cures diabetes.,"People wey get diabetes sef, gote dey cure diabetes." It treats very many illnesses.,"E dey treat many, many sickness." "People come from outside, just to come and see what we are using acha for.",People dey come from outside just to come see wetin we dey carry acha dey do. We even use it to make pudding.,We dey even carry am dey do pudding. We can make acha pudding.,We fit make acha pudding. "Add your milk to it, and sugar.",Put your milk for inside and sugar. "It will help you, and you will like it.","E go help you, and you go like am." It's food for diabetic patients.,Na food for diabetic patients. "And if you don’t want have uh... a big uh... belly like this (people who have a very big belly) if you are eating acha, it will help the belly, make it go flat.","And if you no want to dey get ehn big ehn belle like dis people wey get big, big belle, if you dey chop acha, e go help di belle make e go inside." Acha is a very nutritious food.,Acha na very nutritious food. You make it with plenty of vegetables.,You dey make am with plenty vegetable. All those greens... you can buy them in the market.,"All dose green, you fit buy dem for market." "And this Jos, we don’t have any problem, as I told you.","And dis Jos, we no get wahala like I tell una." Our market... our things are very cheap.,"Our market, our things are very cheap." "If you go buy things in Katako market, if you want to buy cloth, the cloth is really, really cheap.","If you go buy things for Katako Market, if you wan buy cloth, di cloth dey very, very cheap." You shouldn't go to a uh... shop or a supermarket.,"You must not go for uhn boutique, abi na any other supermarket." "Go to Katako, buy your jeans, buy your shirt.","Go to Katako, buy your jeans, buy your shirt." "Really, really cheap.","Very, very cheap." Buy your sweater.,Buy your sweater. "As you can see, this town, it is very cold, you should go to Katako to buy your sweater.","As you see sey dis town, e dey very cold, you go Katako go buy your sweater." Very affordable.,Very affordable. Even brands.,With di label sef. You will see them there.,You go see am for dere. It’s a second-hand market.,Na okrika market. You'll see a lot of nice things you'll want.,"You go see plenty fine, fine things wey you want." And you can buy them for cheap.,And na small money you go carry buy am. We have different cultures in Jos.,We get different culture for dis Jos o. "Berom, Ngas... you know.","Berom, Ngas you know." "Ah, another food that Jos people like to eat, is dog.","Ah another food wey Jos people dey like to dey chop, na im be dog." That meat... they like eating dog meat in this town.,"Dat meat, de chop dog meat well, well for dis town." Jos people really like dog.,Jos people like dog. "Ngas people, Berom people (my own tribe), we like eating dog.","Di Ngas people, Berom people, my tribe sef, we dey chop dog well, well." "But me, I don't eat it with them, but dog is considered meat where I'm from.","But me I no dey follow chop o, but dog na meat for my place." It’s a delicacy.,Na better meat. "We also have uh... (among the tribes which are in this place), we have the Mangu, we have uh... the Ankwai.","We also get (ehm among di tribes wey dey dis place), we get Mangu, we get ehm Ankwai." "Ankwai people, they drink burkutu a lot.","Ankwai people, dem dey drink burkutu well, well." They are the ones who make burkutu.,Na dem dey make burkutu. Burkutu is a kind of local beer that they make.,Burkutu na dis kind local beer wey dem dey make. "Oh, Ankwai people drink it a lot.","Toh Ankwai people dey drink am well, well." Burkutu is very cheap here in Jos.,Burkutu dey very cheap for dis Jos. "It's a drink that if you drink it, and you don’t eat, it can make you fall down.","Na drink wey be sey if you drink am you no chop, e fit fall you for ground." But it's more the Ankwai people who drink it.,But na Ankwai people dey drink am pass. "Other tribes drink it too, but it's a local drink that Ankwai people are making, and it is very affordable.","Any oder tribe sef dey drink am, but na local drink wey Ankwai people dey make am, and e dey very affordable." "We have kunu, which we make, which is very medicinal as well.","We get kunu wey we dey make, wey dey very medicinal too." "That one is not alcoholic, it's not beer.","Dat one, no be alcohol, no be beer." Everybody can have that one.,Everybody fit take dat one. "It doesn’t need sugar, it doesn’t need anything.","E no dey put am sugar, e no dey put am anything." "They use kunu, and there are different types of kunu.","Dey use kunu, and di kunu dey of different types." "There's one for which we use, (uh... this thing), to do it, tiger nuts.","E get one wey we dey use ehm dis thing do am, tiger nut." We call it aya in Hausa.,We dey call am aya for Hausa. That kunu is very nice.,"Dat kunu dey very, very sweet." You don't even put sugar in it.,You no go even put sugar. "You will use aya, you will use dabino to make the kunu.","You go use aya, you go use dabino do di kunu." And it really helps people.,"And e dey help person well, well." "If you drink it, you won’t want to have, have sugar again.","If you drink am, you no go wan taste, taste sugar again." "Because that kunu, it is very very rich.","Because dat kunu, e dey very, very rich." Uh... we make soup.,Ehn we dey do soup. "As soup, we have miyan kuka ","For our soup, e get miyan kuka." That kuka is very tasty.,Dat kuka dey very sweet. "We cook it with plenty of mil-... meat like that, which will make the soup tasty.",We dey cook am with plenty mil-... meat like dat wey go make di soup sweet. Kuka.,Kuka. We have miyan taushe which they make with um...,We get miyan taushe wey dem dey make am with ehm... They use potash to make that soup too.,Dem dey use potash dey make dat soup too. It makes the soup tasty.,E dey make di soup sweet. Uh... there is masa.,Ehn e get masa. Jos people make a lot of masa.,Jos people too dey make masa. "Our own masa, we can make it with rice, we can make it with corn.","Our own masa, we fit make am with rice, we fit make am with corn." It depends on what you want to use it for.,It depends on wetin you wan carry am do. Which one?,Which one? You will just pick.,You go just select. "If it's the corn kind, you will make it.","If na di corn own, you go make am." It is tasty.,E dey sweet. "If it's the rice kind, you will make it.","If na di rice own, you go make am." People are buying it.,People dey buy am. It is really nice.,E dey very nice. "Early in the morning in Jos, you will see people in joints eating masa like how, in other places, maybe they would be eating ewa [beans], or something else, like that.","Early morning for Jos, you go see people for joint dey chop masa like di way wey for anoder place, maybe dem go dey chop ewa, or something else like dat." "But in Jos, it's masa.",But for Jos na masa. "We have masa joints where people will just gather to buy, waiting in line, buying masa to eat.","We get masa joint where people go just gather dey buy, dey queue, dey buy masa make dem chop." "Even if you're in the office, some people buy it and take it to the office.","Even if you dey office, some people dey buy am carry go office." "Some will, from the office, send their boys, or go there themselves to buy masa, and kunu.","Some from office go come send deir boys, or dem sef, dem go come dere go buy masa, and kunu." You will see them together.,You go see dem together. You will buy drinks.,You go buy drink. "Kunu, there's one which they make with rice, as I told you, there are different kinds of kunu.","Di kunu, e get di one wey dem dey make am with rice like I tell una sey different kinds of kunu dey." "There's that one they make with tiger nuts, the one which they make with rice.","Dat one wey dem dey make with tiger nut, di one wey dem dey make with rice, e dey." "So, if you don’t buy akara (which is the usual thing), you can buy and take masa and kunu.","So if you no buy akara (wey be sey na di usual thing), you fit buy masa and kunu take." "Okay, ladies and gentlemen, don't let this turn into a quarrel.","Okay ladies and gentlemen, make e no for bring quarrel." "Today is Monday, and uh... we're already moving to the different departmental behaviors.","Today na Monday, and ehn we don dey move to di different departmental behaviour." "Uh... they say a bird in hand, is worth uh... so many b-... so many millions in the bush.","Ehn de say a bird for hand, e worth ehn many b-... many millions for inside bush." But I'm saying that it's the bird in the hand that's the real bird.,"But I dey talk sey na di bird, na di bird wey de hold for hand na im be di real bird." "To avoid stories that touch the heart, ""I was there"", and ""I shall be there"" are two different things.","To avoid story that touch, I was dere, and I shall be dere are two different things." Are you with me?,Are you with me? Okay!,Ehen! "Frankly speaking, you see, uh... if, if you... when we... when we look like at life generally, we know that uh... someone is talking.","Kalapotedly, you see, ehn if, if you, when we, when we look like at life generally, we know sey ehn one person dey yarn." "Your words, right, are different from people... other, other people's words.","Your yarns ehn e dey different from people, oder, oder people's yarnings." "And if you... if you want to equate your words with other people's words, it'll drive you crazy.","And if you, if you want to equate your yarn with oder people yarning, you go tear your shirt." "You alone will go crazy, you alone will be disgraced and you alone will destroy your authencity as a spoilt brat.","Only you go throw yours away, only you go fall your hand, only you go tear your ajebo certificate." That's it.,Na so e be. Don't let it turn into a quarrel.,"Make e no for bring quarrel at all, at all." That's worse.,Na im bad pass. I was there and I shall be there are two different things.,"I was dere, and I shall be dere na two different things." Yes!,Ehen! "My mom's tummy is big and my mother is pregnant are two different things, to avoid stories that touch the heart.","My mama get belle, and my mother is pregnant na two different things to avoid story that touch." "What it is, we don’t know yet.","What it is, we never know yet." So that's how things stand.,Ehn so na di matter be dis o. "Well, the Professor has spoken.",Ehn di prof don yarn. The discussiont goes on.,Yarnings continue. "In fact, what are we saying?",Wetin we dey yarn sef? I don't even know.,I no even know. I'm just speaking my mind.,I just dey yarn my mind. "You understand, I'm just baring my mind, you understand.","You understand, I just dey tear my shirt you understand." People are just looking at me and they're wondering what I'm talking about.,People just dey look me dey wonder wetin I dey yarn. But all talk is about conversation.,But all yarn na yarn. "So as to not waste time, because if you say yours, I say mine.","Make e no for loss because if you yarn your yarn, I yarn my yarn." "All together, we call it a conversation.","All together, we call it yarnings." Are you listening to me?,Una dey hear me so? Many words are called multiple words.,"Many yarnings, dey call it multiple yarnings." That’s how it is.,Na so e be. Yes!,Ehen! "Um... uh... there's a saying goes ""before you shoot a bird, will you get its mother to fly away?""","Em ehn sey before you shoot bird, make im mama fly?" "Just hold the mother and the child together, lock them somewhere and give them food to eat.","Make kuku hold di mama, hold di bird together, lock dem for one place, give dem food to chop." They'll cooperate with you at once.,De go answer you once. Yes!,Ehen! What do I want to say again?,Wetin I wan talk again? "Myself, I've forgotten.","Me, I don forget o." Okay.,Okay. I'm MC Abi.,I be MC Abi. "I'm a comedian, and we are saying so many things uh... on the language issue.","I be comedian, and we dey yarn many yarns ehn for di langua matter." Uh... we are... we have different ways of referring to our father.,"Ehn we dey, we get different words we dey call our papa." "We call them 'pile', we call them uh... uh... 'pupsie', we call him 'old man'.","We dey call dem pile, we dey call dem ehn ehn pupsie, we dey call am old man." "So one day, we got together and were praying for God to bless me!","Na so one day, we come gather ourself together, come dey go pray sey make God bless me!" "It was, ""God bless me.""",Na God bless me. So I was praying for God to change my life!,I con dey go pray sey make God change my life! "And eventually, God changed my life!",Naim God change my life o! "My brother, then my prayer changed.","My brother, my prayer con change." "I got to the house and I was praying, ""Father, crucify my old man... crucify my old man.""","I reach house con dey pray o Father, crucify my old man, crucify my old man." That was how I prayed.,Na prayer wey I dey pray o. I didn't know that I was ta-... talking about my own flesh.,I no know sey na my flesh I dey ta-... talk about. "But my father heard me praying, and he thought I was talking about him.","But my pile con hear di prayer, con think sey na im I dey talk about." """Crucify my old man... crucify my old man.""","Crucify my old man, crucify my old man." And so my pi-... my dad took his gun.,Naim my pi-... pile carry gun o. "He pointed the gun at me saying, ""You want to kill me, but instead, I'll be the first person to kill you in this town.""","Face me say na me you wan kill, instead of you to kill me, na me go kill you first for dis town." "My brother, I spent two weeks in the hospital, with POP [Plaster of Paris] on my neck.","My brother, two weeks now I use for hospital with pop for my neck." "Limit my diction, limit my...","Limit my diction, limit my..." "Furthermore, my, my speech became really distorted.","Further, my, my diction was frustrated to di core." "So, I was like that, and I let the issue rest.","So na so I con be, I con comot for dat level." "Then, I graduated to the next point of expressional dimensional overture.",I con graduate to di next point of expressional dimensional overture. What did I say?,Wetin I talk? I don't know yet.,I never know yet. That's it.,Na so e be. "I'm hustling, that's it.","I dey hustle, na im be dat." "MC Abi, that's my name, do not forget.","Mc Abi, dat my name, make e no for loss." I'm here for your sake.,I dey hear for una. Yes!,Ehen! "Okay, the show I'm featuring on here is tagged, ""On a Lighter Note with MC Abi.""",Okay di show wey I dey do for here na On a Lighter Note with MC Abi. We're talking about so many things happening in society from uh... or from different perspectives.,"We dey talk about many things wey dey happen for di society ehn from, ehn or from different perspective." We're looking at life from the funny angles so that people won't be depressed.,We dey look life from di funny angle so dat people no go just dey serious. You're always walking about with your arms up as if your have boils in your armpits.,"Everytime, you just dey waka dey carry hand for up as sey e get boil for armpit." "You know, your... you will calm down.","You know, your, you will calm down." You won't...,You no go... "You know, you won't just squeeze your face like... as if your look reminds people of scarcity or austerity, or that people are on strike.","You no, you no go just dey squeeze your face like, as if sey your face dey remind people sey scarcity dey, or austerity dey, or people dey on strike." No!,No! We want us to be... everyone to calm down.,"Wan meh we, everybody dey calm down." There's enough problems around already.,Di weather don hot enough. "If you're having hot pepper soup while the weather is hot, you just want to make things worse.","If weather hot, you con dey go drink hot pepper soup for dis hot weather, na hot temper you wan dey, you wan get last, last." Yes!,Ehen! So what?,So what? "Everybody is trying to calm down, enjoy the groove, and enjoy what we are saying.","Everybody dey calm down, dey enjoy di groove, dey enjoy our yarnings." "We talk about lots of things: fashion, life, general trending issues (you know), post... plus political matters... everything, you know.","We talk about many things (fashion, life, trends), things wey dey happen generally (you know), post, plus political matter, everyting you know." We're just talking about it all.,We just dey talk about am. "So those are the things we talk about on the show known as ""On a Lighter Note with MC Abi"" and every day comes with its own gist.","So naim we dey yarn for On a Lighter Note with MC Abi, and every day get im own gist." "For example, today is Proverbial, Proverbial Monday.","Like today na proverbial, proverbial Monday." "We talk about different proverbs, explaining them with real life issues.","We talk about different proverbs, push different hole to the matter." We will tell you a proverb when people are...,We go tell you one proverb wen people dey... "When you hear it, naturaly, it is... it has a meaning, but we attach humor to it.","Wen you hear am, naturally, e be, e get im meaning o, but we dey attach our own humour into it." But they'll tell you that the downfall of a man is not the... not... it's not the end of his life.,"But de go tell you sey di downfall of a man, e say e no be di, not, it's not di end of his life." I say it's a lie.,I say na lie! It depends on where the man falls from.,It depends on where di man fall from. "Yes, because if the man falls from a tall... a very high building, and hits the ground, that means he's dead.","Ehn because di man fall from one tall, one very high building, fall for ground, e don die be dat." "That's... that's also known as ""Call to Glory.""","Dat dey, de dey call call to glory." "You are on your own, by yourself and with yourself.","You are on your own, by yourself, with yourself." "Yes, and on Tuesdays, we do trendy things, those things in vogue, you know, the things going on in town, in your neighborhood (you know), what's the... what, what happens to be the new thing, the new level... the rave of the moment.","Ehen so Tuesdays, we dey do trendy things, wetin dey reign, wetin dey (you know), wetin dey happen for di town, for your area (you know), wetin be, wetin, wetin be di new gist, di new level wey, wey de dey do for your side." "Then on Wednesdays, we talk about relationships, love matters, you know, you know...","Den Wednesday, we talk about relationship, wit love matter you know you know." "You know, this issue of ""I love you, I love you.""","You know, dis I love you, I love you." It looks... it’s turning into something else.,"E get, e get how e wan dey be." "The last time I was told that... when a chick told me, ""okay, if you know you really love me, would you die for me?"", I warned her.","Last time wey de tell me sey, wen one babe tell me sey ehen if you know you really love me, can you die for me, na me warn am." "I said, ""if you try it with me!""",I say if you try am! """How will I die for you?""",How I go take die for you? """Don't you know that the love I have for you is an undying love?""",You no know sey the love I have for you is an undying love? That's my escape route.,Na dere I take escape. Because I can't die for anyone.,Because I no fit die for anybody. Yes!,Ehen! "So on Wednesdays... I mean Thursdays, we talk about past events which happened many years ago, in those days when we were... when we were really living, and we compare it to what we have now.","So Wednesdays, abi Thursday we talk about the things wey don happen before, many years ago, in dose days when we dey, when we dey live life den, compare am to wetin dey happen now." "Like the poems we recite in those days, when we were in school; our poems are different from what they have now.","Like di poems wey de dey sing in dose days when we dey school, our poems different wit poems de sing now." "We recited poems like 'your canoe is out of shape, our canoe is in shape...'","We sing poem like una canoe bend, bend, our canoe go straight." Those were the kinds of poem we used to sing.,Na dose kind poem we dey sing. "You know, a bonga, a bonga... we don't know it.","You know a bonga, a bonga, we no sabi am." "But nowadays, all those children... their... the package... it doesn’t work out well.","But nowadays, all dose children, deir, di package, e no dey do." "So we do... we compare the things of those days with the things of, of... (you know), now... nowadays.","So we dey, we dey compare things of dose days, and things of, of (you know) now, nowadays." "How we go to school in those days... we put our slates under our armpits, we take...","How we dey go school dat time, we dey carry slate for armpit, we dey carry..." "Our slates were our... they were our modern-day day iPad, or tablet that we use now.","Our slates, na im be our, na im be our present Ipad, or tab wen una dey use now." It's the slate.,Na slate. We call it a blackboard.,We dey call am blackboard. A small one.,Small one. We wrote our ABCs and 123s on them.,"Dey write a b c, and one two three put." We held them under our armpits and took them to school.,"We hold am for armpit, carry am go school." "You know, we went schools for the sake of eating akara [bean cake] at that time.","You know, we dey go akara school dat time." That's the nursery schoool.,Na im be nursery school. "You know, different things.",You know different matter. We took water bottles with us.,We come carry water bottle for body. "All of us will drink with the same cup, from a big drum, at the long break period.","All of us go use only one cup for one big drum take dey drink water for, during long break." No.,No. For those long...,For dose long... Then we'd go... we'd drop one kobo each into a bowl to eat bread and akara.,"We go come go, we go come drop one, one kobo for bowl to chop bread, and akara." That was how we hustled back then.,Na so we take hustle o. I was in school at that time.,Na so I dey school dat time. "Then, l was asked to read the letters of the alphabet.",De come tell me sey make I read A B C. I sang the ABCs.,I come dey sing am A B C D E F G H. Then I got to a part in the song...,I come reach one place. M U M E O P.,M U M E O P. "Ah, that was how I understood it.",Ah na di way I understand am. So I took spu-... that was how I recited it.,Naim I take spu-... naim I take speak am. I said M U M E scopew.,I say M U M E scope U. U R O skecity.,U R O scarcity. "I said, ""stop there!""",I say stop dere! """Come and touch scopew on the board!""",Come and touch scopew for board! I told the teacher that I was f-... I was sick.,"I say teacher, I dey f-... I dey sick." "Mama said if I'm sick, I shouldn't touch anything on the board.","Mama say if I dey sick, meh I no dey touch anything for board." That was how I escaped in school.,Na so I take escape for school. There were different things which helped in training us in schools.,Different tings wey dey train for school. Confusion.,Confusion. Confusion.,Confusion. The teacher gave me math and English exercises.,"Teacher give me maths, and English." I failed.,I fail am. "I was provoked, and I went out to call my 'mile'.","I provoke, go call my mile." Mile is another name for mom in Warri.,Mile na name wey we dey call our mama for Warri. "I went out to call my mom, and I told her, ""come and see!""","I go call my mile, con say mile, come see o!" "Out of all the students in this school, they beat me saying that I don’t understand math and English.","For dis full school, de beat me say I no know maths and English." My mom showed up.,My mile show. A typical Urhobo woman.,Typical Urhobo woman. She warned the teacher.,E warn di teacher. """Teacher, you whipped my child.""","Teacher, you flog my pikin." He said yes.,E say yes. Uhuh?,Ehen? "She said ""okay, why did you whip him?""","Sey okay, why you flog am?" "The teacher said, ""because I gave him exercises in math and English, and he failed.""","E say because I give am maths, and English, e fail." The teacher said...,Teacher say... "My mom said, ""do you even understand math?""","My mama say you sef, you sabi maths?" "The teacher said, ""of course, I'm the teacher.""",Teacher say of course na me be teacher. "My mum said ""okay, if you understand math, then solve this one for me.""","Sey okay if you sabi maths, solve dis maths for me!" Mom mom gave the teacher a tough math exercise.,Mama con give teacher tough mathematics. She said okay!,E say okay! Some went to this place and some went to the other place.,"Some go dis place, and some go di oda place." How many remained?,How many go remain? "For two minutes, the teacher was confused.","For two minutes, teacher confuse." "The teacher said, ""lady, this isn't math.""","Say mama, dat no be mathematics!" "My mum said, ""come on, keep quiet!""","Mama say come on, keep quiet!" """You don't know that this is a simple math exercise.""",You no know sey simple maths now be dis. """If some went to this place, and some went another other place, only some will remain?""","If some go dis place, and some go di oda place, na some go remain?" Oh boy!,Oh boy! "For, for the next five uh... four years in school, the, the teacher didn't lay a finger on me.","For, for di next five, ehn four years for school, teacher no touch me o." "If you dare raise a cane up to beat me, I'll just say that I'll get my mom to come after you.","If you just raise cane up like dis, I go say I go call mama for you o!" I threatened the whole school with the news of my mom coming.,I use my mama threaten di full school. That was how I continued till I left... finished my primary school education.,"Na so I take comot, take finish my primary school." So don't forget that.,So make e no for loss. "(You know), we picked different things from our neighborhood.","(You know), area don develop us." Neighborhood... our neighborhood raised us.,"Area, area don arrange us." You know that a frog's eye... you get things done because you're smart.,"You know sey Okpolo eye, you chop because you get big head." Not because you are the general overseer.,No be sey you be general overseer. You don't understand?,You no understand? Uh... people say that the monkey got smart because the trees are closely connected.,Ehn de say na because tree near tree na im make monkey dey smart. "If the trees are far apart, you'll see that monkeys will go under, buy pure water, board a motorcycle, and use a handkerchief because the weather is hot [meaning that the monkey will apply wisdom].","If tree far from each other, you go see monkey go jump under, go buy pure water, go enter okada, use handkerchief because weather hot." Do you understand?,You understand? "Don't let it cause a quarrel, my brothers and sisters, understand!","So make e no bring quarrel my brother, and sisters ehen!" That means I have been speaking with you.,Na im be sey I be dey yarn with una o. The conversation continues.,Di yarnings still continue. Kanapotelli zaga za.,Kanapotelli zaga za. What does that mean?,Wetin e mean? I dunno.,I no know. I don't even want to know.,I no even wan know. Get out!,Get out! Your father!,Your father! """Your father"" is a greeting.",Your father na greeting. It's not a curse!,No be curse o! Thank you!,Thank you! "Hello, my people!",Hello my people! "It's me, Chibozor Chilaka.",Na me Chibozor Chilaka. We're in Jettan right now.,Na Jettan we dey so o. "But I don’t have much to say, but I will go ahead and say that life is not easy.","But I no get much ting to say, but I go lead us go dis way sey life no dey easy o." You're supposed to know what's happening now in this country.,Una suppose know wetin dey happen now for dis country. "So many things are happening, but we will still thank God for life.","So many tings are happen, but we go still tank God for life." "No matter how hard life is, we should remember we have God.","No matter how hard life dey, but meh we remember sey God dey." "Because when we have God on our side, everything will keep moving forward, even though if you try to serve God, temptation will still be coming your way as the young man that you are, or the young woman that you are.","Because when we get God by our side, everyting go dey move even dough if you try sey you wan serve God, temptation go still dey come your way as a young man wey you be, or a young girl wey you be." "But what... you will still know that no matter how you try to do it, problems will still come your way.","But wetin you go still know sey no matter how you try do am, problem go still come your way." But that does not mean you should give up.,But dat one no mean sey una go give up o. "And even, even though you are trying to serve God as the young man, or young woman that you are, people will still be telling you ""what are you doing?""","And even, even dough you dey try to serve God as a young man, or young girl wey you be, people go still dey tell you sey wetin you dey do?" Are you sure of what you are doing?,You sure of wetin you dey do? But's leave that aside for a moment.,But moh leave dat one for now. Let's keep talking about what is happening.,Moh still talk about wetin dey happen. "Anything happening now in this life, right, you should first put... you must first involve God.","Anyting wey dey happen now for dis life bah, meh first put, you must put God first inside." "And, if you don’t in-... involve God, by God, you are wasting your time.","And, if you no put God insi-... inside wallahi, you dey waste your time." "So whatever you are trying to do, you should... you should... you should try as a young person to be building things up.","So anyting wey you dey try do, meh, meh, moh try as a youth dey build up tings." "You know, let's try to be building our... to build our life up.","You know moh try dey build our, build life up." "Try to do things which we're supposed to do and we should remember that even in the uh... the Bible in, in Proverbs, it tells you that you should try to remember your Creator when you are young.","Try dey do tings wey we suppose do so, and moh remember sey even for ehn Bible, for Proverb, e tell you sey meh try remember your creator when you dey young." "Because if you don’t serve God now, you don’t know when you will serve him next.","Cause if you no serve God now, you no know when next you go serve am." Will it be when you've grown old?,Abi na when you don old? "Because even though, if you remember well in the Bible, Cain and Abel... Cain... you're supposed to know how Cain, and Abel's case ended.","Because even dough, if you remember for Bible well Cain, and Abel, Cain, you suppose know how Cain, and Abel own take end." "Because Cain, he, he was a farmer, he gave God something that’s not good while Abel, he gave God something good.","Cause Cain, im, im be farmer, im give God wetin no good while Abel im give God wetin good." "So, if Cain, and Abel could know what they were supposed to give to God, (one gave God something good and the other one did not give God something good), so now those of us who are youths, is it when we're old that we want to serve God?","So if Cain, and Abel fit know wetin de suppose give God, (one give God wetin good, and one no give God wetin good), so now we wey con be youth, na when we old now we wan con serve God." "But that does not mean... that does not mean that we will not live our lives as youth, but if we are living our lives as youth, we should still remember that there is God.","But dat one no mean, dat one no mean sey we no go live our life as a youth, but if we dey live our life as a youth, moh we still dey remember sey God dey." He is in charge of everything we are doing.,Im dey take charge of everyting wey we dey do. "And anything we are doing now, in the future, we will still pay for it.","And anyting wey we dey do now, for future, we go still pay for am." "Whatever we eat now, whatever we drink now that enters our body, in the future, we will still pay for it.","Any kind ting wey we eat now, anyting wey we drink now wey dey enter our body, for future we go fit still pay for am." "Whether we drink, we smoke... we will still pay for it in the future.","Wheder we dey drink, we dey smoke, we go still pay for am for future." "So anything we are doing now in our days of youth, we should remember that life is still ahead of us.","So anyting wey we dey do now for youth, moh remember sey life still dey front." You don’t know what is ahead.,You no know wetin dey happen for front. "And to cut it short, let me talk about... let me talk about Nigeria's problems.","And to cut long matter short, moh still talk about, moh still talk about Nigeria problem." "So many things have been happening now because our government, they are really not doing what they're supposed to do for us.","So many ting don dey happen now because our government, in true, true, no dey really do wetin dey suppose do for us." We all know that there are problems left and right.,"We all know sey problem dey up, right, left, and centre." "We're talking about Boko Haram, we're talking about the IPO, we're talking about Oduduwa.","We talk of Boko Haram, we dey talk of IPO, we talk of Oduduwa." So many things are out there now which even our government doesn’t want to come out to tell us the truth about.,So many tings dey on ground now wey even our government no wan come out con tell us di truth. It's been a long time since they told us that we are the leaders of tomorrow.,E don tay wey de tell us sey we be leaders of tomorrow. But when are we going to become the leaders of tomorrow?,But for when we wan become leader of tomorrow? Is it when we're old?,Na when we don old. "Now, if we look at it very closely, we don’t have any youths today who are coming out to say that they want to run for anything.","Now if we look very well, we no get any youth today wey dey comot say im wan con contest for anyting." "Most of all, you will see us on social media.","Highest, you go see us for social media." "We are always playing with some phone, we are taking selfies, we are doing all kinds of things.","We dey always press one phone, we dey do selfie, we dey do every kind of ting." "Yes, that is good for those of us who are youths.","Yes dat one good for we dat, wey be youth." "Hey, I'm not saying that social media is bad.",Tah I no talk sey social media dey bad o. It's good for us.,E good for we. "But, we s-... try our best, try to build ourselves up to become youths because if (like me) talk has never come out that I want to ru-... run for gover-... governorship now, you will tell me that I am a young man.","But, make we s-... try our best, try build up oursef to become youth because if (like me) dey talk never comot say I wan con-... contest for gover-... governor now, una go tell me sey I be young man." That I haven't reached that age.,Sey I never reach di age. "If you don’t vote for me, who else do you want to vote for?","If una no vote for me, who else una wan vote for?" "It's the same leaders that are giving us the, the same recycling thing that's happening.","Na di same leaders wey dey give us di, di same recycle ting wey dey happen." They will bring another man today.,De go bring anoder man today. "That man, if he doesn’t rule, he will put forward his own child.","Dat man, if e no rule, im go bring im own pikin." His own child will put forward his own child.,Im own pikin go bring im own pikin. You and I would still be getting the same thing which we are getting.,Me and you go still dey collect di same ting wey we dey collect. They never im-... improve our lives in any way.,De no dey ever im-... improve our life in any way. So as youths let's try to build ourselves up.,So make we as a youth try to build up oursef. "Let's try and believe in ourselves, and let's try to support one another.","Moh we try believe in oursef, and moh we try support each oder." Let's not look down on anyone who decides tomorrow that he wants to work for the betterment of this country.,Moh no look down on anybody wey decide tomorrow sey e wan contest for di betterment of dis country. "And mstchew another thing is that we, as youths, we need to be building ourselves up.","And mtschew anoder ting be sey we as a youth, we need to dey build oursef." "Schools are only... where we are going can't make us become better people because these schools are garbage in, garbage out.","School dey only wey we dey go no fit make us become better people because dis school na garbage in, garbage out." This country for a long... how many years since we... they gave birth to us up until now?,"Dis country for long, how many years since when we, de born us up till now?" Nothing is changing.,Noting dey move. "Instead, things have gone from bad to worse.","Rader, tings dey dey bad to bad." "Even our parents tell us that when they were much younger, things (back in their day) were better.","Even our parent go tell us sey when de dey much younger, tings (during deir own time) dey better o." "Now (we are here now), things are still not better for us.","Now (we don reach now), our own tings still no dey better." Is this good?,Na better ting? It's not good at all.,"No be better ting na, be dis now." "If you go to other countries, they are progressing.","If you go oder countries, de dey increase." They are doing research all the time.,De dey do research every time. Things are always progressing for them day by day.,Tings dey always increase for dem day by day. They always try to do things which will be better for them in the future.,De always try to do tings wey go better for dem tomorrow. "Even some people, in their countries, they are mostly using schools... people who are educated.","Even some people, deir countries, de dey mostly use schools, people wey go school." Though maybe one department can decide to do some research.,Dough maybe one department fit decide to do research. "The research that student did, that is what will help the country.","Dat research wey dat student do, na im go help di country." "Before you know it, they have developed.","Before you know, de don increase." "Before you know it, other people will come around, to, to buy things for the, the same school!","Before you know, oder people go come around, come, con buy tings for di, di same school o." It's from that school that they bring about development.,Na dat same school na im dey bring about development. "But here in Nigeria, nothing like that is happening.","But for here for Nigeria, noting like dat dey happen o." "If you and I do research, we will go to a computer... or we will go to a cyber café, or we will go to our school lab to collect what someone else has done.","If me, and you do research, na computer we go go, or we go go cyber cafe, or we go go our school lab go collect work wey person don do." To do the same old things which someone else has done.,Dey do di same old ting wey person don do. We will still be doing the same thing.,We go still dey do di same ting. So tell me how we want to progress today.,So tell me how we wan take grow today. We will not be able to grow if this continues like this.,We no go fit grow if dis ting continue like dis. So we need to hold our leaders accountable for everything they are doing for us.,So we must hold our leaders accountable for everyting wey de dey do for us. "Because if we don’t hold them accountable, this country will not move forward.","Because if we no hold dem, dis country no go move forward." "And the problem with us is that we, we are afraid.","And di problem wit we, sey we, we dey fear." "If a man comes out today to say he wants to re-... do... he wants to start a revolution, this one will run out saying he is not involved.","If one man comot today say e wan re-... do, e wan cause revolution, dis one go run comot say im hand no dey." "If you go to other countries, developed countries, they don’t hesitate the way we do, they only do what helps them develop.","If you go for oder country, wheder developed countries, de no get two head wey we get o, only wetin help dem to develop demsef." "They put religion aside, put (uh... what do they call it), ethnicity aside.","De leave religious aside, leave (ehn wetin de call am) ethnicity aside." They just embrace one thing which is unity.,De just embrace one ting which is unity. "And that unity, is what... brought about that development for that country.",And dat unity na bring about dat development for dat country. My name is Edewoh.,My name na Edewoh. Or the way it's called in my... in my area is Edewo.,"Or di way de dey call am for my, for my area na Edewo." Because uh... I'm a Delta boy; I'm Urhobo.,"Because eh I be Delta boy, I be Urhobo." "And uh... I come from a family of six, and I'm the fourth born, actually","And eh I come from family of six, and I be fourth born actually." "But initally uh... while growing up, because it's... it's... it's... I was born in Lagos, you know, my mom and dad... we speak English there, mostly, because they wan-...","But initially eh, growing up, because sey na, na, na, na Lagos de born me you know, my papa and, mama, we dey speak English dere mostly because de wan..." The whole idea of...,Di whole ehn idea of sey ehn... "To know a kid who, who's educated, they're supposed to speak English really well.","To know pikin wey, wey don go school, e suppose dey speak English very well." So they started from when they were little.,So de start from small. "English was the language they used... they, they... that they spoke to us in.","Na English de dey use us, dey use, dey, dey, dey follow us talk." "So, it also has its down sides because here as we speak, I can't speak my language.","So dat one self con get im own bad side because, as I dey like dis, I no sabi speak my language." "Haha, something like that.",Haha dat kind thing so. It's more like that.,Na more like dat. "And I... (you know then), I associated with people as I grew up, and I realized that people speak different languages.","And I con (you know den) association with people as I dey grow, I con dey see sey ah people don con dey speak different." "It... it's like I'm an outcast in Lagos, where I stay.","E, e con be like sey I be outcast for inside Lagos wey I dey." "You know, people speak different languages.",You know people dey speak different things. "I figured, ""ah, everyone's supposed to be speaking English.""",I con dey ah but na English everybody suppose dey speak. """What language is this Pidgin that people are speaking?""",Which one be dis Pidgin wey people dey speak? "You know, so I started picking it up little by little, I started to learn to speak it little by little, but uh... you know that every time you go back to the house, you'll be expected to speak English.","You know so I con dey pick am up small, small, I con dey learn am small, small, but eh you know sey everytime wey you go back house, na still English you go speak." So I couldn’t master the language.,So di thing still no dey sink. "You know, so, I started...","You know so, I con..." "You know be-... um... because I used to act, I used to work at another radio station before, before I came to... before I came to Wazobia, so since I resumed in Wazobia, it's more like...","You know be-... ehn because I bin dey act, I bin dey work for one oda radio station before, before I start to, before I come ehn Wazobia, so as I come Wazobia now, na more like sey..." "Okay then, since they, they employed me to speak English on Cool TV, because at that time... we had Cool TV at that time, so was I hired to speak English.","Okay den, as de, de employ me for English for Cool TV (because dat, dat time, Cool TV dey), so de employ me for English." As d-... I... as I...,"As d-... I, as I..." "I still remember the way I perfomed in the audition, where, where my MD said, ""now, speak Pidgin so we can hear how it'll sound.""","I still remember di day wey I do di audition, wey, wey my MD talk sey oya, speak for Pidgin mey we hear as thing take be." That’s how I started.,Na so I start. "He said no, no, no, no, no, no.","E say no, no, no, no, no, no." I should speak English because it's like my spoken English is better.,Make I speak English o because e be like sey na di English na im make sense pass for me. "I said, ""ah, there's a problem.""",I say ah wahala dey? "He said, ""no, don't worry, don't worry, don't worry!""","E say no, no worry, no worry, no worry!" He said that my spoken English was alright.,E say di English dey alright. I should just stick to speaking English.,Make I just dey for di English. "You know but as time went on, they hired me here, you know.","You know but as time con go on, de con employ me for here you know." So I started working.,I con start. "We were broadcasting in English, we were... we were... we, we were broadcasting in Pidgin.","We dey do English, we dey do, we dey do, we, we dey do Pidgin." "Then, uh... there were some logistical issues, there were some technical issues.","Den, ehn some kind ehn logistic issues con happen, technical issues con happen." So we merged Cool TV into Wa-... Wazobia.,We con merge ehn Cool TV into Wa-... Wazobia. "Then, everybody had to speak Pidgin.",Nain everybody con start to gats dey speak di Pidgin. "Me, I started wondering, ""ah, the Pidgin language I've been running away from has caught up to me right here!""","Me, I con dey wonder sey ah dis Pidgin wey I don dey run from since don con meet me again for here!" "That’s how I started, and I'm still here, and I'm growing.","Na so I start o, and I still dey be here, and I con dey grow." Then I re-... uh... I realized that Pidgin is not a language that's meant for people who don't sa-... who aren't uh... intelligent.,I con re-... eh realize sey di Pidgin no be ehn language for people wey no sa-... wey no ehn dey intelligent. "It's for Nigerians who wanna communicate, who wanna reach as many people as possible.","Na for people wey be Nigerian, wey wan communicate, wey wan cut across." "Because since I don't speak my language now, I'm sure that if I go to Sapele, or Delta and I speak Pidgin, I'll be able to communicate with the people over there; but if I speak English, they'll be looking at me like, ""ah, buddy, you should know that we don't speak that language here.""","Because as I no sabi speak my language so, I know sey if I still enter ehm ehm di Sapele, or enter di Delta speak Pidgin, I go fit relate to people for dere, but if I speak English, de go dey look me like sey ah bros we no dey speak dis language for here now." """We speak Uhrobo.""",Na Uhrobo we dey speak now. """Why don't you speak the language we understand?""",Why you no speak di one wey we know? You know.,You know. "So... but I realized that Pidgin... anywhere I go... (because I can say that I've been to as many as eighteen States in this country), and everywhere I go, Pidgin paves the way for me.","So, but I con realize sey di Pidgin, anywhere wey I go (because I fit talk say I don travel go like eighteen states for dis, for dis country), and everywhere I go, Pidgin dey always dey represent." "Even if it's not the same type of Pidgin they speak in Warri, but it's the one of I-... I-... Ibadan or it's the one of Abuja, you will realise that if you speak any kind of Pidgin, it works.","Even if sey no be di same kind of Pidgin wey dey Warri, na im dey I-... I-... Ibadan, na im dey ehn Abuja, you go realise sey if you speak any kind Pidgin, e dey connect." "People will still understand you, um... uh... what you're saying.","People go still understand you, ehm ehw wetin you dey talk." "So that's why I appreciate this platform because since I've been here, I haven't been lost.","So na why I con even thank di platform say as I don dey here so, I no still lost." Because if I s-... if I get to a place where I'm expected to just speak English... I'm expected to be speaking... I'll be able to speak it and get along.,"Because if I s-... if I reach where na only English de want make I dey speak, I go dey speak am, we go dey flow." "If I get to where I need to communicate with people (you know), where I have never been to before... if I want to go to a new place, I'll just be speaking Pidgin.","If I reach where I need to communicate with people for (you know) where I no know before, if I wan go new area, na Pidgin I go dey speak." So I started building up my vocabulary... I started building it up.,"So di thing con dey build up, e con dey build up." "Yes, I realized that even right here, we were... we, we, we treated Pidgin like an, an international language.","Aha I con realise sey for here too, we con dey, we, we, we con package Pidgin like sey na, na one, na international hehe language." People will be...,People go dey... "Because myself, I, I organize shows where I... I... I... I go on the Red Carpet; I interview people.","Because me, I dey, I dey do shows wey I dey, I, I dey, I dey, I dey go red carpets, I dey interview people." "So I'll dress really well, dress co-... in a fashionable way; in an official way; put on suits, everything.","So I go cack well, dress co-... confirm o, cack well, wear suit, everything." "And people will recognize my presence, saying ""okay, he's from Wazobia, okay"".",And people go con stand okay yes na Wazobia okay. "I want to tell the person, ""we speak Pidgin, hope you don't mind.""","I want tell di person sey hope sey you no mind, na Pidgin we dey speak o!" "They'll say, ""oh, we'll be speaking Pidgin?""",Di man go say aha na Pidgin? I say yes.,I say yes. "They'll say uh... uh... you know, ""oh yeah? But you know I don’t speak Pidgin very well.""",Sey ehn ehn you know sey ehn I no too sabi. "I say, ""Ma'am, you're a Nigerian, right?""","I say Madam, na Nigerian you be abi?" """You'll speak this language.""",You go speak dis thing. "They said, ""alright, alright, alright, let's try it out, let's try it out.""","E say oya, oya, oya mey we try, mey we try." "And (so far so good), it's like anytime people see me on the Red Carpet, they'll want me to interview them because they know that this guy will want to speak Pidgin, not in English which we'll be struggling to speak.","And (so far so good), e con be like sey anytime wey people see me for red carpet, de go wan come make I interview dem because de know sey dis guy, na, na Pidgin e wan talk, no be di English wey we go dey struggle to speak." We'll just be free.,We go just dey free. "We'll relate so well, you know.",We go dey relate you know. "So from here, the thing started to build up.","So from there, di thing con dey build up." There was awareness.,Di awareness con dey. "Everywhere we go, they say, ""ah, it's wo-... Wazobia.""","Everywhere where we go, de say ah na wo-... Wazobia." You speak the best Pidgin.,Na una dey speak Pidgin pass. That’s your work.,Na una work be dat. "You know, so it started building up its own uh... level of acceptance, across... everywhere.","You know so, di thing con dey build im own ehn level of acceptance, across, everywhere." "There's no event we attend, even if the Pre-... President will be coming...",No event wey we go even if sey na pre-... president dey come. You know I... there was a day I... that I interviewed the Minister of Information.,"You know I, dere was one day wey I, wey I eh interview di Informations Minister." That's uh... Lai Muhammed.,Dat na ehn Lai Muhammed. "And he, he, he, he, he was asking me ""how far now? So, how will it go?""","And im, im, im, im, im dey follow me dey talk sey how far now, so how will it be?" "I, I said, ""No Sir, we speak Pidgin here.""","I, I say no Sir, na Pidgin we dey speak for here." "He said uh... ""ah, alright, let's do it now, we are Nigerians, this is our language.""","E say eh ah oya make we do am now, na Nigerian we be, na our language." So we started speaking.,We con dey flow. "So pi-... people who interviewed him before me saw us laughing, cracking jokes, laughing... ah.","So pi-... people wey dey interview am before con see sey we dey laugh, we dey crack joke, we dey laugh ah." "So they were wondering what I was telling him that, that was making him laugh so much... that was making the old man laugh so much.","De con dey wonder sey wetin I dey tell am wey, wey bros dey laugh like dis, wey papa dey laugh like dis?" What was I telling him?,Wetin I dey tell am? "I said ""ah!""",I say ah! "Then I realized that, wow, this Pidgin brought us together.",I con realise sey omo na dis Pidgin na im make us connect like dat. We finished the interview.,We finish di interview finish. "He shook my hand and he said, ""well done, young man; this is good, this one is... this is Nigerian.""","E shake my hand, e say well done young man, correct, dis one wey, dis na Nigerian." "I said, ""yes sir, we’re doing our best, we’re doing our best.""","I say yes Sir, we dey try, we dey try." "So that’s the platform that uh... Wazobia has created for us, which made us realize that Pidgin English isn't just the language of the uneducated.","So na di platform wey ehn Wazobia con create for us be dat, wey con let us know sey dis Pidgin English no be language wey be for people wey no s-... wey no sabi." "It's not a language that, that people that are...","No be for language wey, wey people wey be..." "Because they say it's for the people on the streets, it's for uh... the riffraff.","Because de dey call am sey na for people wey dey street, na for ehn low life people." They're the ones who speak Pidgin.,Na im dey speak di Pidgin. But then you realize that it’s the only language that cuts across Nigeria without any issues.,But you now con realise sey na di only language wey cut across Nigeria without any stress. Yo can go anywhere now if you... if you note... if there...,"You fit go anywhere now if you, if you note, if dere..." "Some time... some time ago, when I... when I went to SA, I w-... I went to South Africa, and I was just... because it's... it's English, we believe everybody will understand.","One, one time wey I, wey I go SA, I g-... I go South Africa, and I just dey because na, na English we believe sey everybody go dey understand." "But when I was there, I went into a mall and I saw a black guy.","But as I con dey, I just enter one mall, naim I see one black man." "Me and the guy, we were just chatting in Pidgin because we want... we didn't want... we didn't, didn't want anybody else hear what we were saying.","Me, and my guy, we just dey talk for Pidgin because we wan, we no wan no, make, make de hear wetin we talk." "We were just talking in Pidgin, so the man asked me, ""ah, man, how far? Are you a Nigerian?""","We just dey talk for Pidgin, nain di man just tell me sey ah bros, how far, you be Nigerian?" "I said, ""oh, you understand, right?""",I say oh you understand abi? Yes.,Hehe. "I said, ""good, good, yeah, I'm Nigerian.""","I say correct, correct, yea I be Nigerian o." "He said he himself is Nigerian, but he's been here for almost twelve years.","E say im sef na Nigerian o, but e don dey here for like twelve years." "I said, ""aha, hope you are... will you be coming back to Nigeria?""","I say aha hope sey you dey, you dey come back Naija?" "So I said... he said he comes back every year, but he is w-... uh... working in South Africa.","So I say, e say im dey come back every year sha, but im dey w-... ehn work for South Africa." "I said ""ah, good, good!""","I say ah correct, correct!" "So I realised that Pidgin, on its own, has gotten to a level where...","So I now realise sey as e dey like dis, Pidgin on im own o, ah e don reach where..." "But I, I know that if, if, if given a little time now, it can get to the level where French uh... where English can be above it.","I, I know sey dough, if, if, if na small time now, e go fit reach level wey French, ehn wey English fit con top am." "You know, it will create its own...","You know, e go create im own..." "Because as it is, the Ghanaians have their own version of Pidgin, Nigerians have their own version of Pidgin, the people at Cotonou have theirs too.","Because as e be like dis, di people for Ghana get deir own Pidgin, people for Nigeria get deir own Pidgin, people for, for Cotonou get deir own." "You know, in the different countries... in the West African countries, they have their own different versions of Pidgin.","You know, for different countries, for West African countries, de get deir own different kind of, of Pidgin." "So we know that with time, it'll grow.","So we know sey with time, e dey grow." "With time, it, it, it's growing.","With time, e, e, e dey grow." "So, well, basically, as... with the shows I organize, which give me the opportunity to interact with people every day, which take me to events in order to interview them... it's mostly in Pidgin.","So basically sha, as, as di shows wey I dey do, wey dey make me dey interact with people everyday, wey I dey go events dey interview dem, na mostly Pidgin." "Even if I have a white guy on the Red Carpet, I'll tell him, ""hey man, we speak Pigdin here in Nigeria, will you like to try it?""","Even if I see white man on top red carpet, I go tell am Baba, for Nigeria o, we dey speak Pidgin, you go fit try?" "He'll say, ""let's do this, let's do this"", and he'll try to speak the language as best he can because he himself wants to identify with the, the language.","E go say ah let us do dis, let us do dis, and e go dey speak am di way e fit speak am because im sef wan identify with di, di language as e be." "So that's, that’s the basic thing we, we do.","So na, na di basic thing wey we dey, wey we dey do be dat." "So one of the interesting things about journalism is that they say, they say that even when you have issues you want to discuss, people's attitude can bring out another issue which can lead to another story entirely.","So dat na some of di interesting part about journalism wey be sey as in de dey talk sey dem say even when you get issue wey you wan discuss, people attitude fit bring out anoda issue wey fit lead to anoda story entirely." "So, okay, uh... I remember the time the Americans wanted to hold their election.",So okay em I remember di time wey America be wan do election. "That was two thousand and eight, that time they wanted...","Dat na two thousand, and eight dat time wey dem go wan..." Obama ran.,Obama im contest. "And fortunately, I was one of the journalists that went to cover what happened there.","And fortunately, I be one of di journalist wey go cover wetin dey happen for dere." "So, as I travelled, I started uh... I started to interview one, two, three people.","So as I travel now, I begin, hehe I begin interview one, two, three people." "And I noticed the issue everybody was discussing was Obama, Obama.","And I notice sey di issue wey everybody dey discuss, Obama, Obama." "The young people, that time, everybody I spoke with, (whether white, black, or Asian), everyone was talking about Obama.","Di young people, dat time, eveybody wey I talk, weda na white, weda na black, weda na Asian, everybody Obama." But the old folks weren't interested.,But di old people no dey interested. And I wondered why.,And I bin even wonder like why? Why aren't you interested.,Why una no dey interested? Because they said...,Because de say... "There was an old man I asked, he said it would... it wouldn't make any difference.","E get one old man wey I bin ask, e say e go, e no go make any difference." That is is just normal excitement.,"Sey na just normal jumpy, jumpy." Everybody is just happy.,Sey everybody just dey happy. "That well, a new person, a black man, and all that!","Sey oh new person, black man, and all dose tings!" "But at the end of the day, it's like most of the old people were just not interested.","But at di end of di day, e be like sey most of di old people no just get interest." "Because they said mstchew, we have done this kind... this kind of thing before.","Cos de feel say mtschew look we don do dis kind, kind tin before." That's how it is.,Na so e be. "A new person will come, everybody will be shouting hey hey hosanna but when things get serious nothing will change.","New person go come, everybody go dey shout hey hey hey hosanna, but when matter con be matter, everyting go remain di same." "So, I just saw at that time, a lot of young people were interested.","So I just see sey dat time, a lot of young people dey get interest." "I went to New York, I went to uh... Texas, I went to Washington.","I go New York, I go eh Texas, I go Washington." "Most of the young people in America at that time, they wanted to vote.","Most of di young people wey dey America dat time, de wan vote." "Many of them, had never voted in their life.","Many of dem, de never vote for deir life before." "So to them, it was an interesting opportunity.","So to dem, na interesting opportunity." It was the first time.,Na di first time. "And many of them who voted that time, did it because of the internet.","And many of dem wey vote dat time, na because of internet." It was the internet that gi-... brin-... motivated them to vote.,Na internet gi-... brin-... ginger dem make dem go vote. "Because before, many of them, you know it was on TV, radio, everybody was talking but that time when Obama came, he started this idea of a Facebook campaign.","Because before now, many of dem, you know sey na for TV, radio everybody dey talk, but Obama dat time wen e come, na im start dis idea of Facebook campaign." "Vote for me, donate for me, support me.","Vote for me, donate money, support me." "Everybody, young people, high school students, people who are just entering university, polytechnic.","Na everybody, young people, secondary school student, people wey just dey enter university, poly." Everybody got together.,Everybody gather. They gave him the votes.,Na dem give am di vote. "So, it was at that time that I realized social media was a powerful tool.","So na dat time I con know sey social media, na powerful tool." And it is one of those things that hepled the guy win the election.,And na one of di tings wey help dat guy win election. "As we can see now, everywhere we go, social media is powerful.","And now, as we see now, everywhere wey we dey go now, social media dey powerful." "Even if you look, yesterday, on social media, Facebook, the main thing everybody was talking about was DNA.","Even if you, if you be observe, yesterday, for social media, Facebook, di main ting wey everybody dey talk about, na DNA." DNA.,Dna. D-...,D-... I don’t know who started that discussion.,A no know who start dat discussion. "Until this morning, everybody was talking about it.","But up till dis morning, everybody don dey talk about am." Because...,Because... I then asked what started that discussion.,I con ask okay wetin start dat discussion? "They said it was because a guy discovered the four children he had, were not his.",Dem say na because one guy con discover sey di four children wey im get no be im own. "Those children however, had already become adults.","And dose children, de don already become adult." "So, the debate started.",So di debate con start. Everybody!,Everybody o! "Some, some people are asking if it is good for a man to have, to go test his children?","Some, some people dey ask e good make man get, go test im children?" Should he... should he... should he confirm that those children are his?,"Make e, meh e, meh e be sey na im get dose children?" Some people say it's unAfrican.,Some people say na un-African. Don't do that kind of thing!,No dey do dat kind tin! It is... it... it... it's not in our culture.,"Dat it is, e, e, e no dey our culture." "Some people say ""Why? Why can't we do it?""","Some people say why, why we no fit do?" "So, social media is a very powerful tool that can make or break anybody.","So, social media, na very powerful tool wey fit make, or break anybody." Uh... my name is John Nkemjika Nwobo.,Ehn my name na John Nkemjika Nwobo. I come from Imo State.,I come from Imo State. "Well my people, I mean, things are difficult.","Well my people, as in things no easy now o." "Because uh... I remember, that in Jonathan's era, everyone was just showing off, but things are difficult under this Buhari regime.","Because ehn I remember, dat Jonathan time o, everybody just dey flex, but dis Buhari regime, things no easy at all." "I wanna... I'm just wondering what will happen within, I mean the citizens, in the next ten years.","I wanna, I just dey wonder wetin go happen within as in di citizen in di next ten years." "The way things are going now, it's not funny at all.","As things dey go now, things no funny at all." "Um... like if you think back to the Jonathan era, contracts were awarded and people had work to do.","Ehm like if you think dat time of Jonathan, contract dey come out, people dey work." "Well um... they were giving out things, people were travelling.","Well ehm, dem dey give out tin, people dey travel." "Traveling is very easy, but nowadays, it's like nothing is happening.","To travel is very easy, but now, tins just dey like sey nothing dey happen." I wonder what's happening in Nigeria right now.,I wonder wetin dey happen with Nigeria for now. "Well my friend, I really believe that the situation in this country nowadays is something uh... we all need to get together and talk about.","Well my broder, I really believe sey di situation of dis country now, na something eh all of us need to gather together, talk about am." "We all need to get together, talk about it, figure out how we will solve our problems.","All of us need to gather together, talk about am, know how we go take solve our problem." "Because, we cannot leave... let Americans come and solve our problems.","Because, we no fit leave, let Americans come solve our problem." We need to do it by ourselves.,We need to do am within ourselves. "When, when you talk about um... the students now, for you to... um... it's not easy for you to get into school now.","When, when you talk about ehm di student now, for you to, ehn for you to get admission now, e no easy." You need to struggle.,You need to struggle. You will take...,You go write... "You will come across people who didn't take... who didn't even take the examination, you will see them get in while you who rested... struggled to sit for the Post UME and everything else... you need to stay back and, and then you need to say, ""okay, go ahead....""","You go see people wey no write, no even write exam, you go see dem just enter, but you wey rest, struggle write post UME and every oder thing, you need to stay back and, and den you need to say okay de go like." You have to struggle beforehand if you don't have anyone to help you.,You have to struggle before if you don't have anybody. That's how this country is.,Na so di country just be now. "So if you want anything in Nigeria now, you need to be well connected.",So for you to get anything for Nigeria now na just connection. "In fact, the other day, I had... I went to uh... a party with my girl.","Even di oder day sef, I get, I go ehn party with my madam." "As soon as we went into the hall of the event, the women just started asking me who invited me.","As we enter hall, naim, di woman come dey ask me who I follow come?" I had to tell her that it was a certain woman before she would give me a plate of rice!,I tell am sey na one madam before she give me plate of rice! Imagine!,Imagine! Even getting a plate of rice in Nigeria now involves connections.,"To even get plate of rice for Nigeria now, na connection." Uhm!,Uhm! "It's not easy at all, but...",Di thing no easy at all but... "Well man, what I am really thinking of uh... the country is that we should just find means ( I mean, know how) things we will do to solve our present problems.","Well bro, wetin me I just dey really think of ehn di country now na make we just find way (as in know how), things we go take solve our problem for now." "Because if we are waiting for our government, they will not help us.","Because if we dey wait for our government, dem no go help us." "And also, my fellow youths like me also...",And also my fellow youths like me also... And I also advise them when it comes to...,And I dey also advise dem when it comes to... "Like our guys who are into the fraudulent acts known as Yahoo, and other stuff like that, that stuff doesn't pay at all.","Like our guys wey dey do yahoo, and oder stuff like dat, dose stuff no dey pay at all." That stuff doesn't pay.,Dose things no dey pay. "I noticed some guys recently, they will tell you that this guy riding this car is no superhero.","I notice some guys now, de will tell you sey dis man wey dey ride dis car no get two heads." "Myself, I want to be like him.",Meself wan be like am. But all those things don't add value.,But all dose things no dey pay. We need to like... just identify what we can do on our own.,We need to like just know wetin we fit work on our own. "Like if you go to China now, you will see young boys... they're the ones making these phones we use; they send them to us and we buy them.","Like if you go China now, you go see young boys now, all dese phone wey dey use, na dem dey do am, bring send for us, we dey buy." Because all those cars we use were designed by young boys like us.,"Because all dose cars wey we dey use, na young boys like us dey design am." "But here in Nigeria, we're always going into fraudulent acts called Yahoo and/or oil bunkering, and the like.","But for Nigeria here, wetin we dey always take na yahoo, and, or oil bunkering, and di rest." "Uh... but I sure know that those, those things don't pay at all.","Ehn but I know sure sey dose, dose ones no pay at all." "So uh... we just have to work hard, then think ahead, and come up with solutions to our problems.","So ehn na just for us to work hard, den think further, and know how we fit take solve our problem." "For instance, just now, I remember when I worked with an Indian man.","Like as I dey now, I remember o when I work with one Indian man." "I, I tried to save a bit of money and bought a small car, which I used for commercial purposes.","I, I try save small money, come buy one small motor, come use am dey do taxi." "That was uh... four back... four years back, but one of my guys made the comment, ""man, this is beneath you!""","Dat was ahm four back, four years back, but one of my guy come dey like guy, you no suppose dey do dis kind thing!" "But I told the guy that it's just... with time, and perseverance, things will surely be alright.","But I con like advise di guy say na just with time, and perseverance, and things go surely dey okay." It was through that taxi that I met...,Na through dat taxi I come meet... "As we speak... through that taxi, I met the HR Manager of Total, the Mr Didebey from France.","As me and you dey talk now, through dat taxi I meet di HR manager of Total, di Mr Didebey from France." "And since I met that man, things have changed in my life.","And since I meet dat man, things don somehow change for my life." "The man advised me on education, the man has guided me.","Di man don advise me about education, di man don talk to me." He told me that he himself went through what I am going through at the moment.,Tell me sey imself pass through wetin me I dey pass now. But he later excelled in life.,But im later excel in life. "But I should just continue to do my things the way I believe it should be done, and God will really see me through.","But make I just continue to do my own things di way wey I believe am, and God go really see me through." "Even as you and I are talking, the man has gone back to France.","Even as I, me, and you dey talk now, di man don go back France." But the man still...,But di man still... "But everyday, he and I chat on WhatsApp.","Yet everyday me, and am dey chat on WhatsApp." He calls me.,E dey call me. "He still introduces me to people who will be able to like assist me uh... maybe when I graduate, so that I can get uh... a good job that will change my life.",E still dey like push me to people wey go fit like assist me ehn maybe when I don graduate so dat I fit get ehn good job to change my life. So that's how life is.,So na so just life be. Life isn't really easy.,Life no really easy. "And I don't believe that if you were born poor, you will remain poor.","And I no believe sey if your parent born you, you no get anything, you go remain like dat." "It depends on how, how you struggle, and how you want to really help yourself.","E depend how, how you struggle, and how you wan really help yourself." "Well, when you... when people say that people like Dangote, Otedola, and the rest... that it's because... that it's... I don't believe it.","Well, when you, when people talk sey na people like Dangote, Odetola, and di rest, sey na because, sey na, I no believe." "Because if you read Dangote's history, and all those rich men of today, the way they started, yourself, you will wonder whether...","Because if you read di history of Dangote, and all dose rich men today, di way wey dey take start, you self, you go wonder whether..." "I mean, you will just imagine that it was not their parents who laid the foundation for them.",As in you go just imagine sey no be deir parents lay di foundation for dem. "It's just they... something they really wanted to do, and how they would work things out in their lives, to ensure they live a better life.","Na just de, something wey de really want do, and how dey want take work out things for deir life to make a better life for dem." "So I really believe that when you believe in yourself, you'll really make it in life.","So I really believe sey when you believe in yourself, you really make am in life." You don't need to depend on anyone.,You no need to depend on anybody. You don't need to... you don't need like...,"You no need to, you no need like..." "Since maybe because your parents didn't give birth to you, your parents are poor, that's why you are poor.","Since maybe because your parents no born you, your parents no get money, na im make you poor." "Don't, don't think like that.","Meh, meh you no think like dat." It's all those negative thoughts that will really push you backwards.,Na all dose negative thinking go really push you back. "So uh... about my parents, I thank them for bringing me into this world, and I am aware of the situation at hand, and uh... all... everything I need to do is to work hard in order to ensure that my younger ones, or my unborn children will not go through what I'm going through.","So ehn as for my parents, I thank dem sey de bring me come dis world, and I don see how things be, and ehn all, everything wey I need to do now, na to work hard to make sure sey my junior ones, or my future children no go pass through wetin me, I pass through." I started working at uh... the University of Ibadan here.,I start working at eh University of Ibadan here. "I'm an electrician, which they call onise ina.",I dey do electrician which de dey call onise ina. I'm working there.,Na dere I dey work. I've served...,I don serve... I almost uh...,I almost eh... "At least, I'm up to uh... thirty five, or thirty four years in service now.","At least, e don reach eh thirty five, or thirty four years in service now." "The work I'm doing, I like it even though it's a dangerous job, it's the li-... work.","Di work wey I dey do, I like am even though na dangerous work na im be di li-... work." But I still like it because I'm good at it.,But I still like am cause I don perfect on it. So I've been doing the work very well.,Wey I dey do di work very well. No problem.,No problem. "Uh... everything we're doing here (we lay cables, we do wiring, we wire homes), when the university gets electricity, we're the ones who do it.","Ehn everyting wey we dey do here (we dey lay cable, we dey do wiring, we dey do housing wiring) before light come to di university, na we go do am." "We do m-... we mount uh... tre-... transformer, we mount RI-... RMU.","We do m-... we dey mount eh tre-... transformer, we dey mount RI-... RMU." "Lots, lots of things, that's what we are uh... using.","Many, many things, na im we dey ehn use." "We lay cables, but when we want to lay cables (that big one, the cable, if you carry it, it's a big one), we will lay it in a gutter which they dig for us.","We lay cable, but when we want lay cable (dat big one, cable, if you carry am, na big one), we go lay am for inside gutter wey dem go dig for us." "After that, we will install lights.","After we do dat one, we go put light dere." The lights make everyone cheer.,Light go come make yah for everybody. Because they know we've finished.,Den go know sey we don do am finish. But it's dangerous work for a novice!,"But na danger work o, if person no know." "But a person who's sure he's mastered it, he'll concentrate on what he's doing.","But person wey e go don sabi sey e don sabi am, e go concentrate for di ting wey e dey do." "By then, even though the university doesn't pay us that much for the work we're doing, we know that we're still working.","By dis time, even though university did not compensate us for di work wey we dey do too much but we still know sey we still dey work." We're still doing it.,We dey still work am. And uh... there are a lot of people with us here.,And eh many people wey dey with us here. "We have uh... cable dressing, cable jointer section, we have overhead, we have uh... streetlights, we have the people doing wiring for houses.","We have eh cable dressing, cable jointer section, we have overhead, we have eh streetlights, we have dose who dey wiring for house." But ours is cable jointers.,But our own na cable jointer. "We are the ones who bring RMU, we are the ones who mount uh... transformers in the university.","Na we dey bring RMU, na we dey mount eh transformer for university." "Every high, high tension that we do, it's our section that's doing it.","Every high, high tension wey we dey do, na our section na im dey do am." We're the ones doing everything.,Na we dey do everytin. "Apart from that, we can do house wiring.","Apart from dat, we can do wiring house." "But in our own section here, it's only the laying of cables, connection of transformers, connection of uh... RMU.","But for our own section here, it's only laying cable, connect transformer, connect eh RMU." That’s all we're doing in our own section here.,Na only dat one we dey do for our own here. "In this section, at least, we have three sections... two... or two.","For dis section, at least, we get three section, two, or two." Uh... there is rewinding.,"En rewinding, e dey." Oh uh...,Oh ehn... We should...,Mey... "We have ones who are re-... repairing transformers, we ones who connect transformers.","Dose who dey re-... repair transformer, e dey, dose who dey connect transformer, e dey." "But in our section here, I am the station head, I am the overall boss in this section, who runs this place.","But for our section here, I be stational head, I be di oga patapata for dis section wey dey do dis place." We're the ones who mount all these places.,Na we dey mount all dis place. We have...,We get... "If an... if they bring a form saying that there... it... see, there is a pro-... problem there, he will bring the form, we will fill it out, we will pass it on to our overall boss who will go and do the wor-... send us to s-... to go out, to uh... go and do the work.","If an, if de bring form say de, e see dere is a pro-... problem dere, e go bring di form, we go fill am, we go pass am to our oga patapata for up wey e go go do di wor-... send us to s-... to go out, to eh go and do di work." That's how we do it here.,Na so we dey do here. "For any other problem that comes up, first of all you'll fill out papers stating that there's a problem in this section, they want them... these people to come and do the repairs, before we can go.","Any oda problem wey e dey, you will first of all fill paper say problem dey o for dis section o, de want dem, dis people to come, and do di repair, before we can go." It's because the boss has given instructions that we should not pass... go beyond his... our boundaries.,"It's because oga don put instruction down say we should not pass, go beyond im, our boundary." We're the ones doing all these things.,"All dis tin, na we dey do." "Uh... those who are under me, we're at least... we are... we're up to ten, or fifteen.","Eh dose who dey for under me, we 're at least, we are, we up to ten, or to fifteen." "We have uh... ones who do nights, afternoons, and mornings.","We have eh dose who dey do nights, afternoon, morning." That is how we do... divided them up to do the work.,"That is how we do, divided dem sey make de dey do work." "Those s-... the people who are on night shift now, they were here early in the morning.","Dose s-... di people wey dey night now, de dey here early morning." They're here with us.,De dey with us here. "Some people, they are regular.","Some people, we dey do regular." "Regular, is what this...","Regular, na im dis..." That's how we do it here.,Everyday! We come everyday.,We dey come everyday. No shifting for that group of people.,No shifting for dat people. "The ones on morning shift, they'll come in the morning.","Dose who dey do morning, de go come in di morning." "When it's two o'clock, they'll leave work.","When it is two o'clock, de leave di work." They go back to their place to s-... sleep.,De go back to their place wey dem dey s-... sleep. But the ones on the afternoon shift will come back by two.,But dose who dey afternoon go come back by two. They will close by nine.,De will close by nine. "After nine, the ones who do... are on the night shift, they will take over for them from... to, to the other day, the second day... morning, because before the morning, people will come to take over for them.","After nine, dose who do, dey for night, de will take over from dem from, to, to di oda day, di second day, morning because before di morning people come take over from dem." That is how we do our work here.,Dat is how we dey work our work here. No.,No. We don’t collect money!,We no dey collect money o. "We only collect our salary here which yeah, the Federal Government gives us.",Na only salary we dey collect here wey yeah di Federal Government dey give us. "If we go to work in a house, for instance in your house, we will not collect payment from you.","If we go work for house sef, for your house now, we no go collect kobo for you." Because it is our pol-... nai-... du-... call... duty to do the work for you.,"Because it is our pol-... nai-... du-... call, duty to do di work for you." "He doesn’t collect money, he doesn’t collect money.","E no dey collect money, e no dey collect ego." "The only thing we collect... we say if you say we... uh... the work which we did for you, that, it, it pleases you, you will say, ""here, go and buy some soft drinks"", if for instance you gave ten naira, we will take it uh... happily, collect it from you and pray for God to bless you and make you very wealthy.","Only what we collect, we say if you say we, eh di work wey we do for you sey, e, e please you, you go say take, go buy minerals, if to say na ten naira you bring, we go take eh happily, collect am from you, pray for you sey God go bless you o, e go increase your your wealth very, very well." That is how we do it here.,Na so we dey do here. We don’t collect money.,We no dey collect money. "Anybody who comes here, we do our own services for them.","Anybody wey come here, we do our own service for am." The love God has for everyone made Him send His only child so that whoever believes in Him will not perish but have everlasting life.,"Na di likeness wey God get for everybody na im make am send im only pikin so dat anybody wey believe am no go die, but go get life boku." "God did not send His Child to the world in order to condemn us, but to save us.","God no send im pikin to come world come condemn we, but so dat e go save we." "Today, Jesus has over one billion followers, and even more.","Today, Jesus get pass one billion followers, and even more." The story is from the Book of Luke.,Na di Book of Luke na im di tory dey come. "I am writing you this book, Theophilus, to tell you the way everything happened so that you will know the main things, right from the birth of Jesus Christ, when Mary and Joseph went to register their names, when Caesar Augustus was the King of Rome, and Herod was the King of Judea.","I dey write you dis book Theophilus to tell you di way everytin take happen so dat you go know di main tings right from di birth of Jesus Christ when Mary and Joseph go put down name when Caesar Augustus be di king for Rome, and Herod be di king for Judea." Mary and Joseph were the parents of Jesus.,"Mary, and Joseph, na im be di parents of Jesus." "An angel appeared to Mary, he told her that she will give birth to a boy who will be the savior of the world, as a virgin.",One angel appear to Mary tell am sey she go born bomboy wey go be di saviour of the world as Mary no know man. Jesus started growing and he was wise.,Jesus begin grow dey get sense. "In fact, he was sitting among professors and in fact, doctors were there too, and he was lecturing them.","Even sef, dey siddon for where professors, and doctors sef dem dey, dey lecture dem." "As he began preaching the good news, some people started following his line of thought, saying he was speaking the truth.","As e begin preach di good news, some people begin reason wit am sey na di truth e dey yarn." "Jesus overcame temptations from the devil on three occassions, when he was fasting for forty days and forty nights.","Jesus overcome temptation from di Devil three times as e dey fast for forty days, and forty night." "He had his baptism with John the Baptist as John the Baptist told the people ""there is someone ahead of me, who is greater than me, who will baptise you with water, and fire, I cannot even take his sandals off.""","E do baptism wit John the Baptist as John di Baptist tell di people sey person dey before me wey big pass me wey go baptise una wit water, and fire, I no fit even comot im sandal sef." "As Jesus was preaching, he started coming in contact with his followers.","As Jesus dey preach, e begin meet im followers dem." He was greeting them one after the other.,E begin greet dem one after di oder. "Peter, whom he called Simon; Andrew; James; John; Philip; Bartholomew; Thomas; Matthew; James; Thaddeus; Simon the Zealot; and Judas Iscariot who betrayed Jesus.","Peter wey im call Simon, Andrew, James, John, Philip, Bartholomew, Thomas, Matthew, James, Thaddeus, Simon di Zealot, and Judas Iscariot wey betray Jesus." "They started going around, spreading the good news.",Dem begin waka dey spread di good news. They were spreading it to all the corners of the earth.,Dem dey spread am reach all di corners of di earth. "And they were preaching that God's kindgom has come, everyone should repent.","And de dey preach sey God kindgom don show, make everybody dem repent." "And so people started giving their lives to God, and they repented for their sins.","Na so people come dey give deir life to God, and dey repent from deir sins." "Then on a particular night, it was the last supper, Jesus sent his disciples to go get all they will eat and drink for the last supper.","E come reach one night, come reach last super, Jesus come send im disciple say make dem go bring everyting wey dem go chop, wey de go drink for di last supper." So they left.,Naim de come comot. "Good afternoon, people listening to me!",Good afternoon people wey dey listen to me! I want to talk to you about a man called Jesus.,I want to talk to una about a man called Jesus. "You've been hearing about him, but a lot of you don’t have any relationship with him.","Una don dey hear about am, but a lot of una no get any relationship wit am." This person whose name is Jesus was his... the one God sent.,Dis person wey im name na Jesus was im di person wey God send. "God is the One we worship, who can be likened to your father who brought you into the world.","God na di person wey we dey worship, wey dey like your papa wey born you for earth." "As your father brought you into the world, fed you, taught you and housed you, so our God in heaven is the One who sent His own son also, whose name is Jesus, to tell us that if we come to Him, we will have to come through Jesus.","As your papa born you, feed you, train you, house you, na so, our God for heaven, na im bring im own son too wey im name na Jesus come tell us sey if we must come to him, we go come through dis Jesus." But Jesus didn’t just come that way.,But Jesus no just come like dat. "According to the Bible in, in uh... John, chapter three verse three, a man named Nicodemus went to Jesus one day, and asked him, ""I see the things you've been doing since you came.""","According to di Bible for, in, in ehm John chapter three verse three, a man name Nicodemus go meet Jesus one day, con ask Jesus sey I dey see di tings wey you dey do since you come." You are doing so many good things in people's lives.,"You dey do so, so good work for people life." People's lives are getting better.,People life dey better. "The one whose eyes are blind, his eyes will see; the one who cannot eat, you give food; the one who has no leg, you can make them walk.","Di one wey get blind eye, im eye go see, di one wey no fit eat, you dey give am food, di one wey no get leg, you dey fit make am waka." I really like what you're doing.,"Dis ting wey you dey do, I like am so much." You are good at heart.,"Your mind, you dey good." You love people so much.,You love people very well. You don’t discriminate between the poor and the rich.,"You no dey discriminate about poor, or rich." You carry everybody along.,"Everybody, you dey carry dem along." I want to start doing the things you do.,I want to begin to do dis kind ting wey you dey do. "Then Jesus answered him, ""yes, it is very possible for you to do what I am doing but there is a condition.""","Jesus con answer am sey yes it is very possible for you to do wetin I dey do, but dere is a condition." "Then he asked Jesus, ""what is the condition for me to do what you do, enjoying this privilege, enjoying this benefit?""","E con ask Jesus sey wetin be di condition wey go make me dey do like you, dey enjoy dis privilege, dey enjoy dis benefit?" "So Jesus told him, ""unless you are born again..."" in John Chapter three, verse three.","Jesus con tell am sey except you are born again, in John chapter three verse three." "That being born again means that unless you change your lifestyle to become like me, right, to do the... to...","Dat Born Again mean sey except you change your lifestyle to become like me, eh to do di, to..." """Unless you change your lifestyle and start thinking of God, unless you leave your old ways of worshipping other idols... other things, and begin worshipping the true God who is in heaven, you will not be able to do what I do.""","Except you change your lifestyle, and begin dey tink of God, except you leave di old way wey you dey worship oder juju, oder tings, and begin dey worship di true God wey dey heaven, you no go fit do wetin I dey do." "Then Nicodemus said, ""aha, how will I be born again?""",Nicodemus come say aha how I born again? """Uh... will I go back into my mother's womb so that she can give birth to me again?""",Eh I go go back to my mama belle make she born me again? """I am... I am eighty five years old.""","I am, I am eighty five years." """I'm old now.""",I am old now. """In fact, my mother is dead.""",Even my mama don die. Jesus said no.,Jesus say no. If you read the Bible... go and read verse six!,"If you read di Bible, go read verse six!" He said no.,E say no. "That unless you are born of water, and of the Spirit, you will not be able to enter the Kingdom of God.","Dat except you are born of water, and of the spirit, you will not be able to enter the kingdom of God." What is the Kingdom of God?,What is dat kingdom of God? That’s the message I brought for you today.,Na im be di message wey I carry come for una today. "The Kingdom of God is what God has prepared in heaven, which we're supposed to be enjoying even here on earth, before we go to Him in heaven.","Dat kingdom of God, na di ting wey God don prepare for heaven, wey we suppose dey enjoy even as we dey for earth before we go go meet am for heaven." "In the Kingdom of God, there is no sicknesses; in the Kingdom of God, there are no diseases; in the Kingdom of God, there's no want; in the Kingdom of God, there's no poverty; in the Kingdom of God, there's only happiness, and joy.","Dat kingdom of God, no sickness dey, dat kingdom of God, no disease dey, dat kingdom of God, no lack dey, dat kingdom of God, no poverty dey, dat kingdom of God, na only happiness, and Joy." "So Jesus told Nicodemus, ""unless you are born of water and of the Spirit, you cannot enter that kingdom.""","So Jesus con tell Nicodemus sey except you are born of the water, and of the spirit, you can not enter that kingdom." What was the water Jesus was talking about?,Wetin be di water wey Jesus mean? "The water means that unless you, you know the Bible, which is the word of God, then you won't understand who God is, you won't even know what God is able to do for you.","Di water mean sey except you dey, you know the Bible which is the word of God, den you no go understand who God is, you no go even know wetin God fit do for you." So the way to enter the Kingdom of God is to be born of that water.,So di way to enter di kingdom of God is to be born by dat water. "Again, he used another phrase saying, ""and of the Spirit.""",E now con use anoda phrase say and of the spirit. What is the Spirit?,Wetin be di spirit? It means that the... in... who you really are... the body you go about in is not the real you.,"It means dat di inside, di real person wey be you, no be dis body wey you carry be you o." Your mind is not you.,No be your mind be you o. "There is a real person inside you, which is the Spirit.",Dere is a real person inside of you wey be di spirit. "And he said that unless that Spirit has also changed, you cannot enter either.","And e say except dat spirit is also change, you can not also enter." What will change that Spirit?,Wetin go change dat spirit? It's the word of God.,Na the word of God. The... and how can the Spirit get changed?,"Di, and how can di spirit be changed?" When you say let the word of God into your heart!,When you say make dat word of God enter your heart! "If you go back to Gen... uh... John's gospel, chapter one, verse one, the Bible says, ""in the beginning was the word, and the word was with God, and the word was God.""","If you go back to Gen, eh John's gospel chapter one verse one, Bible say in the beginning was the word, and the word was with God, and the word was God." So that word which the Bible was talking about is the person Jesus.,"So dat word wey di Bible dey talk about, na im be di person of Jesus." "Jesus said, ""I come in the volume of..."" what?",Jesus say I come in the volume of what? The books.,Di books. So everything you read in the Bible is about Jesus.,"So everyting wey you dey read for Bible, you dey read about Jesus." "And for you to see the Kingdom Jesus was telling Nicodemus about, you must take that word into your heart.","And for you to see dat kingdom wey Jesus dey tell Nicodemus, you must take dat word into your heart." And what is the word we are talking about?,And wetin be di word wey we dey talk about? "According to John chapter one, verse one, that word is who?","According to John chapter one verse one, dat word, na im be who?" Jesus Christ.,Jesus Christ. "Which means unless you accept Jesus into your life, you cannot see the Kingdom of God.","Which means, except you accept Jesus into your life, you cannot see di kingdom of God." "People who are now enjoying the benefits of God are living in good health, they are living in prosperity.","People now wey dey enjoy di benefit of God, de dey live in good health, de dey live in prosperity." "There is no sickness in their body, no, no lack.","Dere is no sickness in deir body, no, no lack." God blesses them immensely.,"God dey bless dem yafun, yafun." Everything they lay their hands on prospers.,"Everyting de put deir hand, di ting dey go ya, ya very well." They da-...,De da... "They see the kindness of God; they are not sickly, visiting the hospital today, going down with arthritis tomorrow and having a headache the next day.","De dey see di kindness of God, de no dey go hospital today, de no dey sick, tomorrow arthritis, dey headache next tomorrow." No!,No! Everything about their life is very good.,Everyting about deir life dey very good. It's because they have accepted Jesus into their lives.,Na because de don accept Jesus into deir life. "And Jesus said, ""if you accept me into your life, Nicodemus, you will begin to experience the Kingdom of God.""","And Jesus say if you accept me into your life, Nicodemus, you go begin to see di kingdom of God begin to happen for you." "And Nicodemus said, ""is that so?""",And Nicodemus say ehen? """So, is that how it is?""",So na so dis ting be? "And another thing the Kingdom of God has come to do for us is that the kingdom of God... wherever the Kingdom of God is, it is light.","And anoder ting wey di kingdom of God don come to do for us is dat di kingdom of God, where di kingdom of God dey, dis is light." "And wherever you have light, there is no what?","And where light dey, dere is no what?" Darkness.,Darkness. So the Kingdom of God is also the light of God.,So di kingdom of God is also di light of God. "When that light comes into a dark place, what happens?","When dat light come inside where darkness dey, wetin go happen?" Darkness will disappear.,Darkness go disappear. Just remember when NEPA [National Electric Power Authority] switches off the light in your house.,Just remember when NEPA take light for your house. "When you put on your lantern, or you light your candle, what happens?","When you on your lantern, or your candle, wetin happen?" You will see everywhere.,You go see everywhere. That’s how the light of God is.,Na so di light of God dey. "When light comes into your life, what happens?","When light come into your life, wetin go happen?" "All the things which the Devil has imposed on your body, all the disgusting things, the light of God will make all of them what?","All di ting wey the Devil don put for your body, all di yama, yama, the light of God go make all of them to what?" Disappear.,Disappear. "So the vital message for today is that the Kingdom of God, like Jesus said, is near you, but how can you access it?","So di vital message for today is that the kingdom of God (like Jesus say) is near you, but how can you access it?" How will you enter into that kingdom?,How you go enter dat kingdom? Until you receive Jesus into your life...,Until you receive Jesus into your life. "My brother, my sister, as many of you listening to me, if Jesus has not come into your life, your life will still be in crisis.","My broder, my sister, as many of una wey dey listen to me, if Jesus never come into your life, your life go still dey in crisis." Your life... you will still be having pains and problems here and there.,"Your life, you go still dey get pain, and problem here, and dere." "But when Jesus has come in and has taken a seat, and you say, ""Jesus, you are my Lord; from today, I will do whatever you say.""","But when Jesus don enter come sit down, you con say Jesus, you are my lord o, from today, anyting you tell me, now, I go do." "Then from that day, you will begin to experience the glory of God in your life.","Den from dat day, you go begin to see the glory of God in your life." You will begin to see what it means to live in the Kingdom of God.,You go begin to see wetin e mean to live in the kingdom of God. God bless you as you accept him into your life!,God bless you as you accept am into your life! "In Jesus' name, amen!","In Jesus name, amen!" Alright.,Toh. Hm.,Hm. "The thing that I want to talk about, right, is clothes.","Di ting wey I want talk about ba, na di dressing o." Hm.,Hm. "Of our girls nowadays, right?",Of our girls nowadays ba? "This... uh... our girls, the way they wear their clothes, it embarrasses me so much.","Dis, eh our girls, di way wey dem dey wear deir cloth, di ting dey embarrass me well, well o." They can't dress properly.,De no fit dress o. They can't dress properly.,De no fit dress. This isn't wearing clothes; it's dressing like a hooker.,"Dis one no be dressing, na Ashawo dressing." Alright.,Toh. That's not how we used to dress.,That was not how we used to dress. I thought it was just me who was seeing it.,I tink sey na only me dey see am o. The whole body exposed.,All body outside. Uhuh!,Ehen! "Even the legs, not that they have a nice shape.","Di legs ma, no be sey dem get shape o." Ehe!,Ehe! They don't consider whether or not it will fit them.,De no dey consider weder dis ting go fit me. They don't consider it.,De no dey consider o. It'll fit me or not.,"Fit me, or e no go fit me." "Ehe, they will just wear anything.","Ehe, de go just wear anyting." "This one time, I saw a lady.","Di oder time, I saw one lady." The lady was big.,Di lady big o. Her thighs were really fat.,"See her thighs, very fat, fat." "Haha, like yams.",Haha like yam. Yes!,Yes! She then wore a very s-... sh-... short skirt.,She con wear very s-... sh-... short skirt. "Then at the back, she tore it.",And at di back she come just tear di ting. "As she was walking, you could see her underwear.","As she dey waka, you go fit see her pant for outside o." No sense of dress.,No dress sense. "That day, I felt really ashamed.","Dat day, shame con catch me well, well." "I said, ""what's this we're doing?""",I say wetin be dis one wey we dey do? She's done for.,She don finish herself now. "Please, let us mothers give guidance to our daughters.","Abeg o, make we moders dey talk to our daughters now." People have seen everything.,People don see everyting. Alright!,Toh! "As they're leaving the house, let's talk to them so they will wear clothes like we used to before now.","As dey comot from house, make we dey talk to dem so dat de will be wearing cloth like we were using before now." I hope that it's from the house they dressed that way.,I hope sey na from house de come do dat dressing o. You know some of them have some sense.,You know some of dem get one kind sense. Alright!,Toh! "Sometimes, they carry it on their backs.","Sometimes, de carry am for back." Ehe!,Ehen! "As soon as they get somewhere or their friend's place, they will change.","As de go reach somewhere, or deir friends house, de change." Eh!,Eh! "That's what they used to do, some of them.",Dat'S what de use to do some of dem o. Okay!,Okay! "So, even the parents, they won't know.","So di parents sef, de no go know." "So, it may be that the parents don't even know.",So e fit be sey di parents no know sef. Jesus!,Jesus! "But mine, if we see it... if I see it, I will talk.","But my own o, if we see am, if I see am, I go talk." Hm.,Hm. "Whether you are my daughter, or not, I will call you.","Weda you be my daughter o, or not, I go call you." Hm.,Hm. Hm.,Hm. "I will say, ""this way you're dressing, is it an advertisement?""","I say dis dressing wey you do, na advert?" Hm.,Hm. It's not good.,E no good. Hm.,Hm. Two!,Two! You're showing off what's supposed to be for your husband!,You don finish showing di ting wey e suppose be for your husband outside o. Yes!,Yes now! Everyone's seen it!,Everybody don see am. Yes!,Yes! So what he'll have is second-hand.,So na second hand im go con carry. Yes!,Yes! "Even i-... if he admires it now in the house, no, he will go out again.","Even i-... im admire am now for house, no he will go out again." Hm.,Hm. No respect again; no respect again.,"No respect again now, no respect again." That's it.,Dat's it. Ehn!,Ehn! "So me, I talk to them.","So me, I dey talk to dem o." "If they like it, let them hear; if they don't like it, it's their own problem.","If de like, make dem hear, if de no like, na deir own palava." I've told them.,I don tell dem. "The thing that's, that's disturbing me is that when you tell them, they will say that you, you are old fashioned.","Di ting wey de-... dey disturb me ba, when you tell dem, de go say you, you be old fashion." Eh!,Eh! "That because your own time, is not uh... th-... their own time.","Dat because during your own time, is not eh d-... deir own time." The world has changed now.,World don change now. "The things that we were using before, is not what they are using.","Di tings wey we dey use before, no be im dem dey use." "So, let's just, just leave them alone.",So make we just d-... dey leave dem alone o. We used to use uh... wear mini skirts.,"We used to use eh, wear mini skirt o." That it is...,Dat it is... Eh.,Eh. But our mini skirts were very comfortable.,But our mini skirts were very comfortable. Yes!,Yes! Just above the knee a bit like this.,Just above di knee small like dis. Hm.,Hm. "It wo-... won't be up, up like this.","E no g-... go dey up, up like dis." And we didn't tear them.,And we no dey tear am. And we didn't slit it like this so you can see the underwear.,And we no dey slit am like dis wey you go see pant. Hm.,Hm. Some of them don't wear underwear.,Some of dem don't wear pant tu ma fa. "If they sit down and open their legs, you'll see the thing.","If de sit down open leg, na so you go dey see di ting." Theirs was for... is for attraction; ours was not.,"Deir own was for, is for attraction, our own was not." It was the fashion.,It was di fashion. Yes!,Toh! And very sensible fashion.,And very sensible fashion. Not this kind that they are doing.,No be dis kind one wey dem dey do. "And if they see men, they'll go shaking their butts.","And if dey see men, na so de go dey blow deir yansh." Uhuh!,Ehen! As if they are advertising themselves to the men.,As if dem dey advertise demselves to di men. "This one, b-... the Bible does not change.","Dis one o, b-... di Bible does not change o." It's been the same thing for a long time.,"Na di same ting from tay, tay." That's how the bible is.,Na so di Bible still dey. "If you do not dress sensibly, it said that our body is the temple of God.","If you no dress sense, e don say our body na temple of God." "And you see men, right?",And you see men ba? "If you make it useless, it's your business.","If you useless am, na you sabi." "You see men, right?",You see men ba? "As they are, right?",As dem be ba? "If they see you and you are advertising yourself, that's how they will come.","If de see you, you dey advertise yourself, na so de go come o." Uhuh!,Ehen! "Then if you give it to them... then if you give it to them, they'll go and tell their friends that that one, as you look at her walking like this and advertising, I, I've already gone and had mine.","If you con give dem, if you con give dem, na so de go go back tell deir friends sey dat one, as you dey see am ba (dey walka, walka like dis, dey advertise ba), me, I don go, I don go get my own." Isn't it just like f-... flies on shit?,No be f-... like flies for shit? You should go.,Make you go. You should g-...,Make you g-... That's it.,Dat's it. And th-... th-... they won't marry you.,And d-... d-... dem no go marry you o. "It's their work, that's that.",Na dem work be dat. They won't marry you.,De no go marry you. How could they marry you?,How dem go marry you? They'll go and look for an innocent girl.,De will go and look for one innocent girl. That's the one they'll take as their wife.,Na im de go con carry for deir wife. "When you've become a second hand girl, when you've become a second hand girl.","When you don become second hand, when you don become second hand." That's the thing that's bothering me.,Na di ting wey dey disturb me be dat o. Everybody has seen.,Everybody don see. Ehe!,Ehen! Everybody has.,Everybody don. No respect again.,No respect again. Then it's me that'll take her home?,Na me go come carry am go home? Yes!,Yes! No.,No o. Alright.,Toh. It's not enough.,E no do o. Uhuh!,Ehen! "So, that's what's bothering us.",So na di ting wey dey disturb us o. "And this one for boys now, that it's... or it's ass down... or what is it?","And dis one for boys now, sey na, abi na arse down, abi na wetin?" Hm.,Hm. Ehe.,Eh! It's crazy people who dress like that.,Na mad people use to dress like dat o. My sister!,My sister! "But now, it's our children.","But now o, na our children." Yes!,Yes! They will leave this thing; come down like this.,"Dem go leave dis ting, come down like dis." Eh!,Eh! Some o-... of the underwear isn't even clean.,Some o-... of di undies ma no clean o. Oho!,Oh o. As dirty as can be.,As dirty as anyting. Really dirty!,Very dirty! It even smells.,Di ting dey smell sef. "And then, they will be leaving it.","And den, de will be leaving it." I always tell them uh...,I always tell dem eh. Yes!,Yes! "If they say there is a war now, how will they run?","If de say war now, how will you run?" Oho!,Oh o. Will you be able to run?,You go fit run? You can't run because the pants are holding your legs.,You no go fit run o because di trouser dey hold dem leg. Eh!,Eh! They can't take steps very well.,"Dem no dey fit take step well, well." "So and then, this hair.","So and den, dis hair." "This... the thing that bothers me about boys' pants, when they wear the pants, they'll go take their hands to hold their private part in their hands and be walking like this.","Dis, di ting wey dey disturb me with dis eh boys trouser sef, as de wear di trouser, na so de go carry deir hand dey hold deir private part for hand dey walka like dis." "Ah, it's God that'll help us.",Ah na God go help us o. "Uh... because, if... like they're gonna fall...","Eh because if, as if e go fall ne." Aha!,Aha! "I said, ""what is th-...""",I say wetin be d-... Ehe!,Ehen. They want to hold them so they won't fall off.,De want hold am make e no fall. "So they won't fall off, right?",Make e no fall ba? "So, that's how their hands will be.",So na so deir hand go dey. So... but it's not good.,"So, but e no good now." "Haha, well!",Haha toh. It's not good.,Is not good. It's a problem; it's a problem you are causing yourself.,"Na wahala, na palava you dey, you dey bring for yourself o." "So, let's be talking.",So make we dey talk o. Aya!,Aya! "Because if you dress well, people will see you and admire you.","Because if you con dress neatly, people go see you, admire you." They will admire you.,De go admire you. "If you dress that way, I won't know if it's a crazy person or not.","If you dress dat way, I no go know sey abi na person wey dey mad, or abi na person wey dey sane." Hm.,Hm. Hm!,Hm. That's right!,Dey correct. Ehe!,Ehen! "So we have our problems, us parents.",So we have problem o our own o parents. "We have problems, serious problems.","We have problem o, serious problem o." It'll get better.,E go better. Yes!,Yes! "Man, eh!",Nna eh. Things are happening!,Tings dey happen o. Look how my sister and I just woke up yesterday morning.,"See as me, and my sister just wake up yesterday morning." "Normally, if we keep you waiting... if we wake up now, it's to pray and head to work.","Normally if we stand you, if we wake up now, na to pray, start to dey go to work." "So as we woke up, we started hearing this noise outside.","So as we just wake up o, we con dey hear noise outside." Noise everywhere.,Noise everywhere. "I started wondering and said, ""sis, we haven't prayed! Come back here, and let's sit down and pray to God first.""","I con dey wonder say sis, we never pray o, come back here, make we siddon pray to God first o." Then she came back.,Naim she come back. Then she knelt down.,She con kneel down. We prayed to our God.,We con pray to our god o. "As we finished praying, we opened the door to go outside.","As we pray finish now, we con open door to go outside." "There were these two girls staying in the compound, mstchew!",Na two girls wey dey stay for compound mtschew. Oh boy am I tired of this public yard in Enugu.,"O boy me, I don even tire for dis public yard for Enugu o." "We met Amaka and Ogo, who are staying in our compound.","We con meet Amaka, and Ogo wey dey stay our compound o." It was a fight.,Na quarrel. "Early that morning, I said to myself, ""hah, girls, girls these days!""","Dat early morning, I con dey wonder sey ah girls, girls of dese days!" "Instead of thinking about something better this morning, it was about the fighting this early morning.","Instead of we to dey tink about someting better dis morning, na to go dey quarrel dis early morning." "Do you mean to tell me that if you were at your mother's house, that's... that's how you'd be fighting every morning?","You want tell me sey if to say you dey your mama house, na, na so you go dey quarrel every morning?" "So, we asked them.","So, we con dey ask dem o." "As it happens, it'd been taking place since last year, which is when the... Amaka moved into the compound.","E con be sey na someting wey don happen since one year ago, wey don happen when di Amaka just pack in come di compound." "That's how they woke up yesterday morning, and started fighting.","Na im de wake up dat yesterday morning, con dey quarrel." Fighting everywhere.,Quarrel everywhere. Then I was uh...,I con dey eh... "Ah, I didn't even know where to start!",Ah I no con know where to start! "As I stood there, I looked and looked and had nothing to... I mean nothing to even say to them.","As I stand dere, I look, look and noting to, as in noting to even utter to dem." I just stood there.,I con stand dere. "I was tired and said, ""sis, I will talk to this pers-, to these girls when I come back from the house.""","Tire sef say sis, I will talk to dis pers-... to dese girls if I come back from house." """Let's go inside and get ready for work.""",Meh we go inside go prepare work. "So that's how we walked away, leaving them there.",So na so we waka leave dem. They went on talking and shouting everywhere.,De go dey shout dey talk everywhere. You could hear them shouting everywhere in the compound!,See shout everywhere for compound! People were... were even watching from another compound.,"People dey, con dey even watch from anoder compound." "I said, ""look at this disgrace! Ah those girls!""","I say see disgrace o, ah dese girls!" I don't expect this kind of thing from young girls these days.,I no expect dis kind ting from young girls of dese days o. "So that's how my sister and I just walked into the bathroom, got ready and went to work.","So na so me, and my sis just waka enter bathroom now, prepare go to work." "So as I came back in the evening now, I have nothing to do because I know, even in my own house, even when I used to stay with my parents, if anything happened, I don't talk when others are talking.","So as I come back in di evening now, I have noting to do because I know even in my own house, even when I used to stay wit my parents, if anything happen, I don't talk when oders are talking." "It's when I come back, when it's convienient for me, that I'll call them, talk to them.","It's when I come back, at my own convenient time I will now call dem, talk to dem." "So in the evening, as soon as I came back from ho-... from work now, I went into Amaka's room and told her, ""in the next thirty minutes, I want to see you in my room.""","So in di evening, as I con come back from ho-... from work now, I con enter Amaka room, tell Amaka sey in di next thirty minutes, I want to see you in my room." Then I told Ogo the same thing.,Con tell Ogo di same ting. "So in the next thirty minutes, the two of them came into my room.","So in di next thirty minutes, two of dem enter my room." So I sat them down.,Na so I sit dem down. "As a girl, as a fellow girl which is what I am to them, I sat them down to talk, talk to them, talk some sense into them, and told them, ""girls, look, imagine, at this age of ours now, we're not supposed to be doing this kind of thing because it's disgrace for us.""","As a girl, as deir fellow girls wey I be now, I con sit dem down talk, talk to dem, talk sense into dem, tell dem sey girls, see o, imagine, at dis our age now, we no suppose dey do dis kind ting o because na disgrace to us." "We, we are not supposed to do this type of thing at all.","We, we no suppose to dey do dis type of a ting at all, at all." "At this age, we're supposed to be talking, be thinking of how to handle our own family in the future.","At dis age now, we suppose dey talk, dey tink of how to handle our own family tomorrow." "So, but I don't expect this kind of thing from them.",So but I no expect dis kind ting to dem. "But after all, well, they made a little effort.","But after everyting, de try small sha." The two of them tried to understand.,Two of dem try understand. They understood a little.,De understand small. "So, we started talking about something sensible.",So we con dey talk sense. "We even started planning our future, talking about good things which will help us in the future.","We con dey even plan our future, talk better tings wey go help us tomorrow." Not talking about...,No be to dey talk about... "I mean, waking up early in the morning and talking crap.","As in wake up early morning, con dey talk rubbish." "So I told them what I know, I mean so many things ab-... about the advantages of what they are doing.",I con tell dem wetin I know (as in so many tings) ab-... about the advantage of what they are doing. "But at the end of the day, they tried to understand me.","But after every, every de try understand wit me." "So, well, that's how we managed to end that one.",So na so we manage end dat one sha. I'm still praying it won't happen again.,Still praying dat it's not going to happen again. "So, that's how it is.",So na so e be. "This is a very short story that's coming your way on ninety five point one, Wazobia FM on this fifth day in June twenty seventeen.","Dis one na short, short tori wey dey waka come your domot on top ninety five point one, Wazobia FM for dis number five day for inside dis June twenty seventeen." "Alright, listen carefully so you can hear the big news.",Oya plaster your ear for your radio make you hear di matter as e dey hot. "Yesterday, the Federal Government said they will not hesitate to expose people whose work is... whose work is to spread fake news all over the country.","Federal Government, for yesterday, don yarn sey e no go drag leg until im expose dose people wey deir work dey, wey deir work na to dey carry fake news up, and down for di country." And they will bring them to justice.,And dem go carry justice hang for deir neck. "The Senate president, Doctor Bukola Saraki, announced to the house that it will not be appropriate for the politicians who are currently in office to abandon their offices and duties in pursuit of victory in the upcoming twenty nineteen elections.","Presido for Senate, Doctor Bukola Saraki e don yarn in di whole house sey e no go make brain for politicians wey dey office now to leave deir office and deir duty to dey busy dey think of twenty nineteen election matter." "The Senator representing Ogun East, Buruji Kashamu, said he's not happy at all that Ekiti State Governor, Ayodele Fayose, is saying that President Mohammadu Buhari should drop his letter of resignation.","Senator wey dey representate Ogun East, Buruji Kashamu don yarn sey bele no sweet am at all as Ekiti State Governor, Ayodele Fayose, as im dey yarn sey make Presido Mohammadu Buhari drop letter of resign." "The National Assembly has declared that it's not possible... that the Senate has nothing to do with the story circulating around that the pump price of petrol will increse in... by five naira, saying they did not even discuss anything like that.","National Assemble don yarn sey mbanu nu, sey senate hand no dey inside di tori wey dey fly sey de wan increase fuel price for, by five naira, sey de never even discuss anything like dat." "The Kogi State Governor, Yahaya Bello's name has, like magic, disappeared from the voters register after he was accused of registering twice.","Kogi State Governor, Yahaya Bello name don do willy, willy disappear comot for voter's register after dem point am finger of accuse sey im register two times." "The House of Representatives has given the Controller General of Nigeria Immigration Service, also known as NIS, Muhamed Babandele, uh... till Wednesday to appear in the... before them or they will employ force again him.","House of Representate don sama di Controller General of Nigeria Immigration Service alias NIS, Muhamed Babandele eh till on Wednesday to show for di, before dem or de go use by force take follow am." "The Federal Inland Revenue Service, also known as FR-... FRIS, has released what they call the six key electronic solution, also known as e-services, so as to make it easy for people to pay their taxes.","Federal Inland Revenue Service alias FR, FIRS don sama wetin dem dey call six key electronic solution alias e-services so dat e go make things easy for people to pay tax." "The Chief Justice of Nigeria... of Nigerian, also known as NJC, Justice Walter Onnoghen, has announced the appointment of Mrs Had-... Hadizatu Uwani Mustapha as the Chief Registrar of the Supreme Court.","Di chief jojo of Nigeria, of Nigerian, alias NJC, Justice Walter Onnoghen don announcement di appoint of Mrs Had-... Hadizatu Uwani Mustapha as di Chief Registrar for Supreme Court." "The Lagos State Independent Electoral Commission, also known as LASIEC, has received the list of candidates for the All Progressive Congress, APC, to run for the seats of the Chairman and councillors in next month's Local Government election.","Lagos State Independent Electoral Commission alias LASIEC don receive di list of candidate for All Progressive Congress, APC to contest for chairmo and councillor seat for next month local government election." "Bad guys, robbers, have gone to the great beyond.",Bad guys robbers don kpai go yonder. A bank agent withdrew two million naira from his account for the four Local Government areas in Ogun State.,One bank agent con withdrawal two million naira from im account for di four local government area inside Ogun State. In the white man's country.,For obodo Oyibo. Twelve people have been arrested by the Police for their involvement in the terror attack that occurred in London.,Na twelve people na im ekelebe don gbab sake of deir hand dirty on top di kabun badness of terror attack wey happen for London. For buying and selling.,"For buying, and selling." "The way the Nigerian nai-... naira is appreciating these days will ensure that the Central Bank of Nigeria, also known as CBN, continues to monitor the financial market, which will encourage better results.","Di way wey Naija, nai, naira dey get muscle dis days, e no go stop Central Bank of Nigeria alias CBN to dey shook eyes on top different bank market matter wey go carry dem go ahead, ahead." "In entertainment news, our Nigerian rapper, Eva Alordiah...","For jolijoli, we Naija rapper, Eva Allordiah." "Greetings, guys.","Ah my people o, I dey greet una." "So, I just want to talk uh... about uh... wife beating.",So I just wan talk ehn about ehn women battering. You do not understand what the women ba-...?,Una no understand wetin di women ba-... ? "The, the, way they beat, beat women.","Di, di way wey de dey beat, beat women." The way that they mu-.,Di way wey de mu-... The way they do not even treat uh...women like human beings.,Di way de no dey even dey treat ehn women as in like human beings. I really don’t know.,I no know o. This really does happen a lot in Nigeria.,"Dat thing dey really dey happen for Nigeria well, well." "A person will get married, he will have a woman move in, he doesn't know he never liked the woman.","Person go marry, e put woman for house, e no know sey e no like di woman before." Why did he marry her then?,Why e come marry am? That is what I just don’t know.,Na wetin I don't just know. "Later, even if it's money he doesn’t have.","Later, even if na money, e no get." And you just try uh... to do som-...,And just try make you just eh do som-... "Even if it is leaving the house, you should even leave the house!","Even if na to even leave di house, make you even leave di house!" But it is uh... anger.,But na eh vex. "You will just be angry, you will just be beating the woman everytime.","You go just dey vex, you go just dey beat di woman everytime." "Sometimes, they will even just take a knife, and like stab the woman everytime.","Sometime, de go just even carry knife dey, even dey as in chuku di woman everytime." I just don’t understand.,I no just understand o. "Wait, is it because women can't fight or do anything",Wait na because woman no fit fight or anything. "And even in Nigeria, I don’t even know whether they, they really look into this matter.","And for even Nigeria sef, I no even know wheda de dey even dey look into dis matter." I just don’t understand.,I no just understand eh. I just don’t know.,I no just know. "This matter, it is just, it is becoming serious, it is happening more and more every day.","Dis matter, e just, e don dey high, e don dey high, e don dey increase everyday, everyday by day." I just don’t know what is happening.,I no just know wetin dey happen. "The thing, it even leads to uh... uh... human uh... uh... uh... trafficking where a person will see a woman...","Di thing, de con even lead to eh eh human eh eh eh trafficking wey person go just see woman..." "Even the, even we notice all this human traffi-, uh... trafficking, where they uh... carry uh...women.","Even de, even de notice all dis human traffi-... eh trafficking, wey de dey ehn carry ehn women." "They will carry them, they will export them like rice.",De go dey carry dem dey export dem as if no dey be rice. Are they rice?,De be rice. Are they pencils to export and import?,"De be pencil wey de dey export, and import." "Even men, if they say they want to add men, it's one in ten.","Man sef, if de say dem want put man, na one over ten." "It is women who will s-, let's say they are uh... ninety nine uh...percent.",Na women go s-... say de be come ehn ninety nine over ehn ehn ehn ehn ehn ehn ehn ehn ehn ehn ehn hundred. Women are one uh... percent.,Women be one over ehn hundred. Why?,Why? "They will just be using women, beating them anyhow.","De go just dey use women, dey beat dem anyhow." I am saying Nigeria should look into this matter.,I dey say make Nigeria look inside dis matter. "It is not good, it is not good.","E no good, e no good." "A lot of the time, this thing, it destroys families.","Many atimes, dis thing, e dey spoil family." "If children, small children see this thing, it'll just increase every day.","If children, small children go dey look all dese things, di thing go just dey increase everyday by day." If a small child just...,If eh eh small pikin go just... "We think that all these small children, they don't know anything.","We dey think sey all dese small pikin, de no know anything." "I'm telling you, small children, they know something, but they know more than us because, at that time, there is nothing in their brain.","I dey tell you sey small pikin, na dem know someting, but pass we wey be adult because, at dat time, nothing dey inside deir brain." They don't think about anything.,De no dey think of anything. We're the ones who get all these things in our head.,Na we go dey get all dese thing dey for our head. "We will say ""ah! We want to get work, I want to go to work, ah! This thing that I do for work, everything I am doing for this place, I need to go to Oshodi!""","We go dey say ah we wan get work, I wan go work, ah di thing wey I dey do for work, di everything wey I dey do for dis place I need to go Oshodi!" "All these things are in our heads, but when it comes to small children, they don't have anything in their heads.","All dis thing dey for our brain, but when e comes to small children, de no get anyting for deir brain." "So, anything that they see, that they hear, even if they cannot say anything, those things get wired in their brain even when they become adults.","So anyting wey de dey see, wey de dey hear, even if de no sabi speak anything, dose thing dey hook inside deir brain even when dey mature." "So, that's what is making this thing continue.",So na wetin dey con make dis thing dey continue? "A child who says he sees his daddy beat his mummy, if that child grows up, do you want to tell me that that child will not be... be a wife uh... uh... uh... uh... beater when he gets married?","Pikin wey go say e dey see im papa dey beat im mama, if dat pikin grow, you wan tell me sey dat pikin no go be, be wife eh eh eh eh eh beater when e marry?" That's how it will be now.,Na so di thing go be now. "It will just continue like that, and the thing cannot stop.","E go just continue like dat, and di thing no go fit stop." I say that charity begins at home.,"I dey talk sey charity, e begins at home." "Let us start this thing for, for, for our own self.","Make we start dis thing for, for, for our own sef." Nobody will do it for us.,Nobody go do am for us. It's us who will do it for ourselves.,Na we go do am for oursef. We will do it for ourselves.,We go do am for oursef. "Nigerians, I beg you.","Nigerians, I dey beg una." "Let's act in a good way, don't let us spoil ourselves, but make at... at least, Nigeria better.","Make una act in a good way, make we no dey spoil oursef, make, at, at least, make Nigeria just good." "When it comes to mo-, moral civilisation (if that's what I want to call it), let's just be good to each other, don't let us just be...","When e comes to mo, moral civilisation (if na wetin I go call am), make we just dey good to oursef, make we no just dey..." "In fact, if it's our own family members, don't let us do bad to our own family members.","In fact if na our own family member, make we no just dey do bad to our own family members." Thank you.,Thank you. "I know that right now, they have even created...","I know sey now sef, de don even create..." "It is good that they have created this uh... women empowerment uh... thing uh... for Nigerians, for Nigerians.","E good as de don create dis eh women empowerment ehn thing ehn for eh Nigerian, for Nigerian." "And there is even one (I don't remember the exact name), which they have created for all this uh... uh... demoralisation of women, uh... demoralisation of uh... women and even children.","And e get one sef (I no even remember di name sef) wey de don create for all dis ehn ehn demoralising ehn di woman, ehn demoralisation of eh women, and even children." "So, when you see someone, if it is on your uh... uh... doorstep, if it is in your uh... uh... uh... uh... neighborhood that you see a man beating women (sometimes, they don't even care if it is outside, they will even strip a woman and beat her severely), don't just leave it saying uh... this thing is none of your business.","So, when you see person, if na your eh eh dormot, if na your ehn ehn ehn ehn ehn side you see man dey beat women (sometime, de no dey even dey care wheder na outside, de go even naked di woman, beat am well, well), no just leave am say eh di thing no be your own business." It is!,Na your own. It's everyone's business!,Na everybody business. "Because some people will just want to say ""please, I don't wanna interfere in this matter"".","Because some people go dey go just want say I beg, make I no put mouth inside di matter." "If that man kills that woman in that place, don't you know that God will... will... will deal with you?","If dat man kill dat woman for dat place, you no know sey God go, go, go handle you?" "God will deal will you, God will punish you because you were there and you did not stop it.","God go handle you, God go punish you because you dey dere, you no stop di thing." "If you can stop the man, stop him!","If you fit stop di man, stop am!" "And if it means reporting to where he needs to be reported, take him to the police!","And if na to go report am to where de suppose to report am, pick am, go police!" Go and report him to the police!,Go report to police! "Because that thing is not good, it's not good.","Because dat thing, no good, e no good." That's why I even like foreign countries.,Dat'S why I even like di Oyinbo country sef. "In some foreign countries, they don't allow anyone to touch uh... anyone.","Some Oyinbo country, de no dey allow make person dey touch eh anybody." "If it is touching a child; if it is touching a uh... uh... uh... uh... wife, you are not su-, you don't... you cannot... you can't try it now, you can't try it, you can't do it.","If na to touch eh pikin, if na to touch ehn ehn ehn ehn ehn wife, you no su-... you no, you no fit, you no fit try am now, you no fit try am, you no fit do am." "Please, when you see a wife, a wife, women, when any man beats you, go and report him to the police.","Abeg, when una see wife, wife, women, when any man beat you, go report to police." "This, go and report it!","Dis one, make una go report." Report!,Report! "Whether it is your husband, he's not supposed to do that to you.","Wheder na your husband, e no suppose to do dat one to you." Thank you!,Thank you o. That's what I wanted to tell you.,Na wetin I just wan tell una. Okay.,Okay. "Good, it's good.",Toh na well. Let me talk as a m-... about my life as a mother now as uh... motherhood.,"Make I talk as m-... about my life as moder now, as eh motherhood now." I just gave birth uh... like seven months ago.,I just born now eh like seven months. "Kai, when I was pregnant, it was not easy at all.","Kai when I dey pregnant, e no dey easy o." "Pregnant woman go through some tough times, man!",Pregnant woman dey hear am chai! "If I don't throw up today, if I don't get dizzy...","If I no vomit today, if my eyes no dey turn me..."